Prophecy 60
Hide Yoursef MY Children,

For Just A Little While Longer!

August 31, 2002
Given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu).

 

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva],make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth.Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA,your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH,your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago.Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Oh how many times I don regret say I create human being. Yes, I know wetin go happen. That na becos I know everything. I am omnipresent.(I dey every where at d same time) I am omniscient.(I be all powerful) That no make am dey easy. Ohhhh, how many times wey I repent say I create human being. I look upon dis world wey be MY footstool. I look into di hearts and di souls of every creature on earth. I look into di secret places of their hearts. I see di evil wey dey inside, even those wey fill di churches, even those wey fill di temples.

And I look upon their hearts. And Ohhh, how many dey so far from ME. How many jus only get di knowledge of YAHUSHUA ha MASHIACH, but their hearts dey far from HIM. How many jus only know di story of di crucifixion, and how few don crucify their own flesh. How few don take up their cross and follow after MY Son YAHUSHUA. Again and again I send MY Apostles and Prophets to warn. Oh you hardened generation. You cover your ears. Your ears dey full of wax; your hearts don turn cold. You cover your eyes. And then you dare cover your mouth so you no go even warn anyone.

Judgment don come, away with your hypocritical prayers and praise. How few of una don bow your knee to ME to repent for dis, for di sins, di sins of di countries wey you dey in. I dey speak to di world, no be jus to America, but to di far corners and di whole remote places of dis earth. Sin no be respecter of a person. Di sin dey for all di nations, from di smallest country, provinces, cities and towns. Some dey so small dem no even get names and yet di sin remain di same.

Murdered little innocent baby I be di one wey dey hear di silent cries of MY Babies, those wey never get di chance to breathe their first breath. You no jus kill dem, you murderous butchers, you torture dem. I go put sinkholes under di abortion clinics. Di crack under di ground don already dey there. E dey invisible to di eye, but in MY timing e go be like say a giant hand reaches up from di earth and truly, as MY servant don talk am, all of dem will be pull down into di very belly of hell and di earth go cover dem over and all di wicked shall be inside dem. Your buildings wey dey promote di evil life-style wey you know say I hate. You wan know wetin I dey talk. Then read MY Scriptures. I go do di same thing for you.

Di earthquake fault lines don already dey there, but no think say when dis happens to a particular place that any of di wicked go escape for dey shall go down, and e go be ME, di Great God “I AM” dey trample dem underground. But di righteous ones wey dey stand forth in MY Name, di ones wey no dey ashamed of di NameS of YAHUVEH and YAHUSHUA, di ones wey dey honor MY Sabbath days and keep dem holy, di ones wey know say to love ME na to obey ME, di ones wey love MY Scriptures and hide di word in their heart. Dis ones na di ones wey don build their homes on di solid rock and dem no go sink deep into di sand. Becos I dey shake dis world in MY rage, and in di days wey dey come, you go see earthquakes di kind wey never happen before, becos dem go shake very greatly  as a parent wey don loose their temper take dey shake that child. Dis na how I go shake dis earth and say, “Wake up, wake up, wake up!”

How long, how long, how long must you try di patience of di Creator? How long must you try di patience of di Redeemer? I go stomp MY foot on di ground and everything that can shake go shake; everything that can be uprooted will be uprooted. I go shake up your politicians and I no care which country you dey, you no go no longer look to a government to provide. MY Children go know say there is but One provider. Na di same One wey pour water from a rock, wey put manna on di ground. Na di same One wey say I go supply all of your needs according to MY riches in Glory [Phil. 4:19]. And I no get any lack in Glory. In MY fury I go breathe upon not only di United States but for different parts of di world MY hot breathe. Temperatures rise as MY temper rise. Long period of no rain come as dem refuse MY Living Water.

Did anyone listen? Did anyone wonder why? I stand by and I watch human being inhumanity to another human being. Know dis MY Children; you no go go thru di Great Tribulation, those wey go fit trust ME. But dis no mean say you no go taste di tribulation of human being, human being inhumanity to another human being. Human being wey dey power hungry and greedy and evil to di core, wey want to wipe righteousness commot from di face of di earth, wey wan to wipe MY Son YAHUSHUA Name commot from di face of di earth.

Since di beginning of time there has been a war and na satan dey war against every person wey dey Holy. His time dey come. But until that time, all human will be tried. You already have been tested. How many of una don go in a fiery furnace in many different ways and before di cloud of witnesses you still keep your love and faith. As di evil dey grow more evil and di women dey breed with demons and di soulless ones dey come out full of evil. You no go even begin to fit to understand, becos dem no go get any conscience, no mind to know wetin dey right or wrong, no love for anything or anyone. Una dey call dis a clone, but no be clone, becos a clone go have to be a copy of ME and you no go fit copy ME, becos you are not a Creator. Na satan wey be di imitator thru all dis clones.

You think say when you eat cloned meats, you dey nourishing your body, but how can that be when life no dey for that meat? You dey eat damnation to your own bodies. I prophesy thru dis woman servant say dem go ration water years ago and now you see am don come to pass for places wey dem no ration am before. Temperatures dey increase in countries wey e never happen before. Di earth is shaking in places wey e never shake before.
I’M Angry, but no be at those wey can hear MY voice. I’M Angry at those wey refuse to hear. For hell was not created for a human. Not even di Lake of Fire was created for a human. I sent a redeemer, MY own Son, to keep you out of dis places. I give MY Son, for I love you so much. I redeem wetin di first Adam don do and yet how many of una still dey go towards Hell! How many of una dey fear to witness to your family? How many of una dey live in houses with unequally yoked husband or wife wey hate MY very Name? With a husband or wife wey hate everything wey dey Holy? And yet dem say, “I dey do dis for YAHUVEH and YAHUSHUA Name.”

You no dey honor ME. In fact you dey dishonor ME. For Jacob I loved and Esau I hated. Ohhh, how I want to shout dis, should I not hate those wey hate and despise everything wey dey holy? Should I not hate those wey blaspheme MY RUACH ha KODESH? Which kain fellowship  YAHUSHUA get with liars, with Beelzebub? Which kain fellowship can lightness have with darkness, yet you dey insist in staying in dis ungodly marriages wey no be marriage for MY eyes. Na  bondage wey I hate, Becos I no join dem together and yet you think say you don do ME a favor and all you do na grieve MY soul. As di children dey grow in heathen homes, and I don tell you a house divided cannot stand and di husband or wife cry out to ME, “Deliver ME!” Oh, if dem only for listen all along. If only dem for realize say I divided long ago.

So now MY Children, get ready. I remind you, you are your brother’s keeper. For those of una wey show care when you see your brother or sister go in lack, jus remember that I don take notes and someone will be raised up when you dey in lack. For those of una wey close your eyes and ears to a brother or a sister cry, jus remember dis, your very cries, one day and your prayers I go hate. You have been tested, and I know those wey don pass di test. Ohhhh, but how I grieve for those of una wey claim say dem belong to ME when I tested your love and compassion. And I use dis ministry time and time again as well as others to test una and yet you were found lacking, greedy and selfish, wey only care for your own needs. And now you go find out wetin happen when you pray and Heaven no go listen to you when you beg.

Get ready MY Children but do not be afraid. put your ears down MY Children to every word wey I say. Discern di spirits wey dey speak, becos many false prophets don rise and assure you of false words of prosperity wey go come to a nation, a country or a state wey hate and throw out, from di schools, di government, to di laws, everything wey I don proclaimed as Holy. You go see dis nation, dis country, di cities, di states, di provinces, no matter where dem dey on di face of dis world, come under MY judgment, and come under MY decrees. Vengeance is MINE, I will repay.

MY Babies, Bride, Chosen Ones and Elect, go and hide yoursef in your houses. Go and lock your doors. For di time dey come MY Children when you go have to hide for a little while. You don already anoint your homes. Stand and believe on Psalm 91 that you are protected under MY wings, as di evil ones continue inhumanity to man, as they continue to pass di laws wey go make am hard for MY Children to stand. Hide yoursef MY Children, under di shelter of MY wings. Na your prayers MY Children, MY ear go hear. Na MY hand MY Children wey go wipe away your every tears. But for a little while MY Children, jus a little while longer.

I know di names of every one wey dey weep and wail as dem [cry], “Come, YAHUSHUA, come!” But no do am out of fear MY Children. Do am out of love, becos I still dey separate and I still  dey divide di sheep from di goats worldwide. And di goats go go to everlasting fire and MY sheep I go continue to shepherd. Yes MY Children, hold on tight to di hem of YAHUSHUA garment and no let go as you stand in di fiery furnaces. Remember, I am with you always even unto di ends of di earth. Remember, MY Children, even those of una wey go die for MY Son’s name sake, dem can only kill di body, dem no go fit kill di soul. And you go be with ME in Heaven in your eternal home. And when you hear di words, “World War III,” you go see di greatest level of iniquity.

Pray for Israel, do not forsake Israel. For I love Israel so much. I sent MY Son YAHUSHUA there. HIS Blood was poured into di ground. Make you no give up on Israel, becos I do have a remnant there.

Hide yoursef MY Children. Yes, even hide yourself from di Great God “I AM’s” wrath. Becos although I no dey angry at you, you go hear ME shout, you go hear ME stomp, you go see ME shake, where even di very earth go be in fear and quake. You go see di flood of MY tears and you don already begin for when di floods come, that na MY tears.

Ohhhh, how many times I don regret that I create man and yes, woman. But you forget say I know di beginning from di end, and everything shall be redeemed. Everything shall be restored. E go once again go back to di time of Adam and everything that was lost, I go redeem. It was finished at di Cross. But make you no think say a battle must not be waged. But no do am in your name, do am in di Name of YAHUSHUA, for di battle belong to di Lord. And MY Children remember dis, you may lose some battles, you certainly have di wounds, but in MY Name and in MY Son’s Name YAHUSHUA your MESSIAH, you go win dis endtime war.

As YAH take speak am, na so dem take write am under di anointing of di RUACH ha KODESH for di Praise, Honor and Glory of YAHUVEH and YAHUSHUA. I write di words as I hear am interpreted while speaking in that Heavenly language.

Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu), 8/31/02, 8:00 p.m.

* * * * * * *