Prophecy 51


THE CLARION CALL OF DI 144,000,
MAKE UNA NO FEAR MY BELOVED LITTLE ONES,
“I AM” DEY RAISE UP A STANDARD AGAINST DI EVIL ONES!

Listen To DIS Prophecy As YAH TAKE SPEAK AM THRU
Elisabeth (Elisheva)

Given to Rev. Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)
November 2, 2001

 

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva],make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth.Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA,your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH,your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago.Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

In di awe of YAHUVEH and YAHUSHUA, I deliver dis prophetic word under di RUACH anointing. I ask now if anything no line up with di Holy Scriptures please let me know. I dey test every spirit wey dey speak especially in a prophetic message. Because so many people dey e-mail me  wey dey full of fear, I pray for a word of encouragement, even for myself. As I dey e-mail back another sister wey herself na prophet wey need encouragement, when I no even expect nain dis prophetic message take come forth. I pray say dis word go be a blessing to you and help you when fearful news comes our way. I know say e go come my way. Na very fearful thing to be di mouth for YAHUVEH to speak and I pray say every word dey as HE wan take talk am.

Feel free to copy and send dis word to encourage others at a time wey fear dey for all time high level.

Psalm 2
Why dis heathens dey rage and di people dey imagine a hopless thing? Di Kings of di earth dey set demsef, and di  rulers dey hold meeting together, against YAHUVEH, and against HIS anointed, dem dey say, make we break their bands asunder, and cast away their cords from us. HIm wey sidown for di heavens go laugh: YAHUVEH go put dem in ridicule. Then HE go speak unto dem in HIS wrath, HE go distress dem in HIS hot displeasure. Yet have I don set my king up for my holy hill of Zion. I go declare di decree: YAHUVEH don say unto me, Thou art my Son; dis day have I begotten thee. Ask me anything, and I go give thee di heathen for your inheritance, and di uttermost parts of di earth for thy possession. You go break dem with a rod of iron; You go slam dem in pieces like clay vessel. Be wise now therefore, O ye kings: be instructed, ye judges of di earth. Serve YAHUVEH with fear, and rejoice with trembling. Kiss di Son, or else HE become angry, and una perish from di way, when HIS wrath jus kindle for a little. Blessed be all people wey put their trust in him.

* * * * * * *

THE CLARION CALL OF THE 144,000,
MAKE UNA NO FEAR MY BELOVED LITTLE ONES,
“I AM” DEY RAISE UP A STANDARD AGAINST DI EVIL ONES!

 

When di enemy comes in like a flood, I go raise up a standard against am. Because you never  yet see am, no fear say I don forget MY promise to do dis. MY beloved no fear, again I, YAHUVEH, say no fear MY beloved little ones. I  no raise you up for dis hour and give you di knowledge wey I, YAHUVEH, don give you to come forsake you now. You be one of MY anointed hidden ones. Now na di time to arise and come forth to help your brothers and sisters in YAHUSHUA. I don give you lands, properties, ships, islands, houses and finances. I get secret millionaires; yes, even multi-millionaires and una never do much for MY Kingdom becos una don stay in di world’s eyes and yet try to walk MY fine line. You don love and serve ME in secret, becos you say to yoursef, “Wetin I go fit do for di Kingdom of YAHUVEH? How  I go fit promote di Gospel of YAHUSHUA?” So you stay quiet and hide, yet dey pray for someone else to do wetin you feel say you no fit do. Soon, e go be too late to help MY Apostles and Prophets. Do you not yet understand say di price even di person wey I dey speak thru must pay, di attacks dat must be blocked off, no be only for di physical realm, but di spiritual realm? You dey help or you be hindrance?

I, YAHUVEH, dey pour many gifts into you. MY hidden ones get much Godly wisdom. No be only in dis world but also in di RUACH ha KODESH spiritual realm I don bless you. You don work alongside di world and yet you dey stay hidden. Many of una na genius. I hide una as doctors, lawyers, teachers, philanthropists, bankers, inventors, investors, artists, computer intellects, electricians, in di police force, all form of governments, senators, congressmen, statesmen, sales, owner of stores, franchises, real estate, captains, owners of ships, restaurants, all types of transportation, actors, movie industries, singers, investors, brokers, writers, chefs, designers, contractors, there is no career wey I no get MY beloved children hidden in. Dis na MY disciples wey dey follow MY Son YAHUSHUA, and desire to obey YAHUVEH’s laws and dis hidden ones dey spread all over di world. Di standard wey dem take dey use to measure man laws na dis: E dey line up with di Scriptures? Dis na di standard wey dem take dey measure everything by; if na truth di Torah and di Scriptures go confirm am.

I, YAHUVEH, don hide you for such a time as dis. Pray how to use your talents, gifts, wisdom, homes, real estate, finances, and spiritual gifts. All wisdom wey no go against MY Scriptures you are to use am to help and exchange with, at a time when there will be no other way to buy or sell or help others. Your wisdom, revelations, healing knowledge, and di education wey I don give to you go benefit others for such a time, and you go know when to use am, and where to help, and who to help. MY Apostles and Prophets need you to hide dem for such a time as dis, from di evil ones wey dey seek their destruction, so no one go fit say dey were not warned before judgment fall down.

I, YAHUVEH, always dey send di prophets and apostles to speak, no be only to repent, but also to warn of di dangers wey dey come and how to escape di enemy trap. MY hidden ones are to be bold when you share your hidden knowledge and revelations, wey I, YAHUVEH, dey give you daily. I advice you, no rely for your own strength, but rely on YAHUSHUA strength, for e dey sufficient enough for you no matter wetin you dey face. Anything too hard for YAHUVEH to conquer? You face wetin you see as impossible wall wey you  no go fit climb or go around. With MY RUACH ha KODESH anointing, you no go fail. I, YAHUVEH, dey break down di walls wey dey keep you for bondage in di prisons where you have been set apart from others.

I, YAHUVEH, dey join you now with others, for dis ones also go be MY hidden ones wey I don hide under di shelter of MY wings. Wait until you see di miracles wey I, YAHUVEH, go do. You go see, e go be your finest hours as once again you see YAHUVEH deliver those wey others dey seek to destroy, all because of MY Name. I, YAHUVEH, don choose dis prophet to call forth di Clarion Call of di 144,000. Learn di Song of Moses. Inside that song is di victory in di Name of YAHUVEH! MY new command to dis apostle daughter of MINE na: now is di time for you to seek YAHUVEH face and YAHUVEH will and YAHUVEH’s marching orders. Walk when YAHUVEH say walk, run when YAHUVEH say run, speak when YAHUVEH say speak and no do anything when you are told to just stand and wait. No matter how small di decision be, learn to pray for ME to reveal MY will, not your will.

I, YAHUVEH, dey anoint MY chosen ones in a greater way than I ever do before. Study and show thyself approved, so that no one go fit misguide you with di Scriptures. I, YAHUVEH, dey assemble MY troops on di wall to defeat satan, and di demons wey dey surround you. Di weapons wey you get no be carnal, but spiritual. No weapon go fit match di unusual anointings wey I don put inside each of una, though say you know no am. In MY timing you go see di standard wey I, YAHUVEH, go raise up against those wey dey seek to harm di Christians and di Jews. All Israelites go call upon di Name of YAHUVEH, those wey no dey fear to use di Sacred Names, dem realize say that they have been deceived, and don learn wrongly. There is anointing, saving, delivering, and healing power, in di Names of YAHUVEH and YAHUSHUA.

I, YAHUVEH, ask you dis, will you forsake di promises wey I don give you? Di Blessed Hope wey I don give you? Why I go say you no dey under MY wrath, but mercy and you dey teach others say I, YAHUVEH, no go allow any escape for di Christians wey dey call out to ME in YAHUSHUA Name? I, YAHUVEH, do have an ark for you. All MY Children wey trust ME, go hear MY voice clearly, just believe, and keep asking ME. Do you think say I, YAHUVEH, don bring you dis far to fail you now? I, YAHUVEH, no go spare Israel because her people dey more holy. In truth her sin dey many like others, di smell wey dey rise to Heaven as e be for di nations around di world! Not one nation or people dey better than di other. I, YAHUVEH, no go allow Israel to be destroyed completely becos I, YAHUVEH, don make a covenant with Abraham and his seed.

MY Children wey dey grafted in by di Blood of MY Son YAHUSHUA, make una no fear. I, YAHUVEH, go honor di Blood Covenant wey I get with una too. Thru di spiritual bloodline of YAHUSHUA, una be Jews too. Those wey refuse YAHUSHUA’s Blood Covenant and say na becos dem be Jews, those wey reject YAHUSHUA as MY Son and your MESSIAH, be warned. Since you don refuse MY gift wey I, YAHUVEH, give you at Calvary, then those who only believe and get di faith say by keeping di Torah, di Sabbath and di feasts go save dem; I, YAHUVEH, remind you say without a sacrifice for sin, when you sin there is no holy sinless offering and you will be judged no be by YAHUSHUA, but by Moses and di laws of Moses. Woe be unto una when dis go happen.

There is no grace or mercy when Moses go judge at di Day of Judgment. If to say e was that easy do you think say I for  send MY beloved Son YAHUSHUA to suffer and die for your place? Everybody have sinned and fall short of a perfect Creator. How much better for MY Children wey know say dem be sinners and yet dey do di best dem fit do to obey and repent, asking forgiveness in YAHUSHUA’s Name and know say YAHUSHUA na their Blood Covenant wey also was di sacrifice for their sins. YAHUSHUA go judge those wey don accept him as that, no be di law of Moses, or Moses. YAHUSHUA go judge di heathen wey refuse to live Holy lives before ME and refuse di only Holy sinless blood atonement for sins.

Abi I dey unable to deliver and protect you? Di plans wey I, YAHUVEH, have for you na for good and no be for evil. Trust ME and stop to depend on dey wey you take understand things. MY Children dey acknowledge say na ME, YAHUVEH, alone get di answers and I, YAHUVEH, promise to direct your paths as you waka for MY footsteps. If your own footsteps walk alone e go lead you astray, but MY footsteps na sure solid steps wey dey lead to victory. Believe and receive victory. Fight for wetin you know to be right. There are people that you have been dealing with wey I dey remove from your life to bring others to encourage and help support you in all ways.

Make you no say that there is not yet time to do dis or that. Instead realize say no be me be di FATHER of all time? Di keeper of time ME, YAHUVEH, na time itself. Who else go fit stop time, speed am up, or back am up? Beloved child and all children of MINE wey dey call YAHUSHUA by Name and know say dem no go fit do nothing without that Sacred Name, I don raise you up for such a time like this. You be part of MY hidden anointed ones. Although di enemy go grind their teeth trying to harm you and dem write your name down, I also don write their name down in di Book of Damnation and all dis evil ones shall spend eternity in di Lake of Fire, reaping for wetin dem dey sow now!

I go prove to MY Children once again, if you listen to MY voice and walk in MY footsteps, you go outsmart di enemies wey dey seek to destroy you and all MY Children wey dey seek to hear MY every word and wey dey obey ME, or at least dey strive to and know say when dem sin dem have YAHUSHUA’s Blood for di remission of sins. I your FATHER, YAHUVEH, go confound dem with di evil ones own technology. I go confound dem with their own inventions. For no earthly or scientific reason, di traps wey dem set for MY children go instead only entrap and boomerang back upon di evil ones wey dey seek di destruction of di followers of YAHUSHUA. Wetin I do once before with di evil pharaoh I go do am again. By YAHUVEH’s hand alone di Goliaths of dis world go forever fall.

Di ones wey I call evil secret keepers, wey dey seek to use di secrets of di occult, demonism, scientific, political knowledge, and manmade laws to destroy MY Children, and take di freedoms wey I don give to MY Children away. I, YAHUVEH, go have a surprise in store for dem; e go confound dis evil ones wey think say dem dey wise. Dem dey seek to harm MY Children. I, YAHUVEH, and MY Son YAHUSHUA, vow to protect those wey dey called forth, and anointed for dis hour.

Those wey dey seek to hear MY voice clearer than any other voice, dis ones na MY true treasures on earth. All wey dey call out to YAHUVEH and YAHUSHUA, and rely on MY RUACH ha KODESH to guide dem thru a most unusual anointing not like anything wey dem don see before, must realize say I dey  prune dem now, and dey remove everything in their lives that must be removed. Yes, even your loved ones must be pruned, or removed by YAHUVEH’s hand, for I must protect MY beloved ones. If dem no be help to you, and instead dem be hindrance, then know say I go remove dem, becos dem go betray you even unto death if YAHUVEH  no divide wetin was never supposed to be joined as one.

Pray and intercede for di people wey you love, but when I tell you to move, and yet I no tell you to carry your unsaved loved ones follow body, e go be a test of your love for YAHUVEH. Will you forsake all for ME, like when Lot was told to flee? He no get any choice but to divide from his wife; I turn her into a pillar of salt. I had to show him and his daughters di hard way. I demand obedience, especially when I send an angel to warn say “Get out, flee, dis place is about to be destroyed.” Lot wife flee too, but she turn her head to look back come feel bad for all her possessions, home, and friends wey dey di city. Dis na a lesson; when I tell you to flee, no matter what, obey or di situation of Lot wife go happen even to MY children.

Trust ME and know say di plans wey I have for you na for good and no be for evil. I laugh as I hear di plans of di enemies wey dem dey say all Christians and Jews go die. Do not dis enemies yet understand  say even though dem try hard to exterminate MY People just like di Roman Empire and Hitler take do, di more dem sacrifice di more was raised up? Di blood of di saints wey dem dey sacrifice go only bring more saints to di Kingdom of Heaven. Sauls go become Pauls. Di enemies are so foolish. Dem no think say Heaven itself go rail against dis demonic enemies and di skies demsef go pour forth MY wrath upon MY enemies wey dey look for how to use machine wey dey play God? I dey even now dey confound di enemies in ways you no know. Beware oh enemies of MINE, becos I go turn your own creations against you and your loved ones. MY Children will be safe.

How many times already no be only for America but Israel, I don spare dis nations for dis last month alone. But yes not only that, but I say even di world for don destroy itself, as one nation dey play deadly war games against another nation, and for wetin, revenge, greed, power, hungry for more control and power. Na ME, YAHUVEH, alone dey promote and dispose. When MY People cry in MY Son YAHUSHUA Name and cry out for mercy for di nation wey dem dey live in as well as those wey no dey live there. How can I deafen MY ears, even if I wanted to? You dey read dis now becos I don extend time for one reason, for di sake of di intercessory prayers wey don go forth covering dis world in MY Son YAHUSHUA’s Name. Your ark of safety so far na di fervent prayers of di righteous.

I be YAHUVEH and no other like ME. Di standard wey I raise against di evil ones wey dey use their weapons to manipulate di brains of MY Children go find out say no be only their weapons go malfunction, but instead I go turn every invention, every machine, every weapon, every disease, all biological weapons and all germ warfare against demsef. Even their own loved ones go be ashame of dem and di evil their own bodi go refuse to live out their years. Dis na MY revenge against those wey dey seek di destruction of YAHUVEH’s believers and followers of YAHUSHUA. I love you. Yes, even those wey hate YAHUVEH. I alone  nain created you and e go be YAHUVEH hand alone send from Heaven go destroy both your body and your soul, sending it into di Lake of Fire if you no repent in prayer, ask for forgiveness in YAHUSHUA Name.

Leave America alone. Leave Israel alone. Leave MY Children di freedom to worship and serve ME in truth and anointed power. I set America apart to be di land of di free and bless her so that no war don come near to her land since all di years wey don pass. America, make you no so freely give away wetin I don bless you with just becos of fear. Speak up and no remain di silent majority anymore. Make dem hear una voices. Remember say when a person loss di freedom of religion and even if dem dey censor di false religion; then all dey for di danger of losing their freedom of religion. MY Children know say dis no be about say dem dey take away religion; dis na about a relationship with YAHUVEH and YAHUSHUA wey dey change to a form of religion with a form of godliness, but no get godliness inside.

Beware enemies of YAHUVEH and YAHUSHUA; your very weapons wey una aim to destroy many people go come back upon una. You wey send am out one way and di angels in heaven go turn am another way. I go protect MY children as a mother lion take dey protect her cubs. Beware enemies of YAHUVEH and YAHUSHUA, becos you see, I dey hear MY Children cry out in fear and wonder, becos I no teach dem to be warlovers but to be peacemakers and dis dey make dem wonder at di level of wickedness wey another human being  dey do to fellow men, women, boys and girls. I dey hear MY children cries of fear, becos dem realize for di natural realm say dem no go protect demsef. Now you see why I call dem MY Sheep and Lambs. Which kain lamb or sheep go protect demsef? Does a lamb or a sheep get sharp finger, or sharp teeth, like I don give to other animals? No! A sheep dey only depend on di Good Shepherd to lead dem to green pastures and clear water. MY true Sheep and Lambs  no get shortage of manna, or Living Water. MY true sheep trust ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA as di Good Shepherd. MY Name na YAHUVEH. MY sheep go come only to di voice of “I AM,” and MY beloved Son YAHUSHUA, and go only hear our still small voice by di RUACH ha KODESH. (Holy Spirit)

I be that Good Shepherd! I go protect MY Sheep and Lambs from di wolves of dis world. Na true say, some of MY sheep are killed by di wolves, and some go suffer great persecution; but dis has always been like that. Dem no dey see their rewards on dis earth but in Heaven for eternity. I laugh when I hear how di enemies think say ME, YAHUVEH, dey blind, or deaf and mute wey no dey fit talk, and  no go repeat wetin I  hear to MY Apostles and Prophets. I warn MY children by speaking to their spirits. Is MY arm too short to deliver you MY children? You believe say I am your Creator, YAHUVEH wey created all for Heaven and Earth? Abi no be YAHUVEH be di one wey create your eyes and ears?  You think say now say MY eye no dey see well, or say MY ears  dey deaf, not to hear your prayers, and cries, and dey see, and hear wetin di enemies dey do? Do you think MY children say I no go raise up, and I don already raise up a standard against di evil ones? Dem get their remote wey dem take dey watch, but I get MY angels wey dey stand guard 24 hours a day, dey watch and report, everything wey di evil ones dey do!

Some dey even use MY Son YAHUSHUA Name dey try and deceive MY Children; dey sneak into di place wey MY Sheep and Lambs dey,  dem dey believe say nobody notice, and yet I see their hearts. I know wetin dem send dem to come  do. I know a wolf when I see one. I see satan as he dey come as a roaring lion, dey look for di person wey he go destroy.

MY Children you can be deceived for a little while, but only as long as I allow am! Woe be unto that wolf wey wear for face di mask of a sheep to spy on MY Children and trap dem. Wetin be di price of your soul? Becos na that be wetin e go cost una. Your soul will be cast into di Lake of Fire. Repent today before it is too late! Run from di evil wey you done do, and expose that evil for wetin him be. Help MY Children. Become one of MY hidden ones wey go protect and not harm MY babies, Bride, chosen ones, and elect. Repent to all those wey you don do wrong to. There is yet time for di wolves to become baby lambs. Only thru MY Son YAHUSHUA Blood covenant nain dis dey possible. Run, wolf, run, becos I, YAHUVEH, see you. You only dey think say you dey invisible and blend in.

I don watch di tares, and di wheat grow side by side, and now di time dey upon dis world where MY angels go very soon pluck out di tares, and burn dem where dem go burn for eternity, first for hell and then in di Lake of Fire. MY eyes dey always on guard, becos I jealously love, and protect MY Sheep and Lambs. Beware you wey dey unequally yoked, for your own spouses wey you marry are wolves wey dey in disguise. A marriage wey no dey ordained by YAHUVEH no go stand for dis evil days ahead, evil days for di evil ones. For again I don see di evil in di churches, and in di ministries where I don watch as di satanic plants dey grow in power, popularity, and dey teach doctrines of devils. With cunny, di wolves take creep in, and play di game of di pretenders, as pastors, apostles, prophets, and teachers, and yes even di evangelists. You can fool di people, but beware you no go fit fool YAHUVEH. You use di name of MY Son, YAHUSHUA, and you dey name ministries after yourself to glorify yourself, but you dey keep a evil secret.

That secret na, you haven’t given your sins, hearts, lives, and souls to YAHUSHUA. You instead dey use occult powers, and use MY Son Name to manipulate MY People, to build your towers, and mansions wey you dey call churches. I dey look at all dis multi-million dollar mansions wey you dey call churches, and I call dem mausoleums where dem dey bury dead bodies. MY RUACH ha KODESH no dey in dem. My true apostles and prophets wey dey warn you are insulted, abused, and chased away. Away with your pretend worship, I only dey listen to those wey come to me with clean hearts, away from ME with your pretend praise. Di most off key singers (wey no sabi sing) wey get hearts set to do MY will, and dey live their lives in holiness, dey put everything wey YAHUSHUA be before their own wants and desires and needs. Dis na di highest form of praise music in MY ears. No be your choreographed praise dancers.True dancing in di RUACH ha KODESH dem no go fit teach am, and no be wetin any person fit choreographed, but di RUACH ha KODESH. No be something wey you dey do just becos you wan dance before YAHUVEH and YAHUSHUA;  na your feet being anointed to do so. No one fit teach dis. I turn away when I see worldliness in di temples and di churches.

True apostles and prophets no be something wey ordinary teacher of dis world go fit teach. Even your so called prophetic schools na joke. How can you teach wetin you yoursef as human dem no teach you? Only di RUACH ha KODESH dey speak and flow from MY apostles, and prophets. Those wey dey dis kain schools better repent and realize say man cannot make a prophet, or an apostle, or even di office of an evangelist. Na di anointing of di RUACH dey draws di people. No be something wey dem dey learn, or teach. To be a good pastor, di example na di Good Shepherd. Pastors and Evangelists, stop trying to build your mansions here on earth. Stop storing your riches on earth. You tell MY people make dem no prepare for disasters, yet how many of una dey store up di best of everything? How many of una wey be wealthy pastors get your secret hideaway, and don make your plans not caring about your own congregations? Why do you think say I want di money given to you in tithes to take build you crystal cathedrals, or to build di biggest church in America or di world? Di money for no better be spent to help MY People to prepare for disasters? You get your own diamond mines and yet you dey throway di true gems, wey be MY beloved children.

In dis world you dey  fool dem, oh evil ones, but your days are numbered in dis world. Wetin you go do then? Di law firm wey supposed to defend MY People with money sent to dem to help defend those called MY children, now you dey fleece di flocks. Instead you dey help those wey dey seek to take di privacy away from MY Children. You have sold yoursef to di highest bidder, and him name na satan. I no dey buy MY People, nor their affections, loyalty, or trust. I no go barter with di evil ones. I go only warn dem. Repent in YAHUSHUA’s Name.

You false pastors, evangelists, apostles, prophets and teachers, you sicken I, YAHUVEH. Stop fleecing MY flocks. Children when you see a minister wey be a millionaire dey display their wealth for your face, why do you only give dem more, dey anger ME even more? When you see a pastor dey brag about his Rolex watch or Mercedes Benz, Rolls Royce, or other luxury car, or dey show off his mansion, you never yet see a wolf don creep in among you? Not just listen to his or her preaching, instead judge their fruit. Realize say if that na  really MY minister, he or she go give more than dem dey take. You dey attend church wey get people wey dey unemployed, on welfare or in lack? Then how you go put that money in di offering plate to feed di wealthy pastor, and to feed di spirit of worldliness, and greed? You no think say I go hold them as well as you accountable? Wealthy pastors wey get people wey dey lack in their churches while dem dey live in abundance dey feed demsef and starving MY sheep. Dis evil pastors dey fleecing MY flocks, taking all they have, and yet dey mock their nakedness. Pastors wey freely receive should freely give, and yet you go see apostles and prophets dey sell wetin I freely give dem thru di anointing of di RUACH ha KODESH.

One minister dey grieve me so, he been once was a symbol of YAHUSHUA love, and now he dey drip with diamonds, dey wear di most expensive tailor made suits, becos he get  men store. Yet wetin him dey give back to those wey no get tailor made clothes? Stop telling MY People that YAHUVEH tell you to build dis 10 million or 7 million dollar building. Bigger no always mean better. Who dey tend to di Sheep and Lambs when you get hundreds of thousands for your congregations? How can you even pretend to know your congregations with such numbers? No be di pastor job to know MY sheep? Most no even fit get a phone call to you or even a letter.

Most of MY Sheep and Lambs in di churches where dem dey run to dey only dey see di big beautiful buildings, di pastor whether na man or a woman dey stand afar off and is unreachable to di masses of di people. Who do they think they are? Did not MY Son, YAHUSHUA, take di time even to feed di masses of people and touch di people, healing, and delivering, praying, and blessing dem?

Shame on you pastors with such large numbers of sheep, and lambs; you no even know di names of di people wey dey support you! If and when you see their faces, or hear their names, you no even know dem. Dis people can’t even get your attention for an appointment. Di wealthy in di congregation dey get your attention quickly and anything dem need, even a house visit no too hard for di pastor and evangelist to enter in their schedules. Hypocrites, shame on those wey dey support such ministries and pastors.

Ask yoursef, whether one of di popular pastors of mega churches go deliver such a word as I dey use dis apostle to deliver to you? No they would not. Ask yoursef, dem go gree welcome dis apostle of MINE for your church to deliver MY  harsh words of judgment and serious warning for repentance? If di answer na No, and you dey support dem with your tithes and offerings then you dey in sin. Yes, does that shock you? When you help someone to continue to sin, then you be  partakers in that sin. Repent today!

No support a ministry simply becos e dey named after someone well known in dis world or get di biggest or more well known church. Wetin MY Word talk about if all men love you and love di things in di world, does dis make you MINE? Does all mankind love and receive YAHUSHUA? No! Becos when you speak in YAHUVEH’s name, like dis apostle take dey do, no be about a popularity contest. MY true apostles and prophets go lose in di eyes of di world; dem dey go in lack many times as satan dey lie to di people wey I don raise up to ease di financial, emotional and physical burdens. MY own children shut out MY voice wey dey tell dem to help, love, and support, di few brave, and bold ones wey I take dey use take dey serve ME and MY People.

Are you one of di ones wey dey hear YAHUVEH voice speaking forth and wey go love and desire to help and support MY true apostles and prophets; to open your house to dem, and to help ease di burden to reach MY People with di messages from heaven? MY true apostles and prophets dey pay di price for di anointing and dey used to grief, suffering, rejection, and persecution. Do you ever count di cost wey e dey take to deliver such a message as dis one? Why should you as long as e no be you that has to pay di cost abi? I know who dey read and hear dis, and I go one day ask you wetin you do to ease dis minister burdens. Did you even encourage her? Do you even lift her name up in prayer? Do you realize how few pastors go invite her to minister for their churches after dis prophetic message is given? But I, YAHUVEH, dey speak dis forth no be dis Womanservant. So I have dis against you so called pastors wey  no be pastor at all. E go be better to resign than face YAHUVEH’s wrath for harming MY Sheep and Lambs.

Shame on you pastors; Una no be pastor when MY Children can’t get your advice without first being a member of di church and pass your tithing tests. One test be: di member dey only recognized if dem give tithe in a certain dollar amount of donations and attend church a certain number of times. Stop fleecing MY flocks! Remember wetin a pastor supposed to stand for. Remember you no be di Good Shepherd. If I don ordain you to be a pastor, then you are to be a blessing to MY sheep. You supposed to be there as di physical part to encourage dem with MY words. Love and pray for dem, and their deliverance and praying for di salvation of their soul, teaching dem to obey MY Torah and MY commandments with you setting di example.

If you no get MY anointing then you no be an apostle, prophet, evangelist, teacher or pastor. I no dey impressed with which seminary you graduate from, more appropriately now a days make dem call am cemetery. Di letter killeth and di RUACH ha KODESH giveth life. If di knowledge wey you get na your own, and you dey relying on that knowledge to minister, then you no dey ministering in fullness under di gifts of di RUACH ha KODESH.

Away from ME you wey be pretenders, you wey don creep in among MY sheep, teach dem, fleeced dem, and yet you no be even MINE. You no belong in with di sheep and di lambs. You be a wolf wey dey seek to devour. You have been sent by di roaring lion wey no be MY Son YAHUSHUA. YAHUSHUA na di Lion of di Tribe of Judah.

* * * * * * *

Dey Offend some, others dey become enlightening for di love, obedience, glory of YAHUVEH and YAHUSHUA, 11/02/01, 1:50 a.m. Prophetic Handmaiden of YAHUVEH and YAHUSHUA.
Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu).

The Encarta World Dictionary defines a clarion call as a call to action: an urgent or inspiring appeal to people to do something. [From the use of the clarion as a signal in war] 


* * * * * * *