Prophecy 40
Make you no join di Fake Bride!
If you you  be one of dem…RUN!

Dis prophecy come thru Rev Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)
for September 17, 2000

(Please pray for dis Woman Servant Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu). Wey God don choose to take deliver dis harsh message wey go offend millions, but she be only di messenger. Abeg make una no stone di messenger, she only just repeats wetin di RUACH ha KODESH dey speak for one reason: to bring souls into di Kingdom of Heaven. Because of how dis prophetic message take long, we don divide am into part 1 and 2.)

* * * * * * *

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand. Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, nain dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, nain dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. ( Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
  —2 Chronicles 36:16

.”

* * * * * * *

Prophecy Begins

Prepare to go home. Go home. Your Homecoming dey wait. My Bride must  dey ready to go home. Tell MY Bride to prepare to go home. I dey prepare MY Bride to go home to rapture dem up by MY side as you still dey alive. Tell dem for everywhere; warn dem by land, by air, and by sea. Prepare to go home with ME. I dey come for MY Bride. Prepare to go home, to come to di marriage supper of di Lamb. I no go fit wait for MY Bride to come home to Heaven becos I don wait for so long. Tell dem say I dey come for MY Bride. I dey come, tell dem for everywhere. No let anything stop you. Troway your pride, give di message, and tell MY Bride to get ready to prepare to go home.

Which kain Bride no know when di wedding day don dey near. Which Bride no know when to wear her wedding gown. Soak yoursef, clean yoursef, wash yoursef, and soak yoursef in MY Blood shed for you at Calvary. Prepare to go home. Which kain Bride no want  make her odor to be perfumed like a sweet smell of di beautiful flowers and spices? MY Bride odor  no be man made you no go fit find am for bottle. MY Bride beautiful odor come from heaven. Na di anointing of di RUACH ha KODESH nain perfume you. No be man made. You no go fit find am for bottle, MY RUACH ha KODESH anointing nain perfume you. Those wey no get di anointing na bad odor  to MY nose and no go dey home to Heaven with ME. Di Sweet smell of MY anointing dey Holy.

There are some wey call demsef MY Bride, but dem no be MY Bride. Dem be di Church of di Pretenders wey dey claim to know ME and yet dem no know ME. Their scent na imitation and e dey smell to MY nose. Di fake bride dey wear off white. Her jewels na just cut glass. Her tiara dem make am with tin. She claim to love ME, and no love dey there. Why be say dis fake bride say dem love ME but no gree obey? Dem say dem dey do miracles in MY Name, but their strange fire dey bring ME shame.

Dem be di five foolish virgins wey dey with no oil for their lamps. Dem no trim their lamp tread. Dem dey slice and dem dey cut MY Word, even MY Commandments to transform am into their own image for who “I AM” be. Dem dey condone sin even though say I call am sin. Dem even go so far to call demsef a god. Dem rewrite MY Commandments. Dem rewrite di Word of “I AM.” Their spiritual leader dey even sit down on a throne. He dey give command for he own name. He dey mock MY rod of iron dey call am scepter. He dey mock MY robe of righteousness himself dey wear a robe wey dem use di finest jewels take make.

He dey mock MY train wey fill di Temple and his robe get long train too. He even dey mock MY Word Holy and dey make MY People to call am his holiness. He, dis spiritual leader dem know am for all over di world .There are other spiritual leaders for other church organizations wey dey  worship ordinary man born from a woman wey no be of a virgin birth. Di fake spiritual leaders dey force di people to bow at their feet, dey mock MY Word wey say every knee shall bow, and every tongue go confess say YAHUSHUA ha MASHIACH na LORD.

Another spiritual leader dey plan to add another  person to di Godhead. Dis spiritual leader dey give MY communion and no ever want to tell di people to repent for their sins. Na all for show. Those wey dey follow after dis spiritual leader go follow am right into di pit of hell and into di Lake of Fire. Nothing wey  dey holy about dis unholy person becos he dey desire to take MY place. Dis na part of di fake bride wey be bad odor to MY nose. Dis spiritual leader  no go ever go so low for he own eyes or in di eyes of other people to wash another person feet. Dis church organization na di richest in di world, but dem be di poorest for faith. Dis one dey lead so many astray he even dey make  dem confess their sins to him.

Dis one dares to mock di only one wey get di right to be di judge of all human being, and yet di priests learn say dem get di right to forgive sin. Dem dey judge di people sins and di priests go give di punishment. No one wey dey do dis be part of MY Bride. Dem be bad odor to MY nose. Even di type of transportation dem use to mock di way wey I ride on a donkey. Dem even dey mock di sign of di cross. Dis na just a part of di fake bride. Dem dey speak in a language only for scholars language wey  no body fit speak. Be warned, run if you don join di fake bride. Becos na bad smell to MY nose. Remember I am di Lord THY God and thou shall have no other Gods before ME. No let dem deceive you I no dey easy to use take joke. There is a price to pay.

* * * * * * *

YAH speak and write dis Prophecy under di anointing of di RUACH ha KODESH give am to di humble Woman Servant Elisabeth Sherrie Elijah [Elisheva Eliyahu]

By 6:15 pm September 17, 2000.

Part 2 – Prophecy 41 – Will The Real Bride Please Stand Up!

* * * * * * *