Prophecy 28
Are You One of My Hidden Ones?

Dis prophecy come thru Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu) on
January 25, 1999

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva],make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth.Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA,your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH,your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago.Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Di weapons wey you take dey fight warfare no be weapon of di flesh but dem be mighty weapon in pulling down di strongholds of satan. A laptop computer go be one of those weapons to use to expose di enemy, use am to warn of di enemy, use am to take stop di enemy from destroying MY People for lack of knowledge. Tell MY People to invest in dis tool of today becos when dem are to flee dem no go fit travel with big computers. I create di computer for dis time and dis purpose. Dis na di knowledge wey go increase running back and forth. Dis na how you go dey able to dey for one place and yet for another place dey speak to MY People all over di world. Make you no think for a moment say that dis weapon no dey powerful. Satan dey find how to control di internet, to silence MY People. But he no go fit do anything wey I no allow.

Your time dey short but I go connect you with those wey get computer knowledge. A connection of MY People go be a loud voice for dis end time. I hide All MY computer genius  for a time like dis. I hide those wey get di wisdom of YAHUVEH and YAHUSHUA for a time like dis. Dem dey work in dis world to learn di ways of di heathen, to be able to be used against di heathen and their ways for di right time. I have MY People for all areas no matter where you have feared, from di police, to di military, to di IRS, to di government, to di supermarket, to di internet providers, look for MY People. You go find dem. Now na di time dem go arise and shine. Like di sun dem go shine forth.

Di knowledge wey dem don learn for schools provided by di enemy dem go use am against di enemy to protect those wey I call MINE. Dem go know ways around laws wey you think say dey impossible. I get lawyers, doctors; I get teachers for all areas. No think say na heathen get more wisdom. All of MY genius I don hide dem until a set time. All of MY genius have di wisdom of ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA and can learn anything quickly, even though say dem no think of learning dis thing before. Communication go be an important tool for dis end times.

There are Ways around wetin di world plan to do to take silence MY People. I no go reveal di ways now, but you go recognize dem when you hear dem. I dey tell you dis now dem fit build their towers of Babel; I go provide a way for MY Children to always keep in contact. Trust ME and learn MY ways, be aware say MY People I hide dem, dem  get secret gifts of di RUACH ha KODESH, dem dey by demsef without advice from one another, to take learn, and yet na di RUACH ha KODESH dey teach dem.

To travel go become increasingly difficult to move from one country to another without permission from that country. But I tell you I have MY People already wey dey work in dis areas and MY People go escape when di time come for dem to flee. I get planes, pilots, and stewardesses. I have MY plan in force. I am a God wey nothing fit surprise no matter wetin di enemy dey think. I have a plan and MY plan for you na for good no be for your evil. My plan for MY beloved Babies, Bride, Chosen Ones and Elect na for blessings, so many blessings you no go dey able to name dem all.

MY plans for MY enemies na for curses, so many dem no go fit able to name dem all! Get ready enemies, di curses are coming to you! Natural disasters nain dem go call dem, but there is nothing natural for di disasters wey come from di hand of an ANGRY YAHUVEH! You dey boast of your plenty but there shall be no plenty becos of MY great anger wey go fall down without mercy, but e no go harm MY People! I go protect MY People as I do in di time of Noah, as in di time of Lot, as in di time of Moses.

Di enemy go grind their teeth in anger and madness becos dem go see say nothing go fit stop or hinder those wey dey obey and trust in YAHUSHUA as their Good Shepherd. No wild animal go fit surprise MY sheep. I go before di wild animal even start and speak words to MY Prophets and apostles to warn ahead of where and when di wild animal go attack. You see di wild animal no be just ordinary beast with sharp teeth, dem be evil beast and when dem bite once, their bite dey deadly. So no be ordinary bite but your very soul and life dey on di line.

Di snakes wey dem send to surround you no be only one, but many, di snakes go try to surround you and their bite no be just snake bite but there are cobras wey go inject poison into your Spirit telling you say YAHUVEH and YAHUSHUA no go fit take care of their sheep, it is hopeless, dem go inject you with a lying poison saying,  make you “Trust di government not your God!” Then dem go use boa constrictor snakes to try to squeeze you everyway dem fit squeeze you. Financial, spiritual, physically, mentally, di government go squeeze you like a boa constrictor at di same time, dem go use di cobra to inject di deadly poison of lies to make even those wey dey strongest in faith to shake in fear.

But I dey speak forth out of dis Woman Servant now to tell you MY beloved say you no need to fear di wild animal or snakes! I don tell you say I always dey have a people wey dey worship, serve, and obey di Great God “I AM” and always will! ME, YAHUVEH, and MY Son YAHUSHUA dey quietly watch and checkout wetin di enemy dey do and we report am thru our prophets and dem in turn no dey only warn you but encourage you like now, to let you know say for MY timing I go tell you when to leave, wetin to do, how to avoid di boa constrictors, and di deadly cobras!

Make you just wait on ME, becos ME di Lord your God no dey ever dey too early or too late. I go rescue MY People in such a way wey you go find miraculous. Yes, there will be those wey dem go be and wey dem go kill but their blood go fall into di ground and only to raise up others to speak out and do greater works in MY Son YAHUSHUA’s Name. No sorrow for di ones wey I go allow to be killed for MY sake. But instead sorrow for di people wey do di killing and torturing. Dem go have all eternity to suffer for wetin dem don do, becos wetin dem don do to MY Children wey lay their lives down for ME. Dem go receive di same torture di same way in hell for eternity. Those wey go die suffer in dis life but for eternity dem no go ever suffer again. Their rewards are great in Heaven.

I dey come for MY Bride without stain or wrinkle. Learn now how to please ME. Learn now to obey ME. Learn now to put everything on MY altar of sacrifice. Wetin I return to you na for a blessing, wetin I remove you no supposed to have, becos e go only harm you. I am a good God. I am your Heavenly Father and I dey carefully watch over those wey dey cry out to ME to speak to dem, show dem wetin to do, when to do am, where to go. No think say for one moment say I never hear your prayers. E just be say e no yet  be di time to speak out di answers.

I dey wait, as you dey wait, patiently I dey wait as each day more souls dey turn toward YAHUSHUA as their deliverer and redeemer. I no go fit wait too much longer becos di enemy dey plan to launch an attack worldwide at di same time. I no go allow MY Children wey dey listen to MY voice to be deceived. Listen closely to di enemies voice and you go see when you hear am every where for radio and television even for internet dis no be di voice of your Creator and Savior! Listen close and watch di eyes as dem speak, no listen with your physical ears only, but use your spiritual ears, and no see with your physical eyes, but ask di RUACH ha KODESH to show you with your spiritual eyes.

For dis world things no be wetin e appear to be. For dis world di god of lies and destruction dey rule many countries. But di God of Truth na YAHUVEH and YAHUSHUA and I don put for inside all those wey dey worship, serve and obey ME di RUACH ha KODESH and di RUACH ha KODESH go separate di truth from di lies. Di RUACH ha KODESH go hide you from di coming destruction and devastation. Make you no allow your eyes to only be focused on di darkness, di negatives of dis world, but instead think about di good things, di protection, di miracles wey I go do to save MY Children. Just like in di time of Moses, na so I go do am again. In a new way, with new modern day tools, but never di less I go protect MY Babies, Bride, Chosen Ones and Elect. I no go only protect but I go bless MY beloved Bride in ways wey dem no go even dream of. Just TRUST ME!

No be everybody wey call demsef MY Bride and dey wait for me I go take home with ME on that day. My Son YAHUSHUA go only accept a Bride without spot or wrinkle. Are you living  carelessly, dey leave in sin but dey cover am in di shed Blood of YAHUSHUA? Are you thinking say you no have to obey MY Commandments and MY demand for holiness becos you think say it was done away at di cross of YAHUSHUA? If dis na you, then you are not MY Bride. Becos MY Bride know say to love me na to obey ME. MY Bride no dey test ME to see how far into hell she go near and still enter Heaven. MY Bride no dey wait to see if I go punish to let dem know say dem don sin. Dem dey get conviction by MY RUACH ha KODESH and repent before I go have to punish dem.

Becos all those wey dey call demsef by MY Son YAHUSHUA’s Name and say dey are saved and yet dey live a life of sin. You no dey fool anyone but yoursef. REPENT TODAY! MY Bride, I go protect from di horror wey dey yet to come, but no be you wey dey play games with di shed Blood of YAHUSHUA ha MASHIACH of Calvary! You think say e dey cover your sins when you dey pre-plan your sins? You think say going to church go wipe away that sin becos you appear holy to people, e no mean say you dey holy to ME. REPENT! Di horror days to come go prove who really dey seek ME and who all dis time dey hide from ME. No forget say I know your hearts, I know your minds; I know wetin you dey plan without you speaking a word. ME, YAHUVEH, wey create you, know you in all ways. Nothing wey dey hide from ME. Remember Ananias and Sapphira, dem think say dem fit lie to di RUACH HA KODESH. As in di days of Ananias and Sapphira na so e go be again. Those wey dare to mock ME shall be mocked! (Acts 5:1-11)

Di Blood of YAHUSHUA ha MASHIACH at Calvary go either save or by denying or refusing di gift at Calvary you are condemned. One or di other, for some di gift from Calvary is a blessing and dem go know eternity in Heaven. For others, MY gift wey I give at Calvary go be like a curse becos dem reject di only way to Heaven, di only way to forgiveness. By doing so dem accepted satan and hell and all it has to offer. Woe be unto those in these end times that accept di ways of satan and live a life of ungodliness, for your life go dey without fruit and every blessing wey you have shall be cut off. But for those wey go try and keep MY Commandments, wey no get other God but YAHUVEH and YAHUSHUA and dey only listen to di voice of di RUACH ha KODESH and no dey follow after di seducing spirits. Your life go dey full of blessings on earth and for Heaven. I will never leave or forsake you. Just believe. No Cast your faith away as you see di coming Judgment day.

* * * * * * *

Dem write dis word, as YAH take speak on dis Jan. 25, 1999, 12:00 P.M. thru dis Woman Servant, Child, Warrior, Bride of YAHUSHUA Messiah
Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)

* * * * * * *