Prophecy 27
YAHUSHUA GO Return on a Sabbath!
Arise Women Apostles and Prophets!

Dis prophecy come thru Prophet Sherrie Elijah (Elisheva Sherrie Eliyahu) on
January 4, 1999

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva],make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth.Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA,your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH,your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago.Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

ME, YAHUSHUA, go come back for Sabbath, you no know which one. Come forth MY Women Apostles and Prophets! Arise NOW! No longer let anyone tell you say I have not called you to be Prophets and Apostles, Teachers, Evangelists or Pastors! I am di Potter you be di Clay. Why  you go even listen to man or those wey get di spirit of Pharisees? Speak out dis message wey I give dis Apostle to speak. Join with her voice, women and men wey recognize MY voice wey dey speak out from wetin I write thru her. Encourage one another. Satan don silence you far too long. Apostolic Prophetic warriors you know who you be. Write MY handmaiden and encourage one another, learn from one another. I am coming back very shortly. Join hands with one another. You are not alone. I don scatter una around di world, but you go know one another in time.

Una need one another. Una  go join with di men wey get di same calling. Yet, those wey refuse to acknowledge you leave dem to ME. No argue with those wey get deaf ears but mean well, and yet dem don cause too much pain to those women wey dey tell say  dem no fit have a calling of apostle, even di one wey dey write dis prophecy dem discourage her and tell her di same thing. She say, “Oh well, I go continue to do wetin I am called to do, by whatever name una call am”. Yet di man wey tell her dis was deceived by another voice, no be MY voice. He must REPENT for doing so. Will you be ready? YAHUSHUA DEY COME BACK ON A SABBATH DAY! Tell everybody wey go hear, no expect all of dem to believe. Dis no be your problem, but their problem. You na just to obey.

Together, those wey I put together with you go be like jigsaw puzzle and no other pieces go match perfectly. Keep your eyes open for others. I am bringing a troop of Prophets, Apostles, Evangelists, Teachers and Pastors and yet dem go work as one unit. Dem no go ever think more of demsef than wetin dem be. Knowing say by standing together dem go accomplish to do wetin  I ordain make dem do. Dem go reach a great harvest of souls and dis go be one of di greatest soul bringing ministries to walk di face of dis earth. For ME di Father YAHUVEH, MY Son YAHUSHUA and MY RUACH ha KODESH’s Glory! Many for no become saved if to say I no raise up dis ministry.

MY Apostle wey men reject as Apostle, know MY voice and write wetin she dey hear. Other women wey I call Apostles and dem tell dem say dem cannot be used in di office of Apostle, but I say unto you as I tell dis apostle, dis no be for men to determine, how I go use MY Women Servants na MY business alone. Dem be MY clay and na ME alone go mold dem and try dem thru di fire of their trials di way I choose. Who be man to say wetin ME, YAHUVEH, can do and cannot do. Many men have been deceived as dem dey underestimate di Spirits like David’s, wey I don put inside MY Woman Servants.

Di more di men fight against dis, di more I go raise up MY David Spirits in MY Women Servant. Pride alone nain dey make a man to speak dis kain things. REPENT TODAY! I don ordain her to encourage both di women Prophets and women Apostles, teachers, evangelists, and pastors. She know di heat of persecution becos of di high calling wey I don put on her life and on all of those called to be MY Apostolic Prophetic warriors for dis end times. Most of dem na women!  No let di men or Pharisees to HOLD YOU BACK! Dis na wetin ME, YAHUVEH, don do and dey do. Who dares to tell YAHUVEH say HE is wrong?

I bring you and di men and women all together to be one in MY RUACH ha KODESH, una go move as one in MY RUACH ha KODESH and una go speak as one in MY RUACH ha KODESH. Una go reach out to di unreachable and many people  wey dem don reject and cast away as unsavable and yet I go send una out with anointing and words and love wey no be your own to take reach dis people, Yeh, I say to reach a people wey you go fear to offend dem, but by not speaking go be di greatest offense of all. I trust MY laborers wey I send out, becos I be di Potter and you be di clay. I know wetin I put for inside each laborer to join with her. I know wetin she is made of and her weakness. For where she dey weak, for others I don make strong. Where di others wey go join dey weak, she go dey strong, like iron wey don go thru fire na so I don do with all those wey go join with you. You no need to fear who go join you, becos I tell you no be your choice but MINE!

Any Judas’ wey  dey look to join dis ministry go have di same destiny as Judas! I no go allow anyone to destroy wetin ME myself don build and go continue to build. Dis ministry go embrace di world. No hate di small beginnings becos I begin as a babe in a manger, Abi no be so? On di earth, for di beginning, dis na wetin all di earth fit see. And yet in three years, see how many life wey I touch, and save. All di books in di world no go fit contain wetin I do in that short time. No underestimate di power of MY Anointing! I don anoint all of una and go continue to pour out MY Anointing in a greater way. You go know in yourself  say you no go fit do anything but with YAHUVEH all things are possible if you can believe.

Now una dey separate in different states, but dis na only temporal, becos dis year you go be together, close enough to touch. You go travel and minister together. No try to make dis to happen, watch ME make dis to happen. No try to say which time and season, only know say e go be MY time and season. Pray and cover one another. Labor together; share wetin you don learn together. When I choose di partners to join with MY daughter, I choose very carefully and I test dem seriously. I Love you so much. I trust you so much. I know say you no go harm MY servant but instead you go protect her and she no go harm you but protect you. All those wey don join dey very special like a chain wey dem  use solid gold take make. I no dey put any how chain like zinc, or silver, or lead along with MY golden chain but only di best metal I can find wey don go thru di fiery furnace and come out as pure gold seven times pure!

* * * * * * *

Update wey dem add 1/22/2016. Dis scriptures below show say YAHUVEH trusts HIS servants. HIS prophets of old. Just like HIM take know Jeremiah even before he was formed in his mothers womb.

Jeremiah 1

4 Then di word of di LORD come unto me, say, 5 Before I form you in di belly I know you; and before you come out of di womb I sanctify you, and I ordain you a prophet unto di nations. 6 Then nain I com say, Ah, Lord GOD! behold, I cannot speak: I be small child. 7 But di LORD say unto me, no say, I am a child: becos you shall go to every place wey I go send you, and whatsoever thing wey I command you you go speak. 8 No fear their faces: Becos I am with you to deliver you, saith di LORD.

Numbers 12

6 And YAH say, Hear my words: If there is a prophet among una, ME di Lord go reveal MYSEF to him in a vision; I go speak with am for dream. 7 No be so with my servant Moses. He dey faithful in all my house.

* * * * * * *

Never think of yoursef more than wetin you be. You are a beloved vessel of clay, I don pour forth MY grace and mercy and gifts of di RUACH ha KODESH. You be willing vessel wey no dey  fight against di Hand of di Potter. You don allow ME and go continue to allow ME to mold you di way I want you to be and no be di way you choose to be. Everything wey you get you must put upon di altar and allow ME to remove wetin I no want you to have, and give back wetin I  want you to have. Hold nothing back and trust ME, I go give am back and no be only wetin you sacrifice but I go give back more than wetin you offer ME. Test ME and see if I no go do as I say.

MY Apostle, put all you have on dis altar including dis ministry, watch wetin I go do. Be willing for ME to remove anything or anyone for una life wey no dey help you, but instead dey hinder you from being and doing every thing wey I command to be done in MY Name. Do dis with everything, even your children. As Abraham, you must believe say I am a good God and I go give back every thing that is to be a blessing, and take away anything wey satan put in front of you to be an obstacle! Do you dare to do dis, MY Children?

Your Finances included. No hold anything back becos na MY own anyway. “wetin be yours ma MINE, wetin be MINE na yours!” Give it to ME so that I can give am back in a greater way. Tell MY People. Write dis, no be only for your partners wey go join you, but also to MY People becos di same commandment dey go out in dis end-times. Tell dem, “LAY EVERYTHING WEY YOU HAVE ON MY SACRIFICIAL ALTAR.” Say, “DARE TO TRUST YOUR FATHER YAHUVEH, YAHUSHUA and di RUACH ha KODESH!” Dare to be willing for ME to remove wetin no supposed to be for your life! Dare to trust say I go multiply di blessings wey go I give back. Do dis now, before I go have to take am without your permission! Do dis, whether na husband, wife, children, finances, home, car, ministries di list goes on. Do dis with anything wey you value whether na business, partnership, churches. You go know wetin  e be.

Anything wey you know say I no approve of, your cigarettes, or any other bad thing wey you dey use to bring you peace, when instead, na just counterfeit, Becos I am di Prince of Peace! You need nothing else. Give am to ME, sacrifice am to ME and if e supposed to bless you, I go return am. If e no be for your blessing, I go REMOVE IT! Becos you, that call yoursef MINE, I have di right to take away wetin I don give you, as well as wetin satan give to you or  wetin you give yoursef, anything wey dey hinder your walk with ME. Do you want me to save you in di coming days ahead? Then OBEY ME and do dis. Pray if you no know di meaning to dis. Even lay your marriages on dis Altar of Sacrifice. Di Godly go stand. In fact, I go bless you in a way wey you no go dare to believe.

You MY Children say you want MY perfect will? Do you really? Will you really give ME one day a week? Di Sabbath, Friday evening until Saturday evening you are to rest in ME, rejoice in ME, learn of ME. Lay aside your work and instead do only MY work, if any work is to be done. Pray and I go show you wetin to do and wetin you no suppose to do. I am a God of perfect balance. I hate anything wey dey unbalanced. Even di Sabbath must be don in balance! Dis na a day of rejoicing in ME, no be bondage; dis na a day to be a blessing unto you no be a day wey no like make e come but na day wey you supposed to look forward to. Di Sabbath no be a day of bondage but a day of freedom in ME, YAHUSHUA! MY disciples and ME na di example of wetin to do on di Sabbath. No Learn dis from di Pharisees wey say dis na a day to be in bondage. wey say dis na a day to suffer. Yea, I say great go be your blessings for observing MY Sabbath day and keeping it Holy.

DIS IS DI DAY WEY I GO COME AGAIN! Yes, I say keep di Sabbath from dis day forward for those wey claim to be MY Bride! Get ready for your Bridegroom doth come and go arrive on a Sabbath. You no know which one. But those wey no dey wait for me on di SABBATH go MISS ME. Yes, I say again, as MY coming to earth dey draw closer, on dis day make I dey for your mind, your words, and for wetin you dey do. Enjoy dis day with ME. Can you not forsake your pleasures of di world for ME one day a week? Practice dis now. Di time dey come when di evil ones go take notice who really be MINE and who no be really MINE. Dem go know by di MARK of whether you dey observe and keep MY laws. Dem go forbid you to gather on di Sabbath or acknowledge dis day as di Sabbath. Remember Friday evening until Saturday evening. Dis na di SABBATH. Keep am HOLY and a day for you and ME to cuddle and get to know one another. You be MY beloved. Those wey do dis go know blessings more than any wey you don know before.

Now I don speak all dis things to MY servants and I don deliver dis message to you di people in di middle of a personal prophecy wey dis ministry receive. Yet I leave una with dis words to those wey claim to belong to ME, and those wey dey lead souls to ME, teach MY Babies, Bride, Chosen Ones, and Elect to be Sabbath keepers not Sabbath breakers. Na by dis, nain every people go know you! By this you go dey ready for MY coming. Those wey get ears to hear go hear, all others go remain deaf. Leave dem deaf, becos na di spirit of rebellion don enter  their hearts and their souls. Leave them! Again I say no try to change their minds. MY scripture speaks di truth, it cannot change.

ME, YAHUSHUA, come to fulfill di law, no be to cancel YAHUVEH’s laws! Tell dem and if dem refuse to hear, no waste your saliva for dem. Remember as in di times of past dem kill many becos dem keep MY Sabbath. Di time dey come when you go see great trouble and dem go  happen on di Sabbath day. People go shake their heads and wonder why? You go know di reason why. I just now don tell you. But how di others go take know say dem dey offend ME if you no tell dem? Everybody wey dey read dis, and recognize MY voice, you are held accountable to tell di people wey no know. Dem think say by attending church on Sunday dem dey honor MY Sabbath. But MY true Sabbath day none of dem dey notice am. I no care if una you gather together every day to worship ME. But still for di Sabbath day, dis na MY day and your day wey we set apart to be special like no other day. When you eat remember say you have an unseen guest. Remember say whatever you dey do that day, I dey do am with you.

If you dey sin I go especially take note on dis day. You have been warned once again so MY People no go say dem no receive warning before I send di  judgments to those wey purposely disobey. I am a God of Love and Wrath to MY enemies. You be only MY enemies if you choose to be. I die for everybody, MY Blood was shed for everybody; I no be respecter of persons, yet I know who truly be MINE and who belong to di church of di pretenders. BEWARE trying to mock ME by saying di words wey other people want you to say, and yet dem no dey hear MY voice. Beware of speaking and not doing. I don speak out from dis Woman Servant, when she no even expect ME to prophecy to di people once again. So you no go say those wey mock ME from di last words of warning wey I give, HEAR ME! FEAR ME! BELIEVE ME! Was it not ME di Lord your God YAHUVEH and YAHUSHUA wey speak dem thru her? Beware of making her your enemy becos she no dey responsible for di words wey I speak. She dey only responsible if she fear to speak di word in boldness. She don obey ME so far.

Will you be a Sabbath breaker or Sabbath keeper? No expect to be part of MY Bride if you no dey ready on dis day for ME. Prepare now MY Bride becos I am COMING QUICKLY! Great troubles go happen on MY Sabbath as a sign say dis na law wey never change. You go know when you hear dem. I no dey change for any man or woman, time or season, I am di same God yesterday, today and forever. MY Commandments I write am for stone by di finger of I di Great God “I AM” and I no dey apologize to anybody.

I forgive easily all those wey no know better. Dis Woman servant wey I dey speak out from dey only now learn MY meaning of di true Sabbath. It was for a time and season. She no dey better or worse than all di rest of una wey I dey now teach. Remember now say you dey responsible for wetin you know. Wetin you do with dis knowledge I don already know. Ask ME on dis day wetin dey offend ME and wetin no dey offend ME. Pray on dis day and offer everything up to ME as a sacrifice, I go bless and multiply di thing wey be blessing to you and ME. I go Curse di thing wey be a curse unto you and ME. How many wey dey read dis go dare to trust your God? I already know di choice wey you make.

As I take speak am, na so dem Write am down, under MY anointing thru My Apostle Sherrie Elijah (Elisheva Sherrie Eliyahu), January 4, 1999, 9:49 p.m.

* * * * * * *