Prophecy 18

Beware The Veil Of Darkness wey don come From Hell!

Dis prophecy was Given to Rev. Apostle Sherrie Elijah on March 6, 1998

* * * * * * *

Dearest family of YAHUSHUA,

I received dis one today as I cry yesterday for di young children wey dem murder without any reason other than di other young children dey possessed by evil spirit of murder and mayhem. dis 11 year old and 13 year old no even understand wetin cause dem to shoot innocent children their own age, di chidren wey dem follow play and laugh with befor and now to come murder dem like animal in di forest but even di animal get chance to run and hide. Satan himself manifest to dis children in a way wey we no go fit understand. Yes pray, but pray say make dis government wey remove di only protection wey dis world get, HIS Name na YAHUSHUA ha MASHIACH and di Holy Bible will be quickly put back in di schools. Once again di Ten Commandments will be hang in di public schools. Thou shalt not murder. We say that and then di government dey tell our children but you can murder innocent babes as long as no one can see it as long as di baby dey safe inside di mama belle away from people eyes; e dey legal to murder that helpless innocent baby. Na di mother choice.

* * * * * * *


Thus saith YAHUVEH, "HOW DARE YOU, HOW DARE YOU, HOW DARE YOU! You dey ask ME how I go allow such a thing. You say where is YAHUVEH when all dis murders of dis babies occurred? But una remove me from your public school system. Una no dey mention MY Name  only when una wan use to curse. Why be say una want MY protection but una no want MY presence? Why be say you dey consider dis any more of a horror than when innocent baby dey cry in di mother womb that is tortured in di act of abortion? Abi na because only ME dey fit hear their silent screams? When on di schoolyard di screams and cries of di babies una hear everywhere you no see say na di same thing? Di spirit of murder entered into children wey dey play for satan territory.

Abi I no say whatever dey for your heart go come out. Dem dey feed Children by force  with blood and bloody murder thru television ,thru di movies and games wey dem dey play. Dem dey feed Children by force with violence, death, destruction, homosexuality, porn, hatred and rebellion just to name a few. Dem dey teach dem say Holiness no dey needed for today. You say to ME why I allow Dis thing? E for no happen if only dem teach di children to cry out in MY Name. Those wey see dis mayhem go testify say when dem call out to ME, I was there. MY angels fight for dem and cover dem with their wings. All dis babies dey for Heaven, yes di ones wey dem abort and di ones wey die for that school ground. But I allow dis to show wetin dey happen to di public school system as di spirit of antichrist dey troway anything wey dey Holy out of school.

You dey pay di price America and all di nations wey dey follow America example. Dis go continue until dis senseless abortions stop. I go allow satan to manifest in your children wey dem never teach how to call upon MY Name. I go allow satan to use di music and media take corrupt your children and take dem away from ME and away from you and dem go become allowed to declare war on parents, adults and authority figures. Becos when you no teach dem how to respect wetin dey Holy and wetin MY Laws be you just open dem up for satan to fill dem with his evil spirits wey go confuse and confound America and di school system. Games before wey start out as innocent and fun, wey dem be dey use teach children how to get along with one another now dem dey use am take dey set dem against each other to see who go fit murder di other.

Abi MY Word no talk say, "When you sin inside your heart, you don sin against ME?" Your imagination no be your own, every imagination, every thing wey enter your mind is to be held captive for MY inspection. If na sin against your brother na sin. Di greatest of all di Ten Commandments na to love your neighbor as you love yourself. That also include say make you no kill. And Yet your children dey kill and dem dey kill di good and di evil for their games wey dem dey play. Beware, as I don ask before out of dis Woman-servant, "Wetin satan dey feed your children tonight thru di media, thru their age mate, thru games or books wey dem dey read and thru their music?" Beware, satan know say I enter into dis world as a innocent child and now he dey seek to punish di children, to corrupt their souls and eventually take dem to hell with him.

Your babies dey become pregnant and dem dey tell dem say its fine, just get abortion na wetin dem dey tell dem. Not one concern for di innocent child wey dem no teach say sexual promiscuity na SIN and dey lead to corruption of dey soul. Not one concern for di torture of that innocent baby wey dey inside di Mama belle. Even though di mama na small pikin herself, she still dey sin against ME Almighty God YAHUVEH, and she dey sin against her unborn baby wey only want to be born, as she decide to execute di baby. There is no difference between a gun wey dem dey use to take kill and di doctor wey dem dey use for murder. all na still murder for MY eyes. Di mother also dey sin against her body, soul and Spirit. Her mind no go ever forget, although I can still forgive if she go ask ME and turn away from this evil.

I dey prophesy now, something wey dey so horrible to think about but di murders go become more frequent. Di parents go fear their children. Di children go control their parents as dem dey allow dis rebellion to grow.  Di states go say, "Na dem own your children." Di states go pass laws to keep your children from getting disciplined by di parents. Dem don already dey take Parental rights away little by little till soon you wey be parents no go get any rights. Make you no let dis thing to continue. Satan no go fit take wetin you no give am. Take back your children in MY Name. Take your children out of di dens of iniquities; you wey dey educate dem at di expense of their souls.

Seek ME while I can be found easily and I go show you another way to educate your children, both di things in di spiritual realm and physical realm. I go once again give dem back di desire for Holiness and for morality. There is a veil of darkness wey don descend on di public school system, and di cloak of darkness come from di very pits of Hell and e dey cover many of di youth of dis nation, wey no dey worship ME as their Lord and Savior. Di children dey suffer for their parent sin of not teaching dem who YAHUSHUA ha MASHIACH be. Na ME be their only protection. Satan now dey welcomed in your schools and unholiness dey abundant in di schools. Stand up parents; take your children out of schools wey no go allow MY Holiness to be part of di raising up of your children. Stand up parents and tell di government say you get di right to discipline dis children. I dey discipline those wey I love. Dem must know di fear of Almighty God YAHUVEH once again and di fear of their parents. Godly, respectful fear wey dey build character and wey dey nourish di soul as dem go always know say there are rules and if you break di rules you go pay.

 Schools dey pay now. Di government dey pay now. Parents dey pay now. Dem dey look to pass laws and e go come to pass, only if you allow am, law wey go forbid you to spank your children. Most of all, di youth of dis nation and world dey pay now. Dem need ME and yet na very few parents dey teach dem say I be di only way, truth and life. Holiness dey necessary and dey very important in dis end times. Fear dis law! Fight dis law! Becos if you think say your children dey rebellious now, na only a small fraction you dey see now. Di blood no dey only on di hands of dis children wey dey do di murdering,  blood is on di Board of Education. Di blood is on di hands of di parents wey no teach their children Holiness. Di blood dey di hand of di government. Di blood dey on America and no be MY Son Blood, YAHUSHUA ha MASHIACH, dey cover dis nation, but di innocent blood of di million babies wey dem dey murdered every day, 24 hours a day.

When you say murdering di babies dey legal as long as dem dey for their mama belle and we no dey hear their silent scream and wails wey only ME dey hear. I tell you di screams and wails go come from di children wey you go fit hear, children of di heathen, children wey you dey see, children wey dey so innocent but no dey different from di babes wey dem dey kill for their mama belle. One murder na di same, one rebellion na di same, and di spirit of unholiness na di same. I dey see all and I dey hear all! Unless dis nation repent for di children wey dem don kill you go see more children die. No think say I be  GOD to be mocked any longer. Your churches dey preach MY love and yet dem no gree teach MY children say I also be GOD of Almighty love and Almighty wrath! In times of old I allow dem to stone children for front of town square.

Rebellious children wey their parents no fit control, di kind children wey dey lead to more rebellion, I comand make their parents throw di first stone. Nowadays dem don make laws wey dey protect a child from getting spanked on their buttocks wey I created for such a purpose. Now, there are laws wey go let children to go free with a slap on di wrist after a short time of prison arrest. Make you Understand this, I dey tell you this, those children go do murder again becos that evil spirit still dey inside them and di next time e go even be greater than before if dis children are not delivered. Your juvenile homes need YAHUSHUA to chase di demons from dis children. Dem no even understand say no be di children dey pull di triggers, or make di plans, dem be like pawns for chess game wey dey only feel di move.

America, repent becos di veil of darkness wey comes from Hell wey dey make you think say wetin you dey do in secret  no go be exposed. Homosexuality na just another life style wey you want to teach, but na di darkness from Hell wey don keep you from seeing di light of truth. dis na abomination unto ME! I send you AIDS for a wakeup call and you ignored ME and you try and find cures. I dey send a far worse plague than that. BLACK BOILING BLOOD PLAGUE! Dis one go come upon all those wey dey force feed your children di evil spirit of homosexuality on silver spoons. E go start with Ellen Degenerate (Degeneres) and e don enter into di White House. You dey mock ME. You think say because I dey invisible I no dey hear or see wetin you dey talk and do. You think say di Holy sanctity of marriage is to be mocked. You think say MY Ten Commandments no dey of value for dis time and age. I am ANGRY and I say unto all those wey dey display your unholiness for MY face. You go see say I no be God to be mocked. You shall suffer, your children shall suffer and your country shall suffer. But no be those wey belong to ME, I go protect, shelter, bless and guide all MY children wey don give their hearts, lives, Spirits and souls to di God of Creation and God of Salvation.

You heathens wey dey do abominations for MY eyes, and put put am for Tv and e even dey for your songs, you wey want everyone to have a choice for abortion, euthanasia, and homosexuality, [euthanasia na when dem go withhold treatment from di dying and just let dem to die], you wey dey take away di rights of di parents to raise their children with a Godly fear and respect. You go find out say I am YAHUVEH and I am a God in equal balance to love and wrath and you go see wetin go happen when dis punishment come upon you from nowhere but MY hand. No where to run but to ME. Dis new plague don already begin great tiredness, great fever, your blood go appear to look black, no immunity, your blood go pour out of your mouths, hemorrhaging! Becos you dey mock di Holy Blood Shed for you at Calvary and now I go mock you back with blood wey go show di unholiness in your blood. You go pray to die but death no go come easily. REPENT NOW! Stop to kill MY unborn babes. Stop to corrupt di youth and dis world with your bad smell of unholiness. REPENT NOW America! Watch as those wey you dey consider leaders no be leaders anymore. REPENT NOW! Di blasts from Hell wey dey curse everything wey dey Holy for your media, wey children dey repeat after and not even understand how dem dey anger ME dis must stop. I go beat you with MY ROD of wrath until you repent.

Those wey be MINE and you know who you be, you have a relationship with your Savior and you love and put ME first in everything wey you dey do. You recognize di counterfeit as satan dey mock ME in Garland, Texas. You are not deceived, you know your YAHUSHUA go come again quickly and when di mocking and counterfeiting dey take place you no go be deceived. You MY beloved treasures dey more valuable than words can say you know which Name to rely on to deliver you and your souls. Your children dey safe and secure in di palm of MY hand and MY other hand dey shelter dem like say dem be newborn chick. I go protect those wey belong to ME, those wey desire to belong to ME, I dey wait for you. I no get any desire to beat you with MY ROD of affliction. MY ROD and staff na to comfort you to protect and guide you.

MY ROD na to protect MY children as I go pour vengeance upon their enemies and MY own. MY ROD na also for chastisement as you are to spank your children na so I must spank MY own also at times when needed. MY ROD of wrath dey reserved only for those wey dey for total rebellion. Beware di ROD dey come to America. Beware di ROD of Wrath dey come to other nations of dis world wey don decree say dem go serve another god. MY desire na dis say I want to lead you with MY Shepherd's ROD wey dey protect and guide you and go only beat di enemy away, di wolves wey dey pretend come like good but instead dem be evil.

MY beloved children know say religion no go save dem but only a loving relationship with YAHUSHUA ha MASHIACH, YAHUVEH, and the RUACH ha KODESH go save dem. Only di truth and no salvation except thru di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH, di Blood wey I shed for you at Calvary and di Holy Word go save you when you speak am in di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH. Only by repenting and turning away from sin and striving to leave a life of Holiness and obeying ME go fit save you. Knowing say you no dey perfect but you dey daily work to please ME and do wetin you know say I want you to do. All di others I say unto you HOW DARE YOU? How dare you blame ME for di evil wey you don bring upon yourselves and your children? You don reap di darkness from Hell and no deliverance except thru di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH of Calvary. Na ME be your only source of light but how many go call upon ME so that dey can be saved? Once again I dey speak forth dis warning from MY Prophetic Handmaiden Pastor Sherrie Elijah no be because of who she be but because of who I AM. I, di Great Almighty God YAHUVEH, don speak. Those with ears to hear listen and learn, those wey dey deaf and blind go only grow more spiritually blind and deaf. 

* * * * * * *


3/26/98 3:54 PM given to this humble vessel of clay Prophet Sherrie Elijah.

As I dey read dis to my site manager I come feel dis chill go through me as we dey talk for phone when I reach di part of di new plague wey hit dis world far worse than AIDS. Then Tongues come start, warring tongues. Then as my eyes dey closed I see one blackest of black thunderclouds. I come realized say na thundercloud of HIS anger and he has just thundered out of my mouth HIS angry words. Next thing wey come na lightening. HE go strike HIS targets. Woe be unto di rebellious wey no recognize dis warning. YAHUSHUA sends me out as HIS mouthpiece to speak forth dis warning because of HIS mercy so that dem go repent. Then di doom go come. Beware of di ROD of Almighty YAHUVEH! Turn back to di God of our forefathers. Turn back, America, to YAHUSHUA ha MASHIACH before it is too late.

Below na another prophecy to confirm wetin YAHUVEH don speak from di newest prophecy wey HE give me, "Beware di veil of darkness don come." Di word wey dey next, somebody forward am to me from another person. A covering of darkness upon our schools: YAHUVEH don show me a covering of darkness wey come from di darkness upon our schools.

We must pray and fast for di movement of dis covering becos YAHUVEH says... I hear di prayers of MY people when dem pray with all their hearts. More destruction go appear unless we pray and fight dis in di spiritual realm, no bi natural or physical fight. Wetin di enemy dey do to destroy us? He dey work from inside. We get more things to concern ourself with di things wey dey near us more than di threat wey dey come from outside. Pray and intercede now for dis generation. E dey good to set aside a special day of prayer,  and yet MY intercessors must not wait becos di time na now for di sword of di Spirit wey be MY Word to be drawn and di prayers in di Spirit to begin on behalf of dis MY little ones. Abi I no tell una say e dey better for a man to have a millstone hang around his neck and make dem throw am  inside river than to harm even one of MY little ones? Soldiers put on your armor and go to battle becos dis na di battle of I, YAHUVEH, and I, YAHUVEH, go use those vessels wey dey available, those vessels wey dey open to receive MY Spirit poured out with measure to empower you to fight in di spirit realm. Make you no fear and no be dismay becos I,YAHUVEH your God dey go ahead of you and I send forth angels of protection in mass numbers wey you no go fit count, to protect these little ones. Watch MY children, thus saith YAHUVEH.

I dream one dream on 9/3/92, wey I go post for another page I believe. YAHUSHUA don already tell me about dis plague wey don come and yet I no understand am and I go share di dream as I copy am from my notes. I no claim to get di full revelation. If di RUACH ha KODESH show one of una di full meaning please e-mail me and I go post di meaning as di RUACH ha KODESH take direct.

Contact AmightyWind