Prophecy 10

Take Back Wetin Satan don steal!

Given to Pastor Sherrie Elijah on December 4, 1997

* * * * * * *

Oh Mighty Warriors, one day una go hear, "you good and faithful child make you enter and rest now but for a little more time and your Bridegroom go come." Hold on tight to di hem of MY garment. Hold on tight make you no remove hand. Even when you get too tire na becos of ME you dey suffer. becos dis no be your work, no be your ministry, na MY own. Na for YAHUSHUA's (Jesus') sake you dey struggle and you dey labor but not in vain. becos Dearest Beloved, make you hear di RUACH ha KODESH (Holy Spirit) dey tell you? 

One good thing no dey, wey you leave behind,  wey you no go get back pressed down, shaken together and running over wey I no go give to your bosom and make other people to give you, and support that work wey no be your own but MY own? Your riches no be of dis world, but di world to come, na so  YAHUVEH talk. Your riches MY beloved dey stored up for you in Heaven. Your riches na di souls wey you don bring to ME. Your riches na di gifts wey I don freely give you. Your riches na di mighty prayer warriors wey dey protect and support you with their prayers. Your riches na how you dey fit hear MY voice clearly. Your riches na how you take know say you dey surrounded with a cloud of witnesses and dem dey watch everything wey you dey do and dem dey say, na for MY Glory for MY sake you dey suffer wetin you dey suffer. 

You don experience many persecution, but  make you know dis thing, di enemies wey dey rise up against you no be me send dem and I no speak thru dem. Be not deceived, if dem no dey lift you up, then dem go dey put you down. If those wey dey say I be your friend and yet dem no dey support you in small matters, dem no go dey loyal to you in big matters, Make you remember say no be everybody wey dey say Lord be MY Child or servant. No be everybody wey dey say friend truly be your friend. 

So I say unto you, "You dey surrounded with those wey go say, "But I be your friend," and yet dem no know wetin di word friendship and loyalty mean. Dem be Judas' wey come to betray you, but I dey warn you now thru your sister, dis Prophet, so you go dey careful. Dem get their own hidden agenda; their own agenda to promote demsef. Dey careful becos you go see clearly now wetin you no see clearly before. Today I dey give you new gift and I tell you now thru dis your sister, MY vessel wey dey filled with MY RUACH ha KODESH. 

Wetin she speak go come to pass as you read dis letter  wey dey your hand by divine direction. MY Beloved, I dey give you dis new anointing so you go fit see into di bottom of a man soul. You go know a greater gift of discernment than before. But you no go like wetin you see, becos  some dey  come wey go be like say you fit trust but you go find out say you no go fit trust dem at all. Dem be Judas in disguise. Dey careful becos dem go go so far just to see evil come upon you. Yet I tell you when you see dis, rebuke dem in MY Name, and you go see di enemies run in seven different directions. Dem go run for cover, becos  also, dis day I dey give you a greater gift of boldness. 

Becos  I no be only Almighty God of love, but also of war and I don declare war upon MY enemies. I go use you take rebuke di nations wey dey rise up against ME and everyone wey dey Holy. All dis words no be your own and e no go be your own words, becos you go know when to speak, and when not to speak. You go continue to gather together MY children, and take back wetin di enemy don steal, and present dem to ME. 

You be living sacrifice to ME. Di work wey you dey do, you no dey do am by your strength and might, but under MY strength and might. Even though you dey weary many times, remember to call upon MY strength, MY boldness. Remember to call upon MY courage, MY gifts, becos you go face evil forces. Those wey dey practice evil, wey dey pray to other gods and yet you go overcome all their curse with MY Blood that was shed for you at Calvary with di word of your testimony and with di word of MY Testimony. 

When you receive power, di power of MY Name, Word and Blood use  am take defeat di enemy. Rebuke di enemies in MY Name. Make you no ignore dem becos by ignoring dem you go only dey make dem stronger. Expose di enemy and all di tricks of di enemy and you go prosper in ways wey you no fit imagine. 

MY Beloved, Oh how much I desire to hold you in MY arms and one day e go happen. Becos di times when you start to feel loneliness na di time when I dey very close. I dey stand with you as you dey stand for ME. Di gates of hell no go prevail against MY Church. You be MY Church. When you feel forsaken and forgotten even if you no see ME, you go know say I dey there. I no go ever leave you nor forsake you and I love you with a love wey no human being can begin to compare with. I know MY Children, MY Warriors and MY Bride. You be all of dis and so much more, I Prophesy to you now thru MY Woman-Servant who no know wetin she go talk next. 

I dey take you to a higher region pass di one wey you dey before. Get ready, becos when di enemy surround you, make you know dis, na because di enemy know say you no belong to dis world, but you only dey inside dis world and you only dey dis world to serve ME,  to do MY will, as I dey pour  out MY RUACH ha KODESH's gifts unto you freely. Wetin dey hard before go come easy. Wetin been dey easy before, you go  feel like say e become hard. 

But that na because I dey move you higher than you be before. You go be like unto Peter and I go say, "Cast your net deeper into di sea," and you go say, "But Father I never do dis thing before, or I never come here before." And I go say, "But Beloved, di fish dey plenty on di other side. Cast your net on di other side. Go into territories wey you never go near befor. Make you no Fear, Becos I am di Master Fisherman. I know which trap to use when I cast you into di sea. You no go come back empty handed. Only trust in ME and I go lead you and guide you to be even greater fishers of men. 

Wetin she don speak in MY Name go come to pass. I no dey start something wey good wey I no go finish. dis ministry now wey I don put for your hand dis day go grow by leaps and bounds. All of hell go tremble in fear becos dem go see you dey go more and more into their territories and you go take back di captives and set them free in MY Name. 

Read dis prophecy out loud, becos di power no dey for only di written word but di spoken word. Read dis prophecy to others so that dem go stand in agreement. Make you no dey surprised to see jealousy and greedy people wey go rise up around you, Becos now  I dey make di scales to fall off your eyes and wetin you dey refused to recognise you go see  am clearly, wetin you no wan hear, you go hear am clearly. 

MY Beloved make you know say; everything wey dey happen na di Master ’s hands na HIM plan am. Even though say e come out to be evil, I go turn am around for good. Even satan's plans, I go turn am around and deliver you in such a mighty way. People no go miss to recognize say di GOD wey you dey serve, YAHUSHUA ha MASHIACH still rules and reigns and lives and there is none like unto ME. 

When you pray, blind eyes go open, deaf go hear, di dead shall live again, souls shall be saved, enemies shall fall, just as surely as David kill Goliath. Di enemies shall fall by MY hand alone. But I go speak out di words of rebuke when dem come against you with their curses. You go say,"Di God wey I dey serve, YAHUSHUA ha MASHIACH is greater than any evil wey you go fit do to me, and HE say not one hair on my head shall perish if I no fear and I no dey fear any man or devil becos I hold the keys to Heaven, YAHUSHUA na HIM be that Holy Key." 

Prophesy to them dis thing, thus saith YAHUVEH of Hosts, "E go be di enemies wey dey rise up against me  wey dey look to destroy my life and that of this ministry wey go perish. By di hand of di living God who says be not deceived I am not easily mocked. Dem go reap wetin dem sow. But MY servant no  go perish but live to declare MY works." Thus saith YAHUVEH of hosts Na very fearful thing for MY enemies to fall into di hands of a living God but shelter and love dey there for you, MY Beloved. 

Do as I don command you to do dis day, as I don give MY Daughter di words for you to speak MY beloved, and make you go forward and have victory in YAHUSHUA ha MASHIACH's Name.

Alpha & Omega AlmightyWind Holy Ghost Fire Ministries. 

* * * * * * *
 

Given to Child, Warrior, Bride of YAHUSHUA Prophet Sherrie Elijah on 12/4/1997 

* * * * * * *


  Contact AmightyWind