Prophecy 5

You Are MY Hidden Treasure, You Are MY Hidden Weapon! 

Given to Rev. Sherrie Elijah on March 14, 1997

* * * * * * *

As I start to pray in di RUACH ha KODESH’s tongues and di next thing wey I know YAHUVEH dey anoint me na him dis message wey dey down take come out. I been think say dis message na for only Daniel e turn out say na for many people. Be blessed as you read di message wey dey here and see if di RUACH ha KODESH no go show you say dis message na for you too.

If you continue to seek MY face and to ask ME “When I go use you”? Dis na who dis message dey for. If you hear My voice inside dis Prophecy, then you, MY sons and daughters na him dis message be for. MY Spirit go confirm inside you if dis message na for you. Becos e go witness to di Spirit wey dey inside you. All di rest go remain deaf and dis prophecy go just be ordinary words. Dem go even doubt if dis na really YAHUVEH dey speak out of dis Handmaiden. (Woman servant of YAH). You dey right if you feel like that, dis message no be for you.

* * * * * * *
 
MY Dearest Children, you be like MY treasure wey I hide, you be like MY quiver of arrows, when people dey only see bow. (bow na him dem dey take shoot di arrow). I go use you take speak mightily and you go do wetin dis your sister dey do, to warn of di coming judgement. You also na watchman on di tower. Watch for di signs in di sky as Elijah take do, becos you go get di warning first and pass di warning to others. MY Children, I don anoint you to share di gifts wey I don give you. But dis day wey I choose, you don meet with MY Handmaiden, and her gifts and your own come become one. You make one another gifts to rise up. Make you no think say dis happen by accident, becos una be one in MY Spirit.

MY Word wey dey inside you dey burn like fiery sword. Di two edged blade go cut deep. (di two side of di sword dey sharp). There is a lot of fire inside your bones and you no know wetin to do with am. Start to speak out. MY Words no go return back to ME empty, it must do wetin I say make e do. I don tell you many things for secret wey you never tell  people. Now na di time to blow di trumpet and warn of di coming doom for di people wey dey mock or wey no care. But a time of blessings for those wey dey obey and seek MY face humbly, those wey dey listen to MY voice and MY sheep know MY voice and dem no dey come near any stranger. Dis ones get nothing to fear.

Even though death surround dem and you tell dem, e no go harm those wey be MINE and if they are martyrs their blood go go inside ground only to bring out more Pauls wey used to be shaul and give birth to more Stephens. You are like a Stephen; You are MY secret weapon wey I don hide. Again I say, you know MY voice and you also don get confirmation dis night from another of MY Prophets. You will and you are being used mightily to di ones wey you done already touch. Make  you no hate small beginnings becos even a mighty oak tree start from a tiny seed. You be like mighty oak tree of righteousness, MY righteousness. You no swell up with pride, and I no go allow that, becos I go knock you off where you stand if you even try. All dis time You stay humble before ME, and I love you so very much, becos I dey see you as you dey study in di night hours, I dey feel your loneliness and as you dey wonder where you belong.

Di footsteps of di Godly na YAHUVEH dey direct dem. Continue to follow MY footsteps and lead others unto ME. Follow MY footsteps and lead others to di tree at Calvary. Follow MY footsteps and lead others to di gates of Heaven. Na ME teach you, no be man. Na ME choose you no be man. You be MY treasure wey I hide, MY weapon wey I hide and I go begin to use you mightily in dis end times, and make you no be deceived dis na di end times. But no be di end for MY Children, becos for dem na wonderful new beginning.

A returning home na him wan happen  so and see as all MY children take gather around di banquet table. Yes, MY Sons and Daughters, una go gather around di banquet table sooner than una can  even imagine or think. First start to gather in di harvest, becos it is very plenty and di workers dey very few. Di people wey dey mock don become louder as I dey hear ministers wey been dey  preach MY Gospel now dey preach their own gospel. Dem dey call demself gods. I go prove to dem who GOD YAHUVEH be. Dem go regret  ever teaching dis becos many people don go astray becos of dis lie. Many people wey also die were surprise say dem no meet ME; instead di evil one be di one wey dem see. But make you no become deceived I am not easily mocked. Many lies dey comot from di mouth of those spiritual leaders wey you once trust. I go hold dem responsible for wetin dem know.  Dem dey preach rebellion  dey claim say na gospel. I tell you dem go pay in a mighty way. Dem dey call ME Father and no even know ME. But not you MY Sons and Daughters. No be those ones wey recognize MY Voice from di prophetic messages wey I give MY Woman servant. 

MY sheep go know MY Voice. Even though di voice of di stranger wey dem hear dey come from a respected pastor, or spiritual leader, wey in di past you can trust dem, now you  no fit trust dem any more. No focus your attention on ordinary man as your spiritual leader but focus on YAHUSHUA alone as your spiritual leader. Make you ask yourself say Wetin all dis spiritual leaders dey teach, dem dey in line with di Holy Word of YAHUVEH or all dem dey really do na to take di Word and twist am to man’s image? You must turn to di Holy Spirit wey go lead you into truth , and also give you spiritual eyes and ears to take hear. Trust a leader only until di RUACH ha KODESH says no more. Many ministries dey fall right in front of MY eyes. Na only di beginning of di year and wetin I prophecy don already happen and more go fall before di end of dis year. No feel sad for di ministries and ministers wey fall becos I warn dem

Feel sorry for di sheep wey don get deceived and no trust ME anymore. Be sad for di sheep as dem waka into di den of wolf, that na becos dis wolfs wey resemble sheep becos of the mask wey dem wear go eat dem. Dis wolfs go eat dem becos once again di sheep don scatter into di enemie camp  becos of their  ears wey dey scratch dem. (ears wey wan hear only wetin dey sweet body). Watch your ears MY Children. Watch your eyes.  Make you no get deceived by wetin tongue dey speak becos even though e sound as smooth as honey; discern di Spirit wey dem dey speak from. Discern with your eyes, dis word line up with YAHUVEH word?  A be dem be di type wey dey say ah ha I don study well well and I get dis revelation and di revelation wey dem get no bring you close to ME, but cause you to go away from ME. Check am with your eyes, dis thing line up with YAHUVEH’S Word? Abe dem dey say because dem  don read and study well well now dem get this new revelation,  but di revelation no draw you near ME, but instead dis revelation push you away from  ME. If na real spiritual leader ,he  suppose bring you closer, he go give you warning, encourage you and strengthen you. A real spiritual leader no dey swell up with bride.

Dem know say dem no be God not even a little god. Dem know who dem be; they are made in MY image meaning say dem get nose, eyes and ears. Come on; look yourself for mirror you know wetin image mean. Make you no let all dis foolish teachers deceive you. You are adopted, I get only one begotten Son, abe no be so? But even though say you are adopted I love you just as I take love MY only begotten Son. Tell others of wetin I tell you dis night even though dis message start for one person e turn out for many people benefit. I am YAHUVEH, thy God and I no dey waste anything. Even this discussion was planned. For Una to meet was planned.

I dey tell you now YAHUSHUA dey come for HIS Bride, and those wey no dey expect am will be left BEHIND! Those wey no dey live their life like emergency, like say HE dey come any day will also be left BEHIND. Now go do MY business and di work wey I call you to do. And e no matter if dem believe, leave that one between ME and them. As in di days of Noah dem no believe. As in di days of Lot dem no believe but be not deceived di voice wey dey inside dis prophecies dey talk to MY Children and I no go let them to be deceived, unless dem choose to be deceived.

Di More signs wey I go send of MY wrath, di greater di anger wey go rise up against di prophets’ wey dey speak out dis messages. But know dis, I always send di prophets to warn becos of MY love and Mercy. I no want anybody to suffer eternal damnation. So sound di trumpet once again, those wey get spiritual ears to hear go hear MY Voice clearly and all others go remain deaf and blind. Na their choice no be your own to make.

Given to Rev. Sherrie Elijah 

Contact AmightyWind