Prophecy 87
Israel, Oh Israel, make you Hear Oh Israel,
Jerusalem And Di Rest Of Di World,
Wetin ME, YAHUVEH, get to talk!

Given to dis Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)

for August 27, 2006

 

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva],make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth.Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA,your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH,your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago.Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

2 Chronicles 36:16 “But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words, and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH arise against HIS People, till there was no remedy”.
      

* * * * * * *

Sh’ma Yisrael Duet:6:4
“Hear oh Israel, di Lord na our Elohim YAHUVEH, di Lord is One, Blessed is HIS glorious Kingdom forever and ever.

* * * * * * *

PROPHECY BEGINS

Hear oh Beloved Israel, Jerusalem and di rest of di World. You no dey hear your Creator dey weep and travail at how far una don go astray from MY Holiness? You no go fit say you no know right from wrong becos oh Israel and Jerusalem did I not write MY Torah for una hearts and did I not command una to teach di Torah laws to your children? Una no be di seed of Abraham, Isaac and Jacob? Una no learn anything from your King David and from Joshua? So wetin be your excuse?

Which excuse una get to dey allow di abominations like di homosexual propaganda directed at your youth to pervert dem? Why una welcome wetin I call abomination and a shaming of marriage?Una dey claim ignorance to MY Tanakh? Una no understand how una dey bring shame to all wey dey Holy for allowing dis perversion to enter into wetin people once call di Holy City?

Becos those of una for Israel and Jerusalem wey weep and mourn for di evil wey dem bring to Israel and you do your best to protest, know say I go reward you in the amount of force wey you take protest against di homosexual spirit and di evil spirit of Molech called abortion. Why oh Israel, una own women soldiers dey murder di innocent babies while dem still dey inside their belle instead of not committing fornication? Una no understand say I no go bless una until you obey and repent and turn from your wicked ways and be Holy unto ME, YAHUVEH?

Oh Israel and Jerusalem, where is di fear, obedience, reverence and Holy respect wey your forefathers Moses, Abraham, Isaac, Jacob, Joseph, David and Joshua get? Do I need to go on? Oh men of Israel, why you think say your military strength nain make you men of strong courage? Una no understand say na your righteousness thru MY SON YAHUSHUA that will make ME to fight your battles and you go win?

Oh Women of Israel and Jerusalem, where are di Holy vessels wey fear ME, YAHUVEH, more than you fear wetin men talk? Where are di women of Israel with di Holiness and obedience and faith like unto a Sarah, Deborah, Ruth, Esther or Miryam? Why be say na di Delilah’s and spirit of Jezebel dem dey allow to defile wetin supposed to be Holy? Do you not know say one of MY Two Witnesses go have a spirit like unto Deborah who was Judge of all of Israel.

How be say you dare to ask ME to bless Israel and Jerusalem until you stand for Holiness? Can you not see say I am Just in all ways; I AM almighty in love and in war. I bless those wey obey ME, YAHUVEH, and I curse those wey disobey. Can you not see it is written for your own Torah and Tanakh there is sacred anointing power in MY Name wey be YAHUVEH?MY Word no say for Psalm 91 “I go set him on high becos he don know MY Name?” Why una no dey study for unasef and count how many times wey I have speak blessings upon those wey know and dey use MY SACRED HEBREW Name? Why be say una allow di Rabbis to steal dis blessing from una? Dis no be di way e be before. Which kain loving Father go hide his name from his child?

MY Name na YAHUVEH and e no matter to ME how you spell am or pronounce am as long as you acknowledge MY Name has YAH inside and also MY SON di only MESSIAH HIS Name na YAHUSHUA e no matter how you spell am as long as you keep MY Name YAH inside. Our Name no be ordinary title like HaShem or Lord, or Adonai. MY Name is above all names and na YAHUVEH. Take back wetin di Rabbis don steal from you. You dey take MY Name in vain when you spell am G-D or abbreviate am with YHVH or YHWH how you dey pronounce that one? You get name, wetin make you think say I your Creator no get name? When you pray call ME by MY Name, YAHUVEH. Those with spiritual ears to hear go listen all others go remain deaf.

Oh Israel, why do you not obey di laws that was given to una for Mount Sinai. I no set you apart for MY glory?I no lovingly protect you from di plagues and curses wey come upon your enemies? I no safely get you across di Red Sea by seperating it and sinking your enemies di Egyptians? una even bother to count how many miracles wey I don do for your sake? Oh Israel and Jerusalem, do you think say I like to beat you to get your attention. There is no nation like your nation for di face of dis earth. I don bless you so much, but how have you blessed and obeyed your Creator? Return to ME oh Israel so that I can again bless you abundantly. I no go fit bless anyone wey dey in rebellion. Make you Choose dis day which Elohim(GOD) you go serve!

Oh Israel, how MY heart dey sorrow I AM YAHUVEH, I AM di Elohim of Israel although so far you be like a stubborn and rebellious wife. You dey do di opposite of wetin I don command your ancestors Moses, Abraham, Isaac, Jacob, David and Joshua wey put MY will first to obey di commandments given to Moses for Mt. Sinai. Your King David receive victory in battles, na so also Joshua becos dem know say no be by their own toughness, no be by di number and strength of their warriors or weapons. Di victory come becos dem put ME, YAHUVEH’s Will first. Dem come to ME with repented hearts, fasting, anointed prayers, worship and praise.Dem know say di enemies were delivered into MY hands. Dem know say they were only used to fight in di battles but it was ME, YAHUVEH, wey win di wars for MY Praise, Honor and Glory alone!

Oh Israel, you have every right to defend yoursef but to your shame, you no longer rely on MY arms of war. You will be surrounded on every side becos you rely on a Judas called America for your support. You must understand say I am YAHUVEH and I will not be mocked even by Israel. Yes, I make a covenant with Abraham to protect and bless Israel but first you must be a blessing to ME. You must do your part and obey ME before you can walk in MY blessings of Deut. 28.

I, YAHUVEH, bless those wey be blessing unto ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA. I no go fit bless di rebellious. I must chastise those wey I love or I no go fit say that I love you. I sorrow for wetin I must do for only a few of Israel shall be saved. Oh Israel, you dey punish your enemies far more than wetin I intend, becos you forget say Abraham dey before MY face dey remind ME say your enemies na also di seed of Abraham thru Ishmael. You deny MY SON YAHUSHUA Holy Saving Blood wey soak Jerusalem soil, becos na true.

Even thousands of years later one drop of YAHUSHUA Saving Blood cover di world, yet you refuse to accept di gift wey I give as your Blood Sacrifice, greater than any animal blood sacrifice. I no only allow MY beloved SON YAHUSHUA to be crucified for di sins of dis world and die and be buried in a tomb. I raise YAHUSHUA from di dead as a sign to Israel, say, not only is there life after death but ME, YAHUVEH, choose Jerusalem for YAHUSHUA to die and be buried on your soil and rise again. Oh Jerusalem, di time dey near when di world go say, “You shall surely die and never rise again” but when Israel REPENT and obey, I shall raise Israel up once again.

Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World. ME, YAHUVEH, do dis for more than one reason. YAHUSHUA symbolize your miracle birth as a nation as YAHUSHUA dey set apart for MY glory. Israel you also supposed to be set apart to bring ME, YAHUVEH, Glory especially in dis end times. I pour Living Water thru your wailing wall symbolize by YAHUSHUA tears when HE was in di Garden of Gethsemane. HE wept for Jerusalem and Israel as ME, YAHUVEH, dey do now.

Hear oh Israel, I dey prepare MY Two Witnesses wey now dey live on dis earth and wey go soon be caught up to Heaven and return again filled with new anointing Powers from Heaven and a Glorified Body, wey no longer dey subject to di bondages of a physical body. MY Two Witnesses go come to you again with signs, wonders and miracles preaching ME, YAHUVEH’s Name and Glory and di Name of di only Prince of Peace wey be di only MESSIAH, YAHUSHUA MY SON. MY Two Witnesses go again come to rebuke you oh Israel and warn you to repent.

Hear oh Israel and Jerusalem, becos you refuse YAHUSHUA’s Blood at Calvary to wash your sins away, you go see blood high up to di nose of a horse and e go flow thru your land. (Rev:14:20)

Hear oh Israel and Jerusalem, Jacob wrestle with ME, YAHUVEH, and becos of dis he become cripple come dey limp when he dey walk (Gen 32:24-26). You have been wrestling with ME oh Israel and you shall be crippled, you no go ever know true peace until you cry out BLESSED IS HE WHO COMES IN DI Name OF YAHUSHUA ha MASHIACH! Then you shall be blessed in ways exceedingly and abundantly more than you dare dream or ask for.

YAHUSHUA opened di eyes of di blind and scales fall from their eyes and dem praise YAHUSHUA for their eyes to see giving Praise and Glory to ME, YAHUVEH. You however oh Israel and Jerusalem, you deny say dis miracles come  from Heaven and so now you dey blind and get scales for your eyes and that na why you will be deceived by di son of satan wey some dey call di anti-messiah for 3 1/2 years you will be deceived and believe his false peace.

YAHUSHUA ha MASHIACH prove say HE be di SON of ME, YAHUVEH, as HE do signs wonders and miracles all over Jerusalem and Israel. Yet you persecute HIM for dis and you call di miracles, works of di devil. In di Great Tribulation di son of satan(anti-messiah) go come to you and deceive you with false signs, wonders and miracles and dem go be powers from satan becos you rejected di genuine one, you will be tricked by di fake signs, wonders and miracles. (Rev 13:11)

MY Two Witnesses go minister again as YAHUSHUA take do. MY Two Witnesses shadows go heal, restore and deliver and even di Holy wey die go arise. Food go multiply a thousand fold as di bread and di fishes take multiply when YAHUSHUA pray. What was done once will be done again in Jerusalem and to whoever and wherever I send MY Two Witnesses and dey receive dem and believe, dis miracles will be done in YAHUSHUA’s Name again. Dem go minister as YAHUSHUA take do and call judgment down on di Pharisees. As YAHUSHUA was sacrificed, MY Two Witnesses shall sacrifice demsef and be killed but 3 1/2 days later dem go rise from di dead as a sign say YAHUSHUA LIVES and RULES and REIGNS from Heaven and HE truly be di SON of ME, YAHUVEH. (Rev 11:3-13)

Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, as di heathen take fear YAHUSHUA, dem also scorn, mock, hate, persecute and make attempt on HIS life to kill HIM but dem fail many times na so too MY Two Witnesses go suffer di same fate. As YAHUSHUA curse di unfruitful fig tree and e dry up and die becos e no produce fruit, na so too MY Two Witnesses go curse di unfruitful works and sins of mankind.(Matt 21:18-20) Di unfruitful fig tree symbolize say di heathen mankind go also dry up and die as Words of Fire go come out of MY Two Witnesses mouths. Di enemies hate YAHUSHUA, dem hate Holiness and MY Two Witnesses and e go be like for di times of Elijah of Old (for Hebrew, Eliyahu) and MY enemies will be consumed with fire.

Make una Hear, oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, as YAHUSHUA meet di woman by di well in Samaria and give her di Living Water by that well and she receive di truth come go back to her city to share di good news and shared di Living Water of truth with others.(John 4) As YAHUSHUA say to di woman at di well go and drink of dis Living Water and you no go ever thirst again. MY SON YAHUSHUA na di Fountain of Life, YAHUSHUA na di Well of Living Water no one go fit come to ME, YAHUVEH, without drinking from YAHUSHUA Fountain of Life and without accepting YAHUSHUA Blood Sacrifice at Calvary.

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, I send una di Living Water again and again thru MY anointed vessels and yet una throw di Living Water back for my face. Una don persecute, beat, exile, imprisoned and killed MY Prophets. For dis reason I go send MY Two Witnesses to Jerusalem and dem go prophesy against di evils wey you oh Israel don do, wey una dey do and go do. MY Two Witnesses go seal up di sky and no rain go fall becos you refuse and reject di Living Water from YAHUSHUA. MY Two Witnesses go loose all di curses of Deut. 28 on those wey disobey and those wey deny say MY Beloved SON YAHUSHUA na ALMIGHTY GOD. MY Wrath go fall on everyone wey dey curse YAHUSHUA’s Name. MY unmerciful wrath go consume everyone wey carry di mark of di beast and worship di beast. (Rev 13:16-18)

Make una Hear, oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, becos una refuse to listen to MY Holy anointed prophets wey their only desire na to obey and serve ME, YAHUVEH, I dey send MY Two Witnesses wey go have di anointing like unto Moses and Elijah of Old (for Hebrew, Eliyahu). I go send dem to torment di one called di anti-messiah wey be di son of satan, di false prophet and all his servants wey go carry di mark of di beast, just as I use Moses to torment di evil Pharaoh, na so too I go use MY Two Witnesses.

As Moses pronounce curses and judgments on di Egyptians proving ME, YAHUVEH’s power, na so too e go be again, just as Moses divide di Red Sea so that di Israelites go pass over escaping their enemies, na so too e go be again. Only a faithful few wey remain shall be saved for Israel and only becos dem return back to Holiness, keeping di first laws wey ME, YAHUVEH, write, print am with MY own finger of authority and that dem go accept and worship MY SON YAHUSHUA as their MESSIAH and repent of their sins.

I go only protect those wey dey bless di Name of YAHUSHUA. He was born on dis earth from a Hebrew virgin woman without di seed of a man. Proving say YAHUSHUA na ME, YAHUVEH’s, only Begotten SON, was sent to earth with MY Words and authority. YAHUSHUA na di Living Torah and you deny HIM oh Israel, Jerusalem and di majority of di world, when you deny HIM you deny ME, YAHUVEH. I sent YAHUSHUA first to di Jews and then to di Gentiles to demonstrate MY Authority and Glory.

I go send forth MY Two Witnesses one go be man and one woman to demonstrate ME, YAHUVEH’s authority and to call down ME, YAHUVEH’s judgments and curses and to speak forth anointed words and show di Power wey dey for di Holy Sacred Names of ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA. Truly listen and hear oh Israel and Jerusalem, I no go bless Israel until you bless di NAMES of YAHUVEH and YAHUSHUA and until you bless di Holy Ones wey dey  come and minister in our NAMES.

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and people of dis earth, there is but only one way back to Heaven and na thru di Holy Sacrifice given for dis planet earth wey covers di sins of di people and na thru di Name and Blood of YAHUSHUA. You must accept HIM as ME, YAHUVEH’s only Begotten SON and your sins will be forgiven and washed away thru di only saving Blood of YAHUSHUA but then you must repent and turn away from your sins and obey. (John 14:6)

Make una Hear oh Israel, dis na di message wey MY Two Witnesses go speak forth. Any enemies of YAHUSHUA na enemy of ME, YAHUVEH, and if dem no repent there is no forgiveness for dis sin. Hell go be their next home.

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, there is no royal blood for dis earth except thru di shed Blood of YAHUSHUA ha MASHIACH. Only those wey their names don already dey written in di Lambs Book of Life (Rev 17:8) before di foundation of dis earth can claim di royal bloodline thru di royal blood of di KING of di UNIVERSE, KING of KINGS and LORD of LORDS, YAHUSHUA ha MASHIACH, KING of di Jews! All others wey dey call demsef say dem from royal earthly bloodline na imposters and there is nothing royal in dem. Only MY People wey dey grafted in thru di bloodline of YAHUSHUA ha MASHIACH dey Royal in MY eyes. Only YAHUSHUA’s Bride will be crowned in Heaven.

MY Two Witnesses na part of YAHUSHUA’s First Fruit Bride of Rev. 14. Di body wey dem go receive will be a Glorified Body. Just as YAHUSHUA walk invisible thru a crowd when di enemy try to kill HIM na so too MY Two Witnesses go do di same. (Luke 4:28-30)

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, just as satan could not keep YAHUSHUA dead and on di 3rd day YAHUSHUA rise again, na so too no matter wetin satan, di false prophet and satan son di anti-messiah go do, dem no go fit stop di resurrection of MY Two Witnesses from rising from di dead 3 1/2 days after their death. Satan no go fit stop people from all over di world from seeing and hearing about dis and surrendering their lives and souls and accepting YAHUSHUA as di only true MESSIAH di SON of ME, YAHUVEH.

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, just as YAHUSHUA take go up to Heaven in front of eye witnesses na so too MY Two Witnesses go, go up to Heaven before eye witnesses of dis world. for your airwaves worldwide,(for Television News) people go see. As it is written and those wey die in (Christ) YAHUSHUA MESSIAH go rise first, dis na secret before wey I don release thru dis prophet already. MY Two Witnesses along with MY other Holy children wey dem go kill at di same time, dis go be di dead wey go rise first to demonstrate di anointed power wey raise YAHUSHUA by MY hand. ME, YAHUVEH, go do am again for di world to see.

As e dey written for Bible, “Those wey dey alive wey remain go be caught up to meet YAHUSHUA in di air,” dis go include di Rev. 7 Bride. Di amount of di time wey dem go take to witnessing na 3 1/2 years dis nain dey symbolised as di 3 ½ days wey MY Two Witnesses dead bodi go take dey ground .  MY Two Witnesses bodies go liedown dead although, their Spirits go dey Heaven. 3 1/2 days later their Spirits will be called back into their bodies like YAHUSHUA and dem go rise from di dead and multitudes go bow down, repent and worship YAHUSHUA as MY SON and di true MESSIAH. (Rev 11)

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, as e dey written for Bible, di one una call John di Baptist prepared di way for MY SON YAHUSHUA na so e go be again as MY Elijah of New [in Hebrew, Eliyahu]go  prepare di way for di return of YAHUSHUA to rule and reign on earth like HE do for Heaven.

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, MY Two Witnesses no go only come with di anointing and Spirit like unto Moses but also go come with di anointing and Spirit like unto Elijah [in Hebrew, Eliyahu] . No weapon go fit stop dem whether e be spiritual, manmade, biological or chemical. Instead, whatever weapon people go use against dem that weapon go boomerang back unto di enemies. No harm go come to dem until di end of 3 1/2 years of dem witnessing and only when I allow dem to be killed for MY glory to prove say I go raise dem up again in 3 1/2 days.

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, just like ME, YAHUVEH, give Elijah of Old [in Hebrew, Eliyahu] di anointing to consume his enemies with fire na so too MY Two Witnesses go do di same. Just as YAHUSHUA take control and get di authority over di wind and di waves, na so too MY Two Witnesses go do di same. ME, YAHUVEH, go give MY Two Witnesses di power to disappear  to anywhere in di world. ME, YAHUVEH, go give dem di authority to protect MY Holy Sheep and Lambs, Rev. 7 Bride and to encourage di guests of di Marriage Supper of di Lamb wey go dey on di earth for that time.

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, how you go grind your teeth with anger oh enemies wey deny YAHUSHUA as di True MESSIAH. Know dis, MY Two Witnesses una no go dey able to keep dem out of your Synagogues, Temples and Churches just as you could not keep YAHUSHUA out of your Synagogues in times of old. MY Two Witnesses go appear to di enemies of YAHUSHUA showing ME, YAHUVEH’s Great anger. MY Two Witnesses go even walk into di anti-messiah bedroom, torment him in his own house and di false prophet house and he too no go escape di torment of MY Two Witnesses.

MY Two Witnesses go go wherever and to whoever any time wey I send dem. No enemy go dey able to keep dem out or to stop dem from tormenting and taunting di son of satan and di false prophet until 3 1/2 years of witnessing is over. I go send dem right into their bedrooms as dem dey sleep and when dem go try to rest and eat. ME, YAHUVEH, go persecute di enemies like Moses take do and nothing go stop dem, no alarms, no guards and no weapons go prosper against MY Two Witnesses until 3 1/2 years of witnessing is over and that na when their job is done. Di enemy no fit stop YAHUSHUA from ministering and from people to accepting di truths and no bodi go dey able to stop MY Two Witnesses also.

Make una Hear oh Israel, Jerusalem and di rest of di World, una no close di mouth of John di Baptizer until ME, YAHUVEH, allow am and only becos his job on earth of witnessing was done. Just as una no go fit close di mouth of MY Two Witnesses wey go continue to speak with di anointing like unto John di Baptist. MY Two Witnesses go Prophesy MY Judgment; call curses down as dem want and speak of wetin to come. Dem go rebuke with messages full of conviction and repentance and with anointing wey go dey even greater than John di Baptizer.

MY SON no go fit come as di Prince of Peace to Israel until many atrocities go take place and that na until after di fake one go come. When you pray for di Prince of Peace to come to Israel now, you no know di horror wey must first happen, but e go happen. E don begin to happen. Becos di train don already move wey no go fit stop.

(Elisabeth (Elisheva) see vision, I see two trains dey come and dem never realize am but dem go jam each other dem dey for di same track!)

I dey chastise Israel becos I love Israel but di trains go collide becos both of dem dey for di wrong track. Di Bride of YAHUSHUA dey feel wetin dey happen for physical Israel. Becos di Bride of YAHUSHUA na spiritual Israel. Physical Israel you will be blessed with Deut.28 blessings when you return to Holiness and obey ME, YAHUVEH, and di only way to do dis na when you accept YAHUSHUA as MESSIAH and admit say HE be your only Blood Sacrifice that was given at Calvary. Di blessings wey I don reserve na for Spiritual Israel and for all those wey love ME, obey ME and put ME first in their love and in their life, those wey obey MY Torah, those wey respect di sacredness of MY Holy Name and those wey receive YAHUSHUA as MESSIAH.

Dis na why you dey grieve as you see and you feel wetin dey happen fro Israel. Abraham dey constantly before MY face and dey say, “Wetin you go do with di children of Ishmael, do you not love di seed of my other son? Send your messenger to my seed and give dem a chance to believe.” Dis na why you dey weep for Lebanon abi dem no be di seed of Abraham? I have spiritual Israel wey dey for Lebanon wey don accept YAHUSHUA as MESSIAH.

I have MY Bride of YAHUSHUA for Lebanon. I have MY Bride for Iraq and Iran. I have MY Bride for Syria. Remember to pray for di Bride of YAHUSHUA no matter where she dey scattered around for dis world. I have MY Bride of YAHUSHUA for China, I have MY Bride of YAHUSHUA for Russia, I have MY Bride of YAHUSHUA for Hong Kong, I have MY Bride of YAHUSHUA for Australia I have MY Bride for America, Canada, Germany, France and Europe, I have dem scattered all over di world. I have MY Bride of YAHUSHUA for India, Indonesia, Africa, South America and all over di world.

Just becos say your countries label another country their enemy, no make am your enemy, becos di governments of dis world no be of ME. Dem no dey speak for ME, Dem do not respect ME and dem no want any part of ME. Your enemies na who I decree as your enemies. Di seed of satan na your enemy. Who be di seed of satan na all those wey their names NO dey for di Lambs Book of Life. Dem no belong to ME since when dem born dem for dis earth.

(she dey Pray loud for English Holy, Holy, Holy)

Oh Israel, oh Jerusalem, I weep and I wail over you. You get di form of Godliness but where di Godliness wey dey inside? You want di world to have mercy on you, but where is your mercy oh Israel? You get di right to defend yoursef but you don cross di line when you pick up di weapons of biological and chemical warfare. I no dey anywhere for dis battles, una no dey call on ME, YAHUVEH, for help, you try to do am by your own hand using di weapons of another land. When you use biological and chemical warfare you punish your enemies far more than wey I ever allow. Beware for you shall reap di whirlwind of ME, YAHUVEH’s wrath as wetin you send go come back for your face. Di countries wey give you dis weapons go reap di same reward.

When I send out MY Two Witnesses, I send dem out to both of di seed of Abraham. I no only send dem out to di Tribe of Judah but all of di Israelites, Arabs and Gentile nations go hear. Wetin dem speak for Israel dem go broadcast am for di airwaves and newspapers all over di world. I chose dis time with di technology of dis time, becos MY words people go dey heard all over di world becos there is no other time like dis.

Satan don use dis technology to further his agenda but I dey use di technology to fast-forward MY agenda. Oh, where are di lamentations? Where di weeping and wailing? Why be say people go just shake their heads and say, “Isn’t that too bad?” Why be say spiritual Israel no dey rise up? Why dem no dey pray becos I till get a few holy seed for Lebanon? What if dem be your Babies? What if dem be your wives, your husbands, your loved ones, your families and your neighbors? What if that na your houses? madness don take him seat in di Governments.

Oh Israel, oh Jerusalem, your people dey weep and wail, dem dey run in confusion, I weep over all. E go only be when ME,YAHUSHUA, come wey there will be peace between di Brothers, di peace on Abraham seed. Until that time as e always be both of una go continue to try to wipe each other off di face of di earth. When di false peace come di anger and di hatred go still dey there. There is no peace until di PRINCE OF PEACE GO COME (Isa 9:6) and na ME, YAHUSHUA ha MASHIACH!

* * * * * * *

As I take speak am, na so we write am wey dis Child of YAHUSHUA
Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)  receive on 8/27/06

There was a personal crisis wey come into my life as di enemy hit my family in a different way. Dis happen to keep me from releasing dis prophecy. Dis prophecy come to me for 2 parts but I no go release di 2nd part for now, YAHUVEH say very much spiritual meat dey here to digest, wey be revelations from Heaven. I no understand why dis word concerning di job of di Two Witnesses dey come to me. There is a price to pay for a prophet to receive dis kind of revelations from Heaven, and di spiritual attacks have been very high during dis time, but we have di VICTORY in di name of YAHUSHUA.

* * * * * * *