Prophecy 68
“Mock Me (YAHUVEH) If You Dare!”

Given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu).
December 26, 2002

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva],make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth.Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA,your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH,your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago.Na by di SHKHINYAH GLORY Wind wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  (Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

MY beloved Children, I no dey vex with una. I dey feel sorrow becos of di pain wey dis world dey cos ME. First I go dey silent and I go sorrow then you go see MY Wrath unleash.

   A word of warning to MY enemies, so you dare to mock ME (YAHUVEH), so you dare to mock di 2nd coming of YAHUSHUA? Go ahead and mock and you go see MY wrath come down in such a way e go be like a violent down pour, a storm, a sudden strong wind and truly e go sweep di dirty(evil people) away. I go bring waves as di waves of ungodliness don reach Heaven, di waves of di ocean and seas go roar, di storms na from Heaven no be like anything any bodi don see. Hail and brimstone go once again fall jus like I show you for your dream, becos when di meteors start to fall, dem go explode in fire. Jus like for di dream wey I give you dis night, rain of ice go come down like wetin no bodi don see before combine with winds. E go scatter windows. Di coldness wey dem don show against ME di Creator against MY Son YAHUSHUA I go pour out that same ice back upon dem.

Ice go fall from Heaven. Fire go fall from Heaven. Di earth go vibrate and shake. Blindness go strike man as dem don become spiritually blind, as dem don become blinded to di truth and dem refused di truth, as dem don become blinded to Holiness. Jus as in di days of Sodom and Gomorrah once again brimstone and hail and blindness go come upon dem. So go ahead, I dare you to mock. I dey speak to MY enemies now; you dey only dig to your own level, to di pit of di fire of hell wey dey wait for you, to di level wey you go descend. With every word wey come out of your mouth wey you take mock and scoff, wey reject MY mercy and MY love wey reject MY Son YAHUSHUA. Go ahead and mock, you enemies of MINE wey defile MY Shabbat. You wey dey mock di Shabbat, you wey dey mock di Jewish people, you wey hate Israel, those wey betray Israel, those wey betray MY own Chosen Ones, MY Babies, MY Bride and MY Elect. Go ahead and mock.

Na ME, YAHUVEH, I will have di last laugh. You don arouse MY hot anger, you don arouse MY wrath. You say you go play God with di knowledge wey I don give you. You create man in man’s own image, when MY Word say you were created in MY image. You dey play your games with di weather. Now I go show you di creator of that weather. Your own clones go turn against you. Your own inventions go turn against you. Any weapon wey you try to use against MY Children go boomerang back upon you. Becos I dey judge Sodom and Gomorrah again, I dey look over di face of dis world. I know which ones MY angels don seal and dis things no go fall upon dem.

Woe be unto di rest of una. You better fall on your knees now and repent while there is yet time. Call upon di Name of YAHUSHUA MY Beloved Son, cry out for mercy for di evil wey you don do. Oh but you dis hard hearted generation, una wey be reprobates, you wey think say you dey so rich and you dey full of yoursef , fame and glory. You dey glorify yoursef in your own image. Only in di mirror you dey check out your own beauty. I go take away your beauty. I go take away your fame and fortune. I be di only one wey dey promote and I be di only one wey dey demote. I AM YAHUVEH and I AM di beginning and di end. I no get beginning and I no get end.

But na to MY enemies I dey speak, I know your beginnings and I know your end. So go ahead and dare to offend. Shake your fists at ME and complain. I go laugh in your face. Na only becos of di mercy and di love wey I don show thru MY Son YAHUSHUA wey make I never erase di entire human race. But I get those wey I call MY Children, those wey dey weep before ME, those wey dey intercede before ME, those wey dey try their best to obey ME, and honor ME. Na for dis ones wey I never destroy di entire human race. MY Son dey come again! You no need to only depend on wetin people dey talk, read MY Word, study MY Words. Those wey truly love ME, MY Son YAHUSHUA love dem too. Those wey truly desire ME, those MY YAHUSHUA truly desires. Dis MY beloved children na your sisters and your brothers.

Na dis thing una get in common and dis na di reason wey una suppose to have love for one another. E no dey important wetin your name be on earth. Una go recognize each other by di anointing of di Spirit, you go see di love of YAHUSHUA for each other eyes and you go recognize di anointing of di RUACH ha KODESH inside. I dey separate di sheep from di goats and I dey remove di masks of di goats, as dem been dey pretend as a sheep or a lamb, dis na part of separating di chaff from di wheat, becos di chaff dey only good for burning!

End of prophecy

As I take hear am na so I take write am down on
Dec. 26, 2002 by Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)

* * * * * * *

(Below na personal prophecy wey YAHUVEH also speak at di same time and di dream wey YAHUVEH dey talk about for dis prophecy I write am below. Both di dream and prophecy come on di same day, for di same time and di circumstances wey dis prophetic message take come thru. I hold dis prophecy back as instructed and I go post am on December 31, 2002. YAHUVEH also reveal a surprise to us as HE don give us di new command to take dis Ministry by RV (recreational vehicle or bus) to di people and ask dem if dem go be a part of dis financial miracle, so that we can travel more freely and touch more people one on one. Those wey help us will be blessed.)

PERSONAL PROPHECY

Dis Message no dey yet ready to be loosed (12/26/02) Becos I get more to say. MY Darling Daughter you go know when to loose dis Message, I go confirm am when you pray. Today becos you beg and seek to hear MY voice, I break MY silence and I speak.

I am so well pleased with you [Bride of YAHUSHUA], never you think say you no be di best in MY eyes. When you speak and protect MY Daughter in a way wey I don anoint you, di devil no get any choice but to run. I go speak forth a Message and e go come from MY woman servant once again but there is a time and there is a season.

I dey speak thru Elisabeth [Elisheva], keep her focused on di question wey she asked dis day.

(I been dey seek an answer to why Dr. Richard die before he was raptured becos all dis time I been believe and himsef believe say he go live to see di rapture becos YAHUSHUA tell am dis before he send am back to earth di first time we he die and was resurrected. I beg for answer, becos me like others believe Dr. Eby would be used as a sign of di soon coming catching away wey we dey call di rapture.)

No think say you dey so many weeks behind getting things done. Becos when I put am for your heart, then you go know say you are to do di thing wey I tell you to do. When I put am on MY Daughter heart to intercede and to pray and not to study di Torah today, then know say na ME dey speak thru her, speak to her, becos I get much to say. You ask dis question about MY Son, Dr. Eby as dis world know him name. I go reveal more and I go make am very plain. You are to join together with others wey dey anointed, speak to dem today by phone and get intercession going so di anointing will be stirred up and e go dey confirmed in jus more than one. In di mouth of two or three witnesses e go dey established.

I am going to give you a Temple MY Children, and e go be a Temple on wheels. You go dey able to travel more freely and go to places wey I call you to go. But I truly don choose your RV home and e no go only dey functional e go dey beautiful so that you can say to others, see di miracles wey YAHUVEH don do. Make you no put ME in a box; no say wetin I go fit do and no fit do. That na jus like Elisabeth [Elisheva] counting di dollars wey dis rental car don cost. In one day I put am upon another of MY son heart (Matt C.) to send that $60.00. So you see MY Children, becos you dey so faithful to ME, becos you obey ME, becos Elisabeth [Elisheva] you hear MY voice, together MY Children, you no go miss am. You go dey in agreement. So listen to MY voice, when I tell you to make a [phone] call you make a call. No worry about which day e be. (Shabbat) You jus make sure say you obey.

Elisabeth [Elisheva] you are to intercede and continue to pray. You are to continue to seek MY face. You are to listen and obey becos you no know no di weapons wey dem dey fire and aim at your bodi of flesh, so that na why MY Child I command you to rest. Save your energy MY Daughter to intercede for today once again you  stand in di gap and you remind ME why, as MY other children also dey cry out for mercy on dis human race. That na why I never erase every human being out of di face of dis earth, Becos I still get MY remnant(MY few Holy people) and I go always have MY few Holy ones, those wey truly dey love and serve ME and put ME first, those wey dey cry out in di Name of YAHUSHUA, dis na di people wey I go hear again. So di Newest Message wey MY Daughter go put di title as “MOCK ME IF YOU DARE!” But no be yet di time to release dis word becos I get much more to  talk as you intercede and seek ME when you pray.

(I dey laugh for dis part becos I no dey feel my hands becos of di heavy anointing becos I press my hand together as dis prophetic message come forth) YAH dey tell me make I share everything wey HE tell me make I no remove anything becos  e go help people to understand and realize say I no different than anyone else. )

Dis na for December 26, 2002, I say I go beat on Heaven’s door until I get answer why Dr. Eby die since all dis time I dey watch am and I have been saved for 27 years. When I first hear di name of Dr. Eby I really believe say he no go die and say he will be carried up in di rapture. I go dey there also. So when he die on dis day, Me jus like others questioned our Heavenly Father to know di reason why? I say I go beat on Heaven’s door that day and intercede and pray until I get answer. Message don already fill My email box and I know say di RUACH dey tell me that more email go come. Dem go dey expect me to give dem di answer and Me never even get di answer for mysef. But YAHUVEH no give me di answer on Dec. 26 2002. Instead YAHUVEH tell me to wait and pray and intercede say HE go give me di answer.

Below na di dream wey I receive about Hail(ice) and Blindness. Dis dream come on Dec. 26 also and YAHUVEH mention am for dis prophecy 68. Five prophecies don come forth for di month of Dec. and 2 prophetic warning dreams. Dis start on di 1st day of Dec. Hanukkah, and now di last na for di last day of di year. Dec. 31. I receive a new one today. I go add am now to di notes of Dec. 26 and you can read am separately. Many people dey wonder wetin Prophecy 70 go be like already. Only time go tell if I am given dis honor to hear a message again.

* * * * * * *

Dec. 26 2002

I get dis dream where I dey very tall like tall buildings. I see men all around, I no remember if see any women in di room. All around I hear loud cry as one after another of di men blindness strike dem. For around me I hear di cry of “Help me I am blind!” Nothing anybody fit do. I was not afraid becos I no blind. Then di dream jump to another scene where I see Ice blocks of all sizes dey crash into windows and very big ice blocks dey fall from di sky with breeze of about 160 kilometer per hour along with di hail(ice) wey dey fall. Dis no be like any thing wey we don see before becos e no small like golf size ice and there was so much and e be like say na ice rocks dey fall from di sky very violent. For di dream I dey try to drive thru dis storm on a road wey hardly any cars dey. Di breeze was so strong and e go jus spin cars out of control throw dem into oncoming cars if any dey around. Di hail(ice rocks) go break car windshields and crash thru di roofs of cars. I dey drive on di right side of di road and di breeze spin my car for circle, there was an oncoming car wey dey also spin out of control for di left lane, my car spin out of control but we no hit each other, and even di car wey dey for front of me we no hit each other, Becos I scream Jesus help! (I confess when I experience car accidents before I no call YAHUSHUA becos e jus sound too long to pronounce I revert back to when I was first saved and wen I call Jesus help. Di car stop to spin and I was safe.)

After I wake up I seek YAHUSHUA for the meaning of dis dream. He tell me sayYAHUVEH go judge di nations and states again with fire and brimstone and hail(ice rocks wey dey fall from Heaven) and blindness. Jus like he take do with Sodom and Gomorrah YAHUVEH go do am again. Only those wey dey call out on YAHUSHUA will be protected. Blindness come to di homosexuals wey dey insist on having sex with di 2 angels in Sodom and Gomorrah according to di Bible. I no no who else di blind men symbolize, e fit also mean spiritually as well as physically. Di organized churches for di most part dey blind. Di warning dream on Dec. 19 na of meteors(Fire rocks wey dey fall from Heaven) wey come as a shower and burst into flames of fire. Fire fall from di sky, and now di dream na Hail wey be ice, and di missile dream after you put dem all together then you understand di wrath of YAHUVEH to di ungodly and disobedient.

I don record dis dream to di best of how I remember. Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)

* * * * * * *