Prophecy 44
Arise Watchmen On DI Wall!

Na under di anointing nain
Rev. Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu) take speak dis prophecy on
October 8,1998.

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand. Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, nain dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, nain dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.    

Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Prophecy Begins

For I dey call out many people now, says YAHUVEH. Dis na MY vessels wey don submit demsef, dem be instruments wey don submit demsef for MY supernatural army wey go bring unity to MY body. Dem go bring order.Becos now na di time, says YAHUVEH, now na di time for MY watchmen. Now na di time for those wey don waka for di midnight hours. Arise, arise, arise, oh sleeping people. Arise now, arise now, arise now, and proclaim di victory. A army fearsome and strong, a army wey go make di enemy to shake and tremble with fear and terror as dem go hear di noise of how una take gather together and of how una take march thru di land. Continue to call out and proclaim and preach di gospel of salvation.

Join in your spiritual feeding and shake di sleep commot from your eyes and hear di voices of MY watchmen. Becos na dem wey I don give dis, MY Word, for una to arise, arise, arise, says YAHUVEH do di thing wey dey precious for MY Eyes. Do di thing wey go bring ME Glory and di thing wey go bring about a great harvest of souls and I go know say you truly love ME. Arise, arise, arise and wake up to di truth and wrap yoursef with di truth and walk in that truth for MY everlasting plan don reveal among una and there is still much preparation to be made and do wetin I don create you to do.

(MY Heavenly Father speak to me today and HE say dis things to me today, so clearly, so clear. Becos there are cloudy storm wey dey rise in di hearts of men wey di natural eyes no go fit see  and as di war cloud dey gather over di sky, and as di thunder and di lightning from di power of those war clouds dey continue to reveal demsef from inside.)

You dey hear and you dey see, make you no fear, says YAHUVEH, of di things wey come from ME. So prepare your hearts, all dis things dey set into motion go reveal demsef, says di Almighty YAHUVEH. I don very well prepare MY called out ones. E no be your responsibility to create di truth. Na only your responsibility to respond to MY truth, says di Lord your God. For you shall discern di true from di false and you go have peace inside your hearts say those things wey be from ME na for your good and you go discern those things wey dey false and wey di enemy don send and his followers don send to deceive you. Use carefulness; no stop your watchfulness.

* * * * * * *