Prophecy 43 – Part 2
WHO YOU CHOOSE MAKE E BE YOUR POTTER?
ME, YAHUVEH, OR HARRY POTTER!

Na Apostle Elisabeth Sherrie Elijah receive dis prophecy (Elisheva Eliyahu)
for November 15, 2001

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand. Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, nain dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, nain dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.    

Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

DANGER! WARNING! Make  you No allow your Children to watch di Harry Potter movies! Christian parents una dey allow una children to watch Harry Potter? Dem dey exposed your children to very great EVIL thru dis Movies! WARNING!!! Dis dey very urgent, if you know anyone with children, give dem dis Prophecy to read about Harry Potter. Who go dey willing to stand outside di movie theatres and warn di people! Boycott di movie theatres and  their sponsors!

Please copy dis prophecy and warn people, just no change anything wey dey for dis Word.
Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu).

* * * * * * *

Dis prophecy come to me after di dream wey I receive from a brand new baby believer in YAHUSHUA, na 16 years old from Singapore, wey I dey call Truthseeker. YAHUSHUA love you Truthseeker, and also with Me. Your dream stirred up di anointing for inside me. People, why be say dis dream no come from somebody in America e be like say Singapore, Hong Kong, Malaysia, dey listen and get saved in greater amount according to di emails wey I dey receive.

Deut 18:10-12
Make sure say no person wey dey  force his son or daughter to pass thru di fire, or wey dey use witchcraft, or be observer of times, or be witch doctor, or be witch, or dey use charm, or dey consult with familiar spirits, or be wizard, or be magician go dey among my people. Becos everybody wey dey do dis things dem be abomination unto YAHUVEH: and becos of dis abominations YAHUVEH your Elohim dey drive dem out from before thee.

Revelation 21:8
But di fearful, and unbelieving and di abominable, and murderers, and prostitutes lovers, and magicians, and idol worshippers, and all liars, go have their own part in di Lake of Fire wey dey burn with fire and brimstone: wey be di  second death.

Exodus 22:18
Thou shall not allow a witch to live.

Micah 5:12
And I go cut off witchcrafts out of your hand; and you no go get people wey be witch doctors:

Deuteronomy 18:14
Becos dis nations, wey you dey possess, dey listen to observers of times, and to people wey dey use demon power: but as for you, YAHUVEH your Elohim  no permit you to do dis thing.

2 Kings 17:17
And dem force their sons and their daughters to pass thru di fire, and dem use witchcraft and magic, and sell demsef, to do evil in di sight of YAHWEH, to provoke HIM to anger.

2 Kings 21:6
And he make his son pass thru di fire, and observe times, and use magic, and he practice with  familiar spirits and wizards: he do very much wickedness in di sight of YAHUVEH to provoke HIM to anger.

Leviticus 18:21 And thou shall not allow any of your children to pass thru di fire to Molech.

2 Chronicles 33:6
And he force his children to pass thru di fire in di valley of di son of Himmon: also he observed times, and used magic, and use witchcraft, and practice with a familiar spirit, and with wizards: he do very much evil in di sight of YAHUVEH, to provoke HIM to anger.

Matthew 18:5-7
But whoever shall offend one of dis little ones wey believe in me, e go be better for am say dem go hang grinding stone for him neck, and throw am into di sea.

Luke 17:1-3
THEN HE say to di disciples, E dey impossible say offences no go come: but woe unto di person, wey dey bring offence! E go dey better for that person  make dem tie grinding stone for him neck, and cast am into di sea, than make him offend one of dis little ones.

* * * * * * *

WHO YOU CHOOSE MAKE E BE YOUR POTTER…
ME, YAHUVEH, OR HARRY POTTER!

Foolish ones, oh foolish ones! Those wey ME, YAHUSHUA, desire to call MINE , even though you dey call yoursef MINE and yet why you dey say you love ME and no dey obey ME? How can you call ME Lord and yet you dey disobey MY scriptures. Since when wey be say di servant dey rule di Master? You no dey even hear MY still small voice when I warn of di dangers of magic and demonic possessions thru wetin your eyes see and your ears hear. Becos of dis, your children dey become possess thru di films, books, and video games wey bey steady diet of occult, magic, demonism, satanism and shamanism.

Repent today! Turn away from dis evil. Turn your children instead to ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA. Na We alone  be di potter of di clay of you and your children. They are to be molded in our image no be for Harry Potter image. Even di name dem choose am for a purpose, to mold your children into di image of di fictional character of Harry Potter. Does not MY Scriptures say, “Train up a child in di way wey him go go and when he grow old he no go depart from am.” Wetin you dey do? Oh foolish ones. You dey train your children up to be magicians, shamans, witches and Satanists. Oh what a price you go pay when your own children go turn on you with evil spirits wey go make you wonder ask where your children go? You go look at dem with eyes of wonder, becos your innocent babies go dey possessed with every kind of evil spirit.

Why I go allow dis innocent children to be harmed in dis way, where their very soul go dey for danger? Becos I give di parents choice, even di non believers know better, becos dem know say children no supposed to get occult powers. Dem realize say witchcraft na sin and yet for your own televisions and movies dem dey promote dis, even to di children thru sitcoms. You boycott di television stations you boycott di advertisers? NO, you remain silent and no warn no one. Does not MY Word say, ‘Make a witch burn in hell and di Lake of Fire,’ dem go burn after dem die if dem no repent. Oh MY foolish ones dis na di price wey you go pay.

Dem go burn in hell and di Lake of Fire after dem die, if dem no repent. Oh MY foolish ones. Dis na di price wey you go pay for taking your children to di Harry Potter film, dem shall become possessed. Dem go turn on you in rebellion, in ways wey you never ever dream of. Becos dis na your own innocent children, wey rely on you to teach dem right from wrong, yet you encourage dem to watch and study witchcraft, satanism, shamanism, demonism, for wetin you see as just ordinary movie or ordinary books full of enjoyment and yet di same dey feed dem dis diet of evil, knowing say na evil and laughing at dis evil. How can you call yoursef  Mother and Father?

Parents protect MY innocent children. Their minds dey so easy to bend and instead of planting good, you allow dis evil Harry Potter to plant evil inside your children minds, bodies, spirits, and souls, as dem dey seek dis demonic powers and yes many go receive dis power. Wetin you dey laugh about na reality. There are some wey dey possessed with demons wey can use some of dis evil powers and di power no only dey for MY Holy Word but also di evil ones know say there is power in demonic chants and words. Dis words and actions you go find for Harry Potter books and films. Parents you dey responsible for feeding your children food, both physical and spiritual food. You no dey feed your children poison, so why you  go allow satan to feed your children poison? Poison to your soul and your children mind, body, spirit and soul.

Satan dey mock and laughs at una wey be parents, as you lift di spoon to feed your children souls dis evil. E dey more evil now than before, for any film, or for any of di children’s books. Dem cast magic spell by all dis evil reprobate worker of satan, wey dey take pride for her unholy act of witchcraft. Dem don cast evil magic spell on everything wey she don write and di film also get di evil magic spell wey dey make any person wey dey watch to think oh dis go be so wonderful, if I get dis kind of power? Dis thing dey open person up to di mind-controlling, mind-bending, mind-changing, power hungry, anti-christ spirit. Walk-in spirits go easily walk into all di people wey open up dis door to their mind, body spirit and soul. Dem don put magic spells, chants and incantations put on all di books and film and everything wey has do with Harry Potter, to make people to dey hungry to know more of di occult and di hunger to rebel and di magic spells to mock ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA and everybody wey dey holy and to accept wetin I, YAHUVEH, don call unholy. To accept wetin MY Holy Scriptures forbid.

Your children dey pay and go pay a price, becos you foolish parents don allow dis evil into una house, and una allow dis evil into their ears and allow dem to watch am with their eyes. Shame on all of una wey do dis atrocities and call demsef MINE. Repent today and turn away from dis evil or no call yoursef MINE anymore becos I no go even know you. Be warned, you never yet understand? Pray and discern whether dis na di truth and whether e line up with MY Holy Scriptures. If e no line up with my scripture, then no listen to dis apostle wey dey warn say I dey speak thru her now. Encouraging your children to read and watch films wey dey glorify di occult na abomination unto ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA! Listen up, learn and discern.

Dis na di same as forcing your children to go thru di fire for human sacrifice. Dis na di same as sacrificing your children to Molech. Make you no dare think say you be MINE when you dey sacrifice MY Children, no be only for abortions, but now una dey even dey put dem in danger by sacrificing their souls? Una dey Open their souls and spirits up to everything wey I call unholy.  You never yet realize say satan want your children souls? Satan want to bring rebellion to your house and di spirit of rebellion, murder, thiefs, and disobedience, oh dis comes with di different ages, and di environments of di children just becos say dem dey live in dis wicked world. How much more evil e go be for all di people wey dey allow their children to feed on dis evil? Dem encourage dis evil, and yet dey call demsef Christians or Jews. Even those wey dey worship a heathen god like Buddha or Allah, be warned when I say all children, dis means you also.

ME, YAHUVEH, give you children with a command to protect your little ones. ME, YAHUVEH, put di mother instinct for inside di mothers of children to protect dem even if e go cost dem their lives. Fathers, I don put dis for inside you too, to provide and take care and protect your families. How can you do dis atrocity for MY eyes. Where all di spiritual leaders to warn about dis film and di books wey just dey increase di  evil with every new edition? You no realize wetin satan dey do and go dey do to a greater degree? Use your eye take picture as demon possessions of children for all over di world, for every language, where even di parents go fear their own children, picture dis children and anybody wey watch dis movie as dem go become possessed and their hearts go become colder and colder and their faith go die out like charcoal fire becos of di spirit of rebellion to laugh at wetin I don forbid.

You parents wey dey put your children soul for danger like dis, no even realize how angry you don make ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA to be. It is better say make dem hang grinding stone  around your neck and make dem throw you inside river. No expect ME to hear your prayers, when you cry out to ME when you see di children become possess. You gree listen to ME when I warn you with MY RUACH ha KODESH? I go hear your prayers to di amount wey you don listen to ME to warn you make you no let your children to be entertained with wetin I don forbid make you no study, or to take part for teachings of devils. Don’t be surprised say when your little ones start to dey practice to throw magic spells. Don’t be surprised when your little ones turn on you in hatred. Don’t be surprised, becos na you feed dem all dis evil books wey teach everything against di only Good Book.

How many of una wey be parents dey buy things for your children and no even realize say na witchcraft, with magic spells wey hin root na from satanism and e dey make you to spend money by giving your money to satan and his works each time wey you do dis thing. Don’t be surprised when di spirit of poverty come to you for doing dis thing. Don’t be surprised when children start to kill each other and sacrificing their own animals. Don’t be surprised when demons waka enter your children and you no longer have a child wey go gree to read di Bible or even hear di Name of the God wey you dey serve; when your child go hate everything wey dey Holy.

I tell you dis: ME, YAHUVEH, I be di POTTER, you and your children supposed to be MY clay. ME, YAHUVEH, nain supposed to mold you, not Harry Potter. Di growth of dis evil potter wey go plant inside your minds and inside di mind of your children, say to throw magic spells no be bad thing and to control and manipute others na something to do. Beware, becos your children all over di world, for every language go become possessed, and if you no see am right away, don’t be surprised, becos some demonic possessions no dey show up right away, becos di demons go just stay quiet and dey wait. You no realize how many souls will be sacrificed to satan becos of dis occult film and all di books wey you feed your children? You no realize how dis dey real and those wey dey practice di black arts, shamanism, satanism, no dey laugh at dis film and books, dem dey laugh at all di people wey no dey take dis thing seriously.

Forbid to take your children to dis film or to read di books. If you get di books for house or for your grandchildren house, pray over di books, cast di curses commoth from di books, plead di Blood of YAHUSHUA over di books, ask for MY forgiveness if you don sin and allow dis to happen in any way. Come to ME in di name of YAHUSHUA and burn those books. Boycott di schools wey dey allow dis to be part of their curriculum. Make sure dem fire di teachers if dem insist to teach your children witchcraft. Forbid dem to feed your children anymore of dis evil. Di teachers go regret dis. Di schools wey take part for dis thing go regret am, becos if dem think say dem get problems now with di students, just wait until wetin di children watch for Harry Potter movie and books dem start to use am to experiment on di teachers and parents. Satan go give your children di occult powers to do harm. Your own children go become your worst enemies.

Repent today! Turn away from dis evil. Instead make you turn your children to ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA. Na We alone supposed be di potter of you and your children clay. Dem are to be molded in our image, no be for Harry Potter image. Even di name was chosen for a purpose, to mold your children into di image of di fictional character of Harry Potter. Demonic spirits dey wait and watch to see who go open demsef up to demonic possessions thru di gates of dis movie and di books. Nothing good to learn or gain thru di books or movie, so why you dey endanger MY precious little ones? Demons dey waka enter into your children. Children go waka enter theaters, but e no go be your children go waka come out.

You have been warned! You no go notice am right away. Some go notice am and some parents no go notice, but I tell you your children will be taken over, little by little, the more as dem dey feed on dis addiction wey dey going around di world, no be for drug or sex but for di feeding frenzy of learning and studying and practicing di black arts of di occult, wey dey prepare di world for di anti-christ system to be very easy to accept. Remember say di anti-christ go do di things wey your children read for Harry Potter books and films and he go even do more.

Parents wey dey call demsef MINE and no repent and warn others, know dis: becos of your rebellion ME, YAHUVEH, go turn a deaf ear when you pray, and dare to face ME after I don warn you and when you come dey cry to ME and I go say, “I warn you” and now you shall feed on MY wrath and you no go like di taste of am. All of Heaven dey watch and you dey surrounded with a cloud of witnesses. How many of una after dis prophetic warning go care enough and warn others. You dey accountable for wetin you know. No say you no know, becos even before I speak out of dis apostle of mine, you know say I demand you to protect your children and how you go say dis na protecting your children. America, where is your repentance before ME? Why you dey continue to heap up judgments upon your head? I dey hear prayers going forth in YAHUSHUA’s Name, yet where di turning away of sin?

England, you don bring judgment from Heaven upon you. Repent, becos dis wickedness come from your own land. England, you no do anything to stop am. Why? How can MY spiritual leaders stay silent? Why be say di churches no dey put out di warnings for newspapers and for radio and television? Why MY Children no dey boycot every store and product wey dey promotes dis witchcraft and demon possessions? Why di parents no dey protest, and refuse to allow di schools to feed your children wetin you no feed your children.

Beware di more dem continue to eat dis evil; di more di demonic possessions go become more noticable. Parents, is dis really worth your children souls? All di people wey feed on dis diet of di occult, is dis worth your souls? Depart from ME, ye workers of iniquity, ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA no go know you, if you no repent and turn back to Holiness, and repent for staying silent. Where MY other apostles and prophets wey supposed to dey sound di trumpet warning of di danger to mind, body, spirit and soul, for everybody wey watch dis film, and read di books? You have been warned. Now na your choice.

Who you choose to be your potter ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA or Harry Potter? That film and books go only mold you and your children into everything wey dey unholy. Na your choice. No say I no send MY Apostles and Prophets to warn before I send MY judgment. Even di ground dey shake in fear becos of di anger of ME, YAHUVEH. How much more you supposed fear wey I command to work out your own salvation with fear and trembling. I dey advice you now dey tell you say di blood of di children all over di world go dey for your hands, becos you no warn dem.

Di blood of di unborn babies wey dem don abort, torture, use for medical experiments, for cosmetics wey dem don sacrifice for selfish reasons dey on your hands. There is no good reason to kill innocent babies. Everbody wey do dis go answer to ME on Judgment Day, if dem no repent and warn others. Now you get a new blood of di children for your hands, all becos say you refuse to warn others make dem feed your children di occult as a food for your mind, body, spirit, and soul. Harry Potter go mold your children into witches, warlocks, and Satanists wey dey throw magic spells that go terrify you. Houses go become possessed with every kind of evil spirit. Plead di Blood of YAHUSHUA even on di advertisements and speak up to even di television wey dey endanger your children with di advertisements wey dey release demonic spirits. Speak up to your radio stations. Boycott those wey refuse to listen. Hit dem where e go pain, their bank accounts. Speak up to di schools wey dey promote dis thing. Fight di spirit of di anti-christ, before it is too late.

Ask yoursef, your public school go gree take di time to read di Holy Scriptures for classroom? Would your public schools take your children to see a passion play of di life of YAHUSHUA? Then why you dey allow satan to teach your children? Get dem out of di dens of di anti-christ before e go too late. Di children of di world dem dey dress dem now  just as surely as  dem take dey dress hair, therefore di name Harry Potter. Dem go show dis film, worldwide and yet make una no receive am as di kind of raising wey you want your children to have, or even yoursef.

Satanists don do many planning to take over di minds, bodies, spirits and souls of you and your children, using di vessel wey dey promote dis evil. Wetin  you go do about am? Na your choice, becos I no go help anybody wey get di ability and di knowledge to warn, and yet endanger their children or di children of others by remaining silent. Di walk-in spirits dey wait in quiet for your children, and also yoursef. Wetin be di price of your soul? Wetin be di price of your children souls? ME, YAHUVEH, don tell MY Daughter Elisabeth [Elisheva] to warn you. How many go listen? Warn even di heathen or di blood go dey for your hands! There are those wey get di knowledge to know how to arrange boycotts. No remain silent any longer or di blood is on your hands. Dis na only one vessel of clay wey I don mold to speak out dis warnings, now wetin  you go do to help her get dis message to di masses of people?

As di Prophet take prophecy am nain dem write am down on 11/15/01 4:25 p.m.

In YAHUVEH’s and YAHUSHUA’s SERVICE,
Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)

* * * * * * *