Prophecy 41
Will MY Real Bride Please Stand Up!

Dis prophecy come thru Rev Elisabeth Sherrie Elijah
(Elisheva Eliyahu)for September 17, 2000

As I dey speak and write Prophecy 41 on September 17, 2000, I hear 3 policemen surround my house with dis white car wey no get any number park for front of my house. I recognize di chief of police wey dey knock on my door. My son see another one for di back and another one for di side of di house. He say him come becos of four times wey dem don call police from that house address. I tell am say I wonder O, becos nobody dey for house except for me and my son and at di time I dey on di telephone with one of my friend. Dis actually happen few minutes after I hang up di phone after I finish reading di prophecy of “Make you no join di fake Bride”. Please pray for my protection.

Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu).

* * * * * * *

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand. Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, nain dis take come out.Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, nain dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Windwey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  (Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEHarise against HIS People, till there was no remedy.  —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Prophecy Begins

MY Bride no go fit enter in without di sweet smell of MY anointing. You no go fit over do di sweet smell of MY anointing. You supposed to seek for dis higher anointing. Make una know say  no man or woman go fit give you dis anointing; only MY Sweet RUACH ha KODESH go fit clean you with di sweet perfume of MY anointing wey dey reserve for MY Bride. Prepare to go home and soak yoursef in di power in di RUACH ha KODESH anointing. Wear your wedding gown. Na MY robe of righteousness. I wear a crown of thorns. You go wear like a tiara a crown of MY glory that is placed upon your head. As Esther take prepare herself for di king, you dey preparing yoursef for Di KING of KINGS, Di LORD of LORDS, YOUR LORD GOD ALMIGHTY YAHUSHUA  NA MY NAME AND I AM YOUR SOON COMING BRIDEGROOM!

As dem take dey send out wedding announcement and invitations, na so ME too send out MY announcement by Gabriel as he blow di Trumpet, and only those wey be MY Bride go hear di announcement for MY Bride. E go be too late to think to get ready then, so be prepared for di coming announcement, you go either do am yoursef or thru MY Apostles and Prophets. Pay attention to MY warning! Hear MY warning wey dey say I am coming. Na secret marriage get away, only becos di Bridegroom know for sure. Now go out, be not ashamed and give di invitation. No dey surprise at how many go refuse am. But no feel sad, becos dem no fit or pass di question or di loyalty test, di love test, di sacrifice test or di obedience test.  So, dem dey unqualify to be called MY Bride. Some go dey way go take di invitation letter and tear am, dem go be those wey go take di invitation letter and put dem for shelf for a long time and no ever use am. And I no go call dem MINE.

MY Bride dey  wait for ME with their whole heart  and I dey come to claim MY Bride. I no dey see tribe or religion. E no matter which be your tribe or which your religion be, I dey look for relationship with ME and I dey look for one thing, which is di color red which is MY shed Blood at Calvary. So I say again MY house for Heaven go soon be your house. You will be rapture up to meet ME in di air to pull you to MY side while you dey alive. MY feet no go touch di ground of di wicked world as e be now, so get ready MY Bride to be rapture up while you dey alive. Make dem laugh and mock, I dey stand in front of di door and I go knock. All dey have to do na to open di door of their heart and repent and invite ME inside and I dey faithful and I go forgive dem of all of their sins.

Ask dem, why dem want to be tortured in hell or to burn alive for inside di Lake of Fire? Dis Lake of Fire YAHUVEH no create am for dem but for di evil ones. I pay di price for Calvary and to snatch away from di hand of satan all of mankind to be set free. But I am a gentleman. I no go break down di door. I go only just knock and wait make you invite ME in. So one more time, I go tell dem say YAHUSHUA ha MASHIACH wey others dey call me Lord Jesus Christ, is coming again. Tell MY Bride say I dey come again to take her home. Prepare to go home for MY home na your home. Prepare to come home, becos I am coming to take MY Bride home! Very soon you go hear Gabriel trumpet, and you will be rapture up to be by MY side as I go call you out as MY Bride. You go hear dis words come hither like a voice of di archangel as he blow di trumpet. Prepare to go home becos I dey come for MY Bride! One will be rapture and di other one go stay behind.

* * * * * * *

Dem write dis Prophecy on September 17, 2000 @ 6:15 pm.
Na as di Prophet take hear and speak am, nain dem take write am for here. YAH give am to dis Woman Servant Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu).

* * * * * * *