Prophecy 38
RED PLAGUE DREAM!

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

God dey speak and warn thru visions, dreams, revelations with also other ways.

For My dream as I look up I see dis dark red vapor for sky as e dey come and as e come near and as dey breaze blow e fall for people body. Dis thing wey be like RED dusty vapor come cover their skin( di color na deep red) and di people suddenly become VERY sick and dis policeman wey been dey guard me dis red dusty vapor also fall for him body and he jump into cement swimming pool wey dey outside as I just stand there. I know say di pool go don dey contaminated but he try to wash di red dusty vapor wey dey him body. Dis policeman na somebody wey I care very much for. I feel sorrow becos di water no fit remove di thing.

Di very minute wey dis RED MIST dust touch di person skin e go cover am and great sickness go follow and di skin start to suffocate. I watch my beloved policeman wey be my guard, as I dey helpless to help am. Then I see as e come from di sky. For some reason I no fear am but I can see as e dey come from far away. E start like dark smoke from far away up in di sky and then as e come near e become red for color. People try to run from dis thing but dem no fit out run am. People try to wash am commot from their body but e too late once e  don touch their skin. Dis na why satan dey try to silence my voice anyway he can. Make those wey dey laugh laugh I dey responsible for wetin I talk and no talk! Ezk. 3:17-21

Here na wetin another Prophet Gary talk as I call am ask am for discernment on dream. I know why I was protected and why di Bride of YAHUSHUA ha MASHIACH go also dey protected.

Elisabeth [Elisheva],

When I close my eyes I see dis finger of God as HE hold dis house wey dey inside bubble as if protected from di outside world and e dey safe for inside di bubble.

My mind come wander to di Passover where di blood covenant protect di people if dem stay for inside their house after dem don consecrate demsef and put di blood of di lamb on di doorposts. If dis na di case, then we do indeed need to warn di people.

Gary, we go wait on di witness WHEN to sound di shofar warning alarm.



Where Your Faith dey nain Your Passover Dey”

JUNE 8, 2000

NEW MESSAGE FROM

Rev. Elisabeth Sherrie Elijah [Elisheva Eliyahu]

Today when I ask YAHUSHUA to have HIS beautiful RUACH ha KODESH open di Bible and answer di question if He really dey come very soon maybe as soon as dis year di Bible open up to

Rev. 3:7-21. Di work we have must be done quickly for di Glory of YAHUSHUA ha MASHIACH. Nothing else go matter when we leave dis world other than wetin we do with YAHUSHUA and wetin we do for YAHUSHUA and how many souls we lead to YAHUSHUA! Wetin you don do for YAHUSHUA of late?

Rev. 3:10 Becos you don keep di word of MY patience, I also go keep you from di hour of temptation, wey go come upon all di world, to try di people wey dey dwell upon di earth.



PRAY say you no go dey here to see di RED PLAGUE DREAM become reality!

* * * * * * *