Prophecy 37

Make you Bless And Pray For Di Peace Of Jerusalem


YAH pass dis message thru Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)
October 19, 1999


Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva],make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth.Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA,your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH,your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago.Na by di SHKHINYAH GLORY Wind wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Isaiah 52:4-5 “For dis na wetin the Lord God talk, MY People for di past go into Egypt to leave there; and di Assyrian oppressed dem for no reason. Now therefore, wetin I dey see here, saith di Lord, that dem dey take MY People away for no reason? Dem dey rule over dem, dem dey make dem to shout in pain, saith di Lord; and MY name,  dey continually, every day dey blasphemed.”

* * * * * * *

I go Bless those wey Bless Jerusalem, I go curse those wey curse Jerusalem! Oh Jerusalem, Oh Jerusalem! MY beloved Daughter Jerusalem, you wey dey so small, wey dem dey envy you,  di abused nation called Israel. I send MY Woman servant to bring forth a message of Hope for you. You know di laws but now I dey use her to bring you MY Promise. I, YAHUVEH, don bless you and spare you because of YAHUSHUA, MY beloved Son. I alone chose di Savior of all mankind to be born, to minister with signs, wonders and miracles and give you MY love. Na for you HE die and HE resurrect to Glory, HE defeated the enemy of your souls come take back wetin satan don steal.

YAHUSHUA now sits down at MY right hand as your only intercessor. YAHUSHUA, MY Beloved Son Holy Blood was poured into di ground of Jerusalem so that dis world go be saved. Na Only by accepting dis pure Holy Blood covering as a Blood Covenant you go be saved. There is no other way into MY presence. Away with your feast, your sacrifices,  your fasting, your prayers wey you dey repeat and your special days wey dey set apart to glorify “I AM” if you NO dey accept MY Beloved Son, YAHUSHUA then everything wey you speak and do, you do am in Vain! I give MY gift of YAHUSHUA no be only to dis world, but first I give AM to una.

Oh beloved nation wey I call Israel. HIS Holy Blood was shed no be only for dis world but first it was shed for Israel. His Blood that was poured out dey cry out in di ground now dey say “I do dis thing for you,  you  go reject ME forever? Will you forever dey curse MY Name? When  you go see say I be your only sacrifice wey go take away di anger of MY Father once again?”

When you go see say I allow you to do dis to ME and you are not to blame?” Oh for that coming day wey you go call ME your beloved and reverence MY HOLY Name! I warn you dis; lambs or animal sacrifices no go any longer take away MY Father’s anger or MINE anger only by accepting ME, YAHUVEH’s Beloved Son. I lay down MY life by myself for Jerusalem land for you to be saved. Na Only by acknowledging say ME, YAHUSHUA, sit down for di right hand of YAHUVEH as KING of KINGS and LORD of LORDS, nain you go be saved.

Na only by calling upon MY Name YAHUSHUA ha MASHIACH during di coming Tribulation nain you go be saved. Na only by loving, obeying, and looking for ME can you be called MY Bride as I go catch you up to be by MY side. I be di only deliverer of dis world, di only redeemer, another one no dey. So I dey speak no be only to Jerusalem, but to dis world, get ready for wetin dey come you no go survive if you no call upon di Name of YAHUSHUA! To Love just MY Father YAHUVEH no dey enough! HE No sacrifice ME to only MY Jewish people, but for people of every race and language HE give HIS only Son to dis nation so that you go have a covering for your sins, Everybody have sinned and all have fallen short of YAHUVEH Glory!

Me and MY Father alone nain dey Holy and perfect. Becos of di fall of Adam and Eve no created human being dey without a need for a Savior and of MY Blood sacrifice! Jerusalem dey so blessed becos na for dis ground di only pure Holy, healing resurrecting, delivering, Blood of YAHUSHUA was poured forth on dis ground for Jerusalem. Why you think say satan hate dis land so much? Why you think say dis land dey fight for survival since it was born? Why you think say dem don fight so many war and every nation for di face of di world wan to control Israel?

Why you think say MY Father don bless Israel in many ways wey HE no bless no other nation like that? MY Blood was poured out and now e go bring out secret treasures in dis world wey you no go fit mention! Di evil ones go bite and grind their teeth as they try to control di riches wey dey for Israel. Dem go argue with demsef who go bring Israel to her knees and di riches and spoils of Israel dem go sieze am by war. But MY Father speak forth come say to di enemies you no go continue to divide and conqueror a nation and a people wey I don call, preordain as MY OWN!

You NO GO succeed in stealing from a people wey I call, preordain as MY OWN. Dem pay a price just for bearing di name of Jew and I shall protect dis nation that is called Israel in ways wey nobody don ever dream possible. I shall protect anyone wey get love for Jerusalem! Although say dem dey deny MY Son YAHUSHUA, now there is coming a time when dem go reverence di name of YAHUSHUA again. Dis na now why di evil dey try to pass laws wey go forbid di name even to be mention under di penalty of imprisonment, torture and death. Satan now dey control di government of dis nation and di nations wey dey around dis world. You are to submit to di governments only as much as they demsef take submit to YAHUVEH and YAHUSHUA. Becos di government dey upon di shoulders of YAHUSHUA, na HE alone pay di price! MY People are to obey di God wey dem dey serve and not Man. Pray make di corrupt government be defeated and di Holy ones go arise and take back wetin has been stolen.

Di land Israel has been dividing e be like MY garment, dem gamble put and sell am to di highest bidder. But I, YAHUSHUA, go give back to Israel wetin has been stolen and her enemies shall flee in seven different directions! Oh woe to you wey lift your hand to di apple of MY eye although say in dis nation di Name of YAHUSHUA dem hate am now, I shall turn dem back to their first love, and then dem go realize through their suffering say dem and YAHUSHUA na My Beloved and My Beloved na MY OWN!

Israel shall lack di water for dem lack di Living Water for that reason I go send others, to bring that Living Water and to everybody wey drink, their thirst go be quenched no be only in di spiritual but also in di physical. All those wey refuse MY Son YAHUSHUA, their tongue go hang out like a man for desert wey dey hungry for water. As YAHUSHUA take hungry for water, na so shall those wey reject His gift at Calvary go take hungry. How many go go forth like di woman at di well? How many go dey willing to offer di nation of Israel MY Living Water? Becos dem dey thirsty and no know wetin dem dey thirsty for? Dem dey call dem a Holy Land, and yet only a small few dey Holy before ME.

I go send forth dis Woman servant wey I dey prophesy thru now with di cup of MY Living Water. She go dey anointed with others wey go go before her in ways wey dis world never see yet, as she go feed di hungry and offer di living water to those wey dey thirst after righteousness. Will you be a person to help her? Will you be a person to hinder her? Each one wey dey read dis should remember if to say  no be for that tiny nation called Israel, where would your savior have been born, ministered, died and resurrect? Na for your sake and your sake alone wey Israel pay dis price. Becos satan hate Jerusalem and Israel with a hatred like no other! He go bring his anti-christ to rule and reign for Jerusalem.

Beware for all those wey no accept di only true living God go fall under di power of di evil reign to come. Those wey dey seek MY Son YAHUSHUA, go have hidden food and hidden water when they are in need. MY Children go find hidden treasure, hidden manna from Heaven when they are in need. No look unto dis corrupt world to care for you, but instead look to di God of Abraham, Isaac, and Jacob and remember how I always have a Moses wey dey go before MY People to lead dem forth out of bondage, as e be once I go do am again. Miracles wey dem never know, you wey belong to YAHUVEH and YAHUSHUA go see am!

Make you no limit ME, no doubt ME, only believe in MY Son Name, YAHUSHUA ha MASHIACH and cry out to ME and miracles and blessings I no go withhold from thee. If only you can in faith believe. I have a revelation for di so-called “Gentiles,” if you be a believer, you love, worship and accepted YAHUSHUA as Lord and Savior you don dey grafted in and YOU ARE JUST AS MUCH OF A JEW AS MY SON YAHUSHUA BE. No longer is there Jew and Gentile. No longer say dem dey call di feasts JEWISH FEASTS and Holy Days di feasts and di Sabbath na for you also!

I have a revelation for those wey be full-blooded ‘Jews’ hear ME! You reject YAHUSHUA becos you think say He be for di Gentiles but YAHUSHUA was born from a Jewish Womanservant and YAHUSHUA na a JEW! Oh Israel, MY Name na “I AM!” I don bless you. No longer curse HIM for “I AM” no be half of HIM, WE be one! Those wey dey curse, reject and deny MY Beloved Son YAHUSHUA, dey curse, reject and deny di great God “I AM”. For dis there is no forgiveness of sin, you don dig your pit in hell wey you go leave in.

Those wey dey reject MY RUACH ha KODESH dey REJECT both Father and Son becos there is no way one can be saved unless MY RUACH ha KODESH draws you into di loving confirming knowledge that YAHUSHUA alone can save and to Heaven there is no other way, no Holier Name. I dey come for MY Bride to be caught up by MY side! But you must desire for ME not out of fear but out of deep LOVE! Fear na di opposite of faith. Fear no dey honor ME, your faith that ME, YAHUSHUA, go care for those wey be MINE, dis na wetin dey honor ME. Because MY Bride has been in fear and never cry out in faith and love, dat na why  I never come yet. I go come for MY Bride with a pure heart, loyalty and motivations, not selfish pride or lack of faith that I go provide. Dis na in part why MY Bride no dey yet by MY side.
Seek ME, Learn of ME, desire ME; obey ME, more every day. Get under di shelter of MY Father’s wings like a baby chicken and you go see ME. Realize say nothing go fit happen wey MY Father never plan to happen. He go provide a way out on that evil day when e go be like say all is lost. Look up your redemption dey draw near. Look up and see ME dey come in di eastern sky. Hearken your ears and know no fear, you go hear di shofar horn of di redeemed, with your eyes MY glory you go see if only you can believe.

YAHUVEH Speak am, write am thru dis Woman Servant of YAHUVEH and YAHUSHUA under di anointing of RUACH ha KODESH 7:00 a.m. on 10/19/99
Rev. Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)


* * * * * * *