Prophecy 35
Betrayed With A Kiss

Na Apostle Elisabeth Sherrie Elijah receive dis prophecy (Elisheva Eliyahu)
for May 16, 1999

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. ( Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Dis prophecy come on May 16, 1999 immediately after di third day of my Jericho March by 7:00 am. Any wall of evil, hindering spirits, or bondage wey dey stand against dis minister and dis ministry must fall down like di wall of Jericho! Those wey dey seek my destruction and dis ministry destruction no go remain standing! I agree with all my brothers and sisters wey don receive dis word and pastor in love and wey dey do Jericho marches for di walls of evil, bondage wey dey hinder dem in anyway,  to come down like di wall of Jericho e  go fall! I believe say di DAY OF PENTECOST go be a day of great victory for all those wey don already do or wey dey do personal Jericho marches for VICTORY! Di same God wey we dey serve now na di same God wey bring down di walls of Jericho crashing down! Di same God wey no destroy Rahab for hiding di two Israelites na di same Almighty God wey call HIMSELF “I AM.” HE do am once and he go do am again! Just have di faith to believe and victory we go see!


Prophecy Begins

MY Beloved Children, “I AM” na di Lord your God. That na MY Name and MY glory and I no go give am to any other, or MY praise to idols. See di former things come to pass, and new things nain I declare before dem go happen I tell you of dem. Those with spiritual ears to hear go listen all di rest go remain deaf and dumb. Remember Samson and Delilah. MY enemies dey look for how to take your strength, wey be your faith in ME. MY enemies dey look to take your freedom, finances, and lives. MY enemies dey look to destroy your souls, handing dem over to satan as a sacrifice. Dem threaten you, intimidate you, persecute you and yet multitudes go lay down their lives becos dem no go surrender their faith.

I AM” don anoint you and put you for dis Ministry to be a helper in dis Ministry in all ways. If you believe dis words of ME then you are to share dis words wey I don give dis Prophetess. You are to cover and pray for dis Prophetess, and other Prophets and Apostles wey I speak to your spirit about. Dis Prophetic messages go help bring di sinners into di Kingdom of Heaven by ministering to dem both by edifying and rebuking. MY Children dey receive encouragement and MY enemies dey receive warning and MY prodigal sons and daughters dey return.

You are to be there to lift di hands of dis Prophetess’ when dem dey too weak for her to raise dem in di time of battle. “I AM” go continue to protect those wey help, encourage, pray, and support as I take  lead dem by MY RUACH ha KODESH maybey na even encouraging word or encouraging prophecy be all wey I go lead you to speak to dis Minister. Ask ME wetin you can do to help. Ask her wetin you can do to help. She be only just one voice. Join your voices with her own and help her to reach dis world with MY Words. You go be blessing to ME by obeying and helping to share all di messages wey I dey give her.

I AM” go set your names upon di gates of MY walls. You go continue to shine as jewels wey I put for inside di finest setting of Heaven’s best. All of MY true Prophets and Apostles need your help including dis one. Dem dey attack for different ways, some physical, some mental, some emotional, some financial, some spiritually. Dem dey attack MY Woman Servant everyday in all dis different ways. Yet “I AM”  dey hear di mighty prayers of intercession and “I AM”  dey raise MY sword of di RUACH ha KODESH and just as surely as Goliath take fall na so too di enemies wey dey mock dis messenger wey I send to deliver di prophetic messages go take fall. As Goliath was warned by David, “I AM”  dey speak dis warning dis day. Though say you dey mock, MY Word remains di same, “ No Touch MY anointed and no do to MY Prophets any thing wey go harm dem” (Psalm 105:15 and 1Chronicles 16:22.).

I AM” go judge every word wey dem speak against dis Woman Servant, and MY other Apostles and Prophets just becos dem speak forth wetin “I AM” dey speak. “I AM” go bless those wey get ears to hear and listen and go curse those wey call wetin dey Holy unholy. “I AM” know di names and hearts of those wey come and come as a friend and claim to be a blessing then dem come turn away and di mask fall and Judas nain dey under di mask. Woe be unto di Judas’ wey seek to join or seek di destruction of dis Ministry and seek to discourage di mouth of dis Prophetess wey dey speak by silencing her or grieving di RUACH ha KODESH wey dey inside her. You see only di woman, I can see di RUACH ha KODESH wey dey  for inside her and know di heart of dis Prophetess as I also know who I leed by MY RUACH ha KODESH to read dis prophetic word now. To di goats I say, “REPENT, TURN FROM YOUR WICKED WAYS” before there is no time for repentance!

To MY Babies, Bride, Chosen Ones and Elect, “I AM” say, “Blessed nain I call you and go prove say I reward those wey continuously dey seek after ME and strive to obey MY laws. Blessed are those wey strive to be Holy as “I AM” dey Holy. Blessed are those wey save their treasures for Heaven and not on Earth. Wey dey run towards di mark of di high calling. To become MY Bride na di highest calling of all.”  Dis na di greatest treasure of all. There are guests and there are Brides. Strive to become MY Bride. I no dey call everyone, MY Bride, only those  wey  dey set apart for MY glory will be called MY Bride.

MY Bride know one another, dem no know a stranger. Dis na ministry sent to minister and prepare MY Bride. Those wey dey laugh beware, for your laughing and rebuke go return unto your own ears. Who you be to say wetin “I AM” go fit do and no fit do? I send MY Prophets to warn of doom before e go come. Does not MY Word say, “If MY People which are called by MY Name, go humble demsef and pray and seek MY face and turn from their wicked ways, then I go hear from Heaven and forgive dem of their sin and go HEAL THEIR LAND.” (2 Chronicles 7:14)

Oh REPENT you wicked generation because I pardon you when I for don destroy you long ago. I show you mercy from MY wrath but na for a short time. You dey seconds away from midnight and you dey laugh and mock di coming of MY SON. You dey laugh and mock di horror wey dey come. You dey laugh and mock those wey dey prepare for that time spiritually looking for their Savior to come and take dem from di appointed time of Tribulation. You dey laugh and mock even when I give a date for disaster to come and becos of di tears, fasting and prayers and di disaster no com come, and becos of that you call di prophet false. There are many false prophets but if that prophet or apostle lead you towards salvation and Holiness and dey teach truth and not lies, how then can that prophet be false?

If a prophet or apostle dey lead you away from Heaven and toward hell then dem be for sure a false prophet. If dem dey lead you to another god or false sign, wonder, or miracle then dem be for sure a false prophet or apostle or teacher. If an apostle or prophet, or teacher dey lead you to forsake MY old Laws and Books dem be indeed a false prophet or apostle! (Psalm 1:2) You are to meditate on MY laws both day and night. Even if an angel come preaching another way to Heaven or tells you make you no listen to di old Book and only read di New Book, BEWARE becos “I AM”  na di OLD BOOK that was made FLESH in MY Son YAHUSHUA becos not just only say di  old book dem read but dem SEE! Dem see MY WORD in WORD and ACTION and now MY true children, na so too make di world see MY WORD both di NEW and OLD Testament should be seen in YOU!

Make you dey concern for your very souls for discouraging MY true Apostles and Prophets wey dey speak forth words of warning and you don hang yoursef by your own word just as surely as Judas take hang himself. wetin be di price of your soul? Don’t you yet see? MY enemies dey look to find where your strength dey. Your enemies dey look to take your strength, your desire to serve ME, to destroy you and yes even to kill you if possible. Your enemies dey look for how to confuse you and make you doubt like Peter do when I tell am to walk upon di water. Did Delilah betray Samson with a sword? NO, but with a KISS in di name of love she betray him after finding Samson source of strength. Did Judas betray MY Son with a sword? NO, but with a KISS. Na so too your enemies wey dey live within your own house and families go say, “I just want to help you” and then betray you with a KISS of DEATH to your freedom and your lives if I allow.

Di enemies of MY Gospel say dem believe and yet no get di idea of who “I AM” be. “I AM” na someone wey dem read about no be someone wey dem dey live for. “I AM” be di same yesterday, today, and forever. I no dey change for any man or woman or child. “I AM” no dey pleased as I see MY sheep dey leave with goats. “I AM” go separate di sheep from di goats. Becos those wey don stay for dis houses and don witness to di goats in hopes say dem go desire to become a sheep. Things don change for dis end times. “I AM” dey bring a sword wey go rightly divide di chaff from di wheat, di wheat from di tares. “I AM” dey sorrow and is angry when I see di tears of MY sheep and as in di days of old. “I AM” go deliver those wey dey look for deliverance and wey dey struggle against di spirits of ungodliness that don rise up against dem in bondage. Where dem never fit escape, I go lead you to di exit.

Did I not say for MY Word say your worst enemies you go find for your own house? Did I not say MY Son YAHUSHUA go divide with a sword! Read MY Word. Study MY Word. Di Sword of MY RUACH ha KODESH na di Sword of Truth and MY enemies dey look not to know di truth, but instead believe di lies wey dey sweet like finger wey dey scratch ear or eye. When MY finger of conviction come upon di ungodly ones, dem go find how to instead point that finger of conviction back in your direction and turn am instead to a finger of accusation, accusing you of bias, or say you dey mad, or stupid. Your enemies accuse you of hate crimes when ME no put any spirit of hate inside you except for satan and ungodliness.

Di sheep go find am harder than ever to dwell peacefully for house or families where di goats dey. Becos you see, does not MY Word say for dis end times that di Holy go become more Holy and di unholy go become more unholy. You be bright light shining forth. Di sins dem dey do am in darkness. Di children of darkness no want their sins to be exposed as sin. Becos those of una wey dey leave where you dey stay, that light dey on top a hill for everbody to see. Tell those wey deny ME as Lord and refuse to live for ME or live Holy before ME, that now di God wey you dey serve “I AM” and YAHUSHUA go take those wey dey filled with di truth of Heaven away from di darkness, and leave dem in darkness with their sins, and na becos of those wey be MY Children wey I call MY sheep, be di reason wey make di goats wey dey leave with dem never feel MY Anger. When di sheep are taken away di goats go feel MY Anger in full amount.

I AM” speaks forth dis warning as MY enemies hold their swords to Samson and torture and blind him, na so too “I AM” raise MY SWORD and go cut di ropes wey di ungodly take tie you with! “I AM” go use MY sword to kill MY enemies in many different ways. “I AM” go pursue MY enemies and  dem go run in fear for seven different directions. “I AM” go set di captives free wey dey cry out for ME for their Passover! “I AM” go blind di eyes and deafen di ears even more of those wey refuse to listen though say dem hear di warning again and again, dem want to remain blind na so like di evil pharaoh dem go be seven times worse till dem go become far more worse and dem for dey better off if  to say dem no hear di warning so that dem no go mock MY Apostles and Prophets wey I send. No longer will di sheep go dey satisfy to remain with di goats. Di time don come where there will be great danger to remain with di goats. Pray for a way of escape. See di walls of evil come crashing down as di walls of Jericho take do. March for your victory as Joshua take do, each for your own need.

Do not be discouraged, those wey been dey for bondage. For just like Shaul (Paul) was anointed to speak to MY People, na becos of his praise, although say he suffer, he was tested and I use am to speak forth out of his sufferings. Just as surely as I free Shaul from his prison by an angel na so too I free those wey call out to ME to be free from di goats wey dem dey leave with. “I AM” go deliver you as you speak dis word forth in faith and no allow yourself to become comfortable in di surroundings of di ungodly ones wey dey call demsef family, but no be family at all. Your true family na believers and lovers of “I AM,” YAHUSHUA and di RUACH ha KODESH. Those with a desire to live Holy and be Holy and love di whole word that was made flesh, his name na YAHUSHUA.

There is no other name wey go fit save you but di Name YAHUSHUA! No other way to come boldly before MY throne but YAHUSHUA! Make you no wear your own dirty rags, but come boldly in di garment of righteousness wey YAHUSHUA cover you with! MY Son Name na YAHUSHUA and in Isaiah 53 for di OLD BOOK I tell you in advance of his coming, I prophesy HIS coming. Just like many no believe then say a Savior go come, just as now many no believe John 3:16 for di NEW BOOK, YAHUSHUA come and save those with spiritual ears to hear and listen and those with spiritual eyes to see.

For those wey believe and say in their hearts and live their lives as if he dey come at any moment you will not be disappointed. Which groom no know his true Bride? No veil go cover your face, everything shall be revealed in that day. Di guests go weep with sadness when dem realize on that day say dem for be di Bride. Di ones wey refuse di invitation to accept YAHUSHUA go grind their teeth in pain and pay eternally with their souls. Which you go be? “I AM” who “I AM” and “I AM” already know!


YAH speak and write dis Prophecy on May 16. 1999. Under di anointing of di RUACH HA KODESH and give am to dis Child, Warrior and Bride of YAHUSHUA.

* * * * * * *