Prophecy 34
DI Walls of Jericho Go Fall Again!

Dis prophecy come thru Rev. Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu) on
May 7, 1999

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand. Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Prophecy Begin

Like for di times of old I go once again destroy like I do to di walls of Jericho. Nations and economies go tumble. E don already begin. Nations and people wey say I no go do wetin I talk go feel MY wrath in ways wey dem  never experience before. Becos dem dey take ME for joke  even for di faces of di ones wey call demsef set apart for ME and yet dem dey turn to golden idols and declare say I dey speak forth from and dey manifest from dis their golden idols. Man made and demon made idols. Di houses of worship wey been once worship ME and now although say dem dey call upon MY Name and sing songs of worship to ME and pray in MY Name, where di manifestation of gold dey appear for their mouths and for their body I no dey for there. Di souls wey dem think say dem dey lead to ME dem really dey leed to another. Dem go see wetin happen as dem offer up dis incense of prayers wey be offense to MY nose as dem dey offer up to me dis strange fire. I don warn through dis prophetic Woman Servant as I tell Elijah of Old [wey for Hebrew, na Eliyahu] to speak forth and confront di prophets of Baal so now I dey use MY ‘Elijah of New’ [wey for Hebrew, na Eliyahu] to do di same thing.

You wey dey read now make you take notice if dis thing never come to your church yet to tempt you e go come becos satan want to set apart and MARK those wey belong to him and without dem knowing say dem don already start to be MARKED! No be di MARK wey dey lead to any redemption, but na di beginning of the deceiving wey go lead to di MARK of di Beast! Di Mark of di Beast go be just as quickly accepted as dem take dey accept dis golden MARK  now. (Gold teeth fillings or gold teeth or gold dust) When di Mark of di Beast come people go think say na blessing when for truth dem don damn their very souls to eternal fire and brimstone. Becos MY Elijah of New [wey for  Hebrew, na Eliyahu] dey speak forth MY Word  and those wey only want to hear MY blessings that edify and no want to hear wetin MY curses be for those wey refuse to listen to di words wey I speak go insult her and no go gree listen.

Becos di majority of people refuse to listen and warn others I go allow satan to continue to MARK and deceive those wey belong to him by filling their mouth with gold wey come from hell, and allow dem to believe a lie becos dem refuse to study and show demsef approved. Dem refuse di truth so I dey allow dem to believe a great lie becos dem hate di messengers wey I send to dem to warn dem and dem use different type of  insult to take insult dem, speaking curses upon dem so I go allow satan to fill plenty mouth with di lust of di gold of dis world! for where di people reject truth. Dem go come to ME one day and I say to dem as dem go say “Lord, Lord” and I go say, “Depart from ME you wey be di worker of iniquity, I no ever know you!”

Flee from dis manifestation of gold wey dey happen for dis churches for many places. Dis na only di beginning of di deceptions wey dey come to those wey say dem belong to ME and yet dem no belong to ME. Leaders wey say dem be MINE and yet dem by not knowing don become filled with demons wey dey produce demonic manifestations and dem think say dem dey  follow after ME and yet dem dey follow after di god of di lust of dis world him name na satan. Those wey continue to take part for wetin I don warn against, wey continue to insult and show hatred towards those wey dey only just speak forth MY warnings go feel MY wrath in ways wey dem never dream of. Those wey once I call dem MY friend now I call dem MY enemies. Gold dust don blind their eyes. I dey warn you now before e happen, say “As you lift your hands against di prophets wey dey warn, I go lift MY hand and slap you away from MY true messengers wey I send with MY messages wey no be their own!”

Wetin  MY true Prophets go gain by speaking forth words wey di majority of people refuse to listen to? Dem certainly no go receive financial reward even from di ones wey dey call dem prophets becos how few go help dem when di time is necessary. But dis MY trusted messengers don gain di trust of their creator. Di few wey don bless dis prophet wey dey speak, I go continue to protect and wetin be MINE OWN na your own and wetin be your own be MINE OWN. I dey protect and bless everyone wey bless and pray for blessings upon di ones wey dey speak MY messages as dis prophet dey do now. I go share MY secrets with dem and warn before di enemy can strike, so dem go fit move out of di way and warn others to do di same thing. Dis false prophets and leaders dey twist Holy Scriptures out of context. READ MY WORD!

Did I not tell a man wey dey do all he can to please and obey ME and yet when he come and he say, “Wetin I go I do to be your disciple?” you no remember wetin YAHUSHUA tell am, “Sell all everything wey you have and follow ME?” I say dis becos I know say he was a very wealthy man and his eyes dey upon his wealth and although say he love ME and obey MY laws he put another God before ME and that na his wealth. Does not MY Word say di man turn and walk away becos wetin I  ask am to do him refuse to do. Dis man for becom MY disciple but  he choose di wealth of di lust of dis gold to entice am and put his wealth before di God wey him dey worship. How many of una dey do di same thing?

For those of una wey no dey do dis thing I know who dey pray, say, Father show me how I can use dis money to glorify you? How can I use all dis blessings wey you don give ME to glorify you? I know your heart and e dey please ME. You no put di  riches of dis world above your God and you wey I call MY disciples. Where your treasure dey na there your heart also dey. You cannot serve two masters. You go hate one and love di other one or love one and hate di other one. I no dey tell you make you sell everything wey you have and follow ME but instead make you offer am up to ME as a pleasing sacrifice. I go bless you for doing that. Continue to build up your treasures for Heaven and not on earth becos one go last for ever and the other one na for a short period.

Di gold wey I offer you na di gold wey be your trials wey you don go through. No be di supernatural filling of holes for your teeth. No be di sprinkling of gold dust on your body. MY Word no clearly say, “Di trials of your faith are more precious than gold?” Dem dey disregard di  old books now for where I once call MY Temples of worship. Abi dem no understand say MY laws never change also di God “I AM” never change. MY Son no come to change wetin I decree as law. MY Torah(Law) cannot change, for no man woman or child! “I AM” di same yesterday, today and forever, eternally!

All of di earth go tremble becos “I AM” don begin to stomp dis earth and na only with one of MY foot. When I stomp on dis earth with BOTH OF MY FEET e go happen in such a way, wey no nation or city or land go fit escape from di shaking! But again those wey belong to ME and dey keep MY Sabbaths Holy, wey dey worship ME in power and in truth I go save, I go hide you. Learn who “I AM” really be. I never even begin to blow on dis world yet but you go see wetin go happen when di creator of Heaven and earth and everything else wey dey  in between and around, when HE blow on dis world with di breath of “I AM” in ANGER and fierce WRATH!

Man think say dem fit control di atmosphere and dem feel di clouds with poison. Dem feel di air with poison, dem feel di water with poison, dem feel di food with poison, even your clothes carry di poison to make you sick and you no know. Even di washing soap wey you dey  use, di cosmetics, toiletries also get poisons. Even di doctors dey poison those wey dem  suppose to cure. Di doctors now dey kill wetin I give dem di wisdom to save. Satan di god of dis earth dey poisons you in all ways and you foolish ones no dey even see wetin him dey do with di leaders of dis land as dem dey poison your minds, bodies, spirits, and souls. Your church leaders dey poison your spirits as dem dey lead you astray with poisoned lies and twisting of scriptures and false signs, wonders and miracles. How few go desire to hear di truth wey can set dem free.

Now I speak words wey again you no go want to hear and yet I warn ahead of time, make you no stone MY messenger, dis no be her words. Where are MY other prophets wey dey hear MY voice and refuse to speak forth di messages wey no dey sweet di bodi of dis world? I go judge you for doing dis and for not speaking up and warning of dis manifestation wey dey become popular in di temples and churches with false signs, wonders and miracles. A worldly gathering! Only “I AM” no find am to be funny. Where are MY Prophets wey I don tell to warn dis world to stay Holy and set apart? Where are MY Apostles and Prophets and others wey  no play di game of follow di leader, wey dey warn people to no take part in dis demonic MARK  wey now dey appear for di teeth of congregations and sprinkle upon their bodies making dem to think say dem dey more Holy and privileged than those wey no receive am. FOOLS! Satan don set you up and you no know. Hitler pull out di gold come out from people mouths once before and di anti-christ go do am again. You wey believe dis thing have been deceived and get gold fever forsaking di truth for lies wey come from hell.

I now dey speak to MY Children wey recognize dis evil as evil. You are to be MY Joshuas and make you do as Joshua take do and whatever evil stands for your way to keep you in bondage march around am for six days one time. On di Seventh day march around am SEVEN times blow di Shofar horn if you get shofar then SHOUT wetin I tell you to say! You go see victory if you do dis and obey everything wey I tell you to do. Make sure your hearts dey pure and no dey hide di treasures of dis  sinful world like that of Jericho. Make sure say you dey honest and whatever don hold you for bondage, if you get di faith to believe and you dey live Holy before ME, you go see VICTORY in ways wey you never dream of.

Abi na pack of cigarettes dey hold you for bondage? Na alcohol or pornography? Is there a person wey dey hold you in bondage? Wetin e be MY child? Which wall of Jericho you want to see come crashing down? But beware, becos remember say DEATH come to Jericho. DEATH go come to MY enemies and also to di ones wey disobey. Those wey do di  marching I give dem di victory! Read MY book Joshua 6, di walls of Jericho go come crashing down as those wey have faith to believe dem go see am once again no be by di hands of a woman or man but by di hands of Almighty God, “I AM” who “I AM” there is none other one!

Now I dey speak about dis coming earthquake that is prophesied to come wey go seriously affect dis earth like never before. I now dey release dis prophet to speak wetin I tell her days ago. Wetin  I go do, stomp both of  MY feet now at di wickedness of dis world and allow di man made evil to go ahead of MY timing? Wetin I go do? I don see di fasting and hear di prayers to postpone wetin I been plan to allow. But does not MY Word say “If MY People go humble demsef and fall on their faces I go heal their land?” Not very many people dey do dis and dis dey grieve ME but wetin I go do with di few wey dey grieve over wars and dey grieve over di wickedness of  dis land? Wetin I go do? If I allow dis, then MY People wey trust say I no go do dis and e happens go think say their prayers and fasting dem do am in vain. Even satanic followers and worshippers, those wey dey bow their knee to Baal know say there is power when people fast in unity, how much more power when MY People who are called by MY Name do am. MY Holy Scriptures no say some things go only change by fasting and prayer.

Yet if I no do am and show forth MY rage, stomping on lands around dis world at one time, dem go mock and call MY Prophets false prophets! Dem go name dem as dem take name Jonah when di people of Ninevah think say he prophesy falsely. He become angry with ME. Yet I tell you say those wey prophecy of di great destruction to come on May 8 no lie to you. Yet becos of di prayers and fasting and clean hearts and tears I don delay Judgment but for a very short time! There will be stomping but no be to di degree wey I been want to do am at  dis time, you don receive some more time from MY destruction, make you use am wisely. Make you no dare to slander or mock MY Prophets wey warn you. Instead be very grateful. If  dem no warn then May for be a month like none other on di face of dis earth so far.

Now for di bad news becos I don hold back MY Judgment for a short time MY anger  dey only grow more serious becos I dey hold back MY wrath but e dey only grow very hot against di evil of dis world. Your prayers just only delay wetin must happen just like Nineveh. No dare to  mock for those wey mock MY Prophets you go see wetin happens when I go mock dem. Those wey dey mock wey no dey grateful for dis more time from MY destruction, BEWARE. No matter wetin others think of you I go judge you by di words wey you speak. You no go get di freedom from MY destruction but at an appointed time di God of Heaven go destroy you and all your household wey mock with you and everything wey you get, I go give di blessings to MY beloved wey no dare to mock but instead praise ME for dis freedom from MY destruction.

I do dis so many can see say I am a God of Mercy and love as well as wrath. I do dis so you go see di power of prayer and fasting when you combine am in di Name of YAHUSHUA e go move MY hand and delay MY coming judgments. But darlings, as di judgment is delayed na so too MY coming. When I come again great destruction go dey happen on dis earth like as e never ever happen before. No warnings go come other than wetin  di prophets speak and according to MY Holy Word wey you call scriptures.

I must also give dis warning thru MY Woman Servant now I tell her for dream April 20, 1999 and yet I no release her to speak am forth until now but to only few trusted ones. Now na di time wey I speak am forth. Make you no dare to rail against MY messenger for again wetin she get to gain by releasing a message wey itching ears no go want to hear?
I speak to her for her dream and I tell her to tell you dis; di time don come when e dey dangerous to live in di same house as di unbelievers. For husband and wife people go betray one another, children go betray di parents and so on. You wey dey for unequally yoked and yet manage to live together with both of una serving different Gods although di unbeliever may claim to believe in a God, no be di God wey you dey serve and worship and put first. Pray now for a way of escape before you are delivered up to be a sacrifice. For those wey no get no way of escape and yet don pray for a way of escape I go make a way of escape for you. I understand, only speak am for prayer and I go do wetin I never do before I go crash di wall of Jericho down for you and di unbeliever no any  longer be a hindrance to you in worshipping and serving ME. You go truly be able to say, “As for me and my house we will serve di Lord!”

Many of una I don provide a way for financially and yet you never still move when I say, ‘FLEE NOW!’ Many of una get places to go and yet choose to remain with di unbelievers. You don arrange your bed and go lie down there. I sorrow for dis reason. Many of una don beg and cry for a way of escape and never find any way. Dis na di ones I go deliver in ways wey dem no think of. Not one tears wey you don cry becos of di wickedness wey surrounds you in your house, thru di other in your house, thru your husband  or wife or children wey  I no notice. All di tears I store dem and I go wipe away your tears and bless you in ways wey you have never think to be possible. AM I NOT YOUR PASSOVER? I no say for MY Holy Words, “Wetin Lightness get to do with Darkness?” MY child there will either be darkness or Light there can not be both. Where lightness dey I go dey there, where darkness dey satan dey there. Speak up now and prove to ME which God you dey serve! As you don dey patient na so ME I don dey patient but now di time dey come close and di year dey come close to di end and if you no listen now next year you go pray you can obey ME and depart from di workers of iniquity, again for many e go be too late.

Di unbelievers go offer you up as a sacrifice and I warn you now before e happen of wetin dey come. I order MY prophet of old as MY Holy Scriptures said to command MY priests to divorce from di heathen wey dey worship other Gods did I not? Di priests get children by dis heathen women and yet I no allow dis marriages. You don see say a house wey dey divided against itself no go fit stand. As e be then, na so e go be again. Di priests no gree listen and I make MY prophet slap their faces and pull their beards. You want ME to do dis again? Only say dis time e no go be a prophet but Almighty God “I AM” wey go do dis thing and even far worse than that! Do not be in fear MY Children; those wey desire to be free and yet no know how to do am.

I know which of una dey able to do dis, and wey no dey able to do dis, I go deliver those wey no dey able but dey must speak am to ME, pray to ME and put ME first, daring to offend where dem no offend before! MY People must not fear di unbeliever, those wey go laugh, di mockers, for although dis world see you as one, I have never decree am say you be one with di unbeliever. I go deliver as I take deliver Joshua for Jericho once again. Believe with not only your mind but with your Spirit. Do a Jericho march around that thing wey you want MY hand to deliver you from. Pray and I go show you MY deliverance. AS I DO AM BEFORE I GO DO AM AGAIN!

MY Woman Servant wey dey speak forth dis word don pay di price for di anointing to speak forth dis prophetic message to set di captives free in di Name of YAHUSHUA! Only ME  know di price wey she dey pay and those wey go rise up against her, becos satan will be forced to release many people wey dey for unequally yoked marriages and households.

Fasting and prayers once again and Jericho Marches go force di walls to come tumbling down. But MY People wey do dis no go remain in di spirit of poverty for read again MY book of Joshua see how I blessed dem, as I take di wealth of di wicked and give am to di righteous. Dis wealth no be for di pleasures of dis world but for MY Kingdom to continue to support those few prophets wey I have like dis Woman Servant wey dares to speak wetin no prophet don yet dare to speak so boldly regardless of di consequences. How many of una go hide MY Prophets and disciples when di time comes?

Who go do wetin Rahab do in di book of Joshua? You no need to fear for did I not tell Joshua to save di prostitute and her family and all her dwelling and everything wey she own? Before Joshua take di city after di walls come crashing down. Jericho walls wey dem build to protect dis wicked city and yet I use MY People to shout a WAR CRY and di WALLS come crashing down to DUST! I use MY People wey hear MY voice and obey ME and no say any word as dem march first once for six days then seven times around on di SEVENTH DAY and then dem shout di victory war cry! Becos unity dey important become united and do as Joshua take do.

I command dis prophet now to pray for a day set aside when together una go shout and do a Jericho March over whatever you want removed for your life wey no dey bring ME Praise, Honor and Glory! Even those wey no get anything to remove from their life I command you to join for dis Jericho March for your Brothers and Sisters wey need deliverance! Stop being selfish in your own blessings, unless I go take dem away from you and give dem to another. You no even need to physically be together only know wetin dey needed to be removed. March around your own houses for di sake of those wey their houses dey divided by unbelievers and believers.

Pray and I go show you how to help set your brothers and sisters in YAHUSHUA FREE! E go be your fasting, prayers and Jericho march that will be used as a key wey go  turn locks that have been there so long as if di door don rust close tightly, yet in di Name of YAHUSHUA as you do dis in unity e go be opened and wetin “I AM” opens no man or devil can fit close am again if only you can believe in faith dis deliverance you go see at last. Break di lock of your captive brothers and sisters and set dem free in unity. Offer up to ME all unequally yoked households as Abraham do with Isaac and see wetin I  go do with your sacrifices. Many will be freed if only you can BELIEVE!

 Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu) nain receive dis prophecy

* * * * * * *