Prophecy 17

You Are Held Accountable For What You Know!


Given to Rev. Sherrie Elijah on March 4, 1998

I speak this forth under the anointing of the RUACH ha KODESH in the Name of YAHUSHUA ha MASHIACH.

* * * * * * *


Thus saith YAHUVEH, "You will be held responsible for wetin you know. Beware, You will be held responsible for wetin you now know. Nora Lam, repent, I love you MY Daughter but fame, fortune and pride don corrupt your once Holy mission in life. Remember befor when your name no be just to raise moni. Think back, MY Love, when dem starve you, beat you and tortured you so  you go deny YAHUSHUA. Thus saith YAHUVEH, MY Little One, remember when na only ME be your sole motivation, when you no need nothing else to live? Remember when a crust of bread was like a banquet to you? Remember, MY Little One? Now your sole motivation na to RAISE millions of dollars. Nora, come back into di loving arms of your Father. You no go fit serve two masters; you go hate one and love di other.

Beware; a word to all famous ministers, thus saith YAHUVEH, Larry Lea, wetin you dey do? Why you don offend ME like this and use MY Name to scam, you dey promise di people prayer and that you go be their prayer covering and after that you tell dem make dem, "Send money for that." Where di servant wey I once give di anointing to teach MY children to pray? Why be say na MY Name you dey use as advertisement to promote man and and not di Kingdom of Heaven?  You no dey use my name for di sake of di salvation of souls. Beware anyone wey dem  put upon pedestal by man. I, YAHUVEH, go be di one to knock you off that pedestal to prove say you no go fit do anything without MY anointing of di RUACH ha KODESH. Benny Hinn, Oh MY precious son, where have you gone? Why you dey use MY Name for your own purposes, for your own glory and you dey build buildings wey I no tell you to build.

I don tell MY true Prophets like this sister to speak all these words to you now; na one minute until Midnight. I dey come for midnight hour. Why are di shepherds leading di sheep astray? Why are di shepherds leading dem to di wolves to devour dem? Why are di shepherds  only interested in making themselves fat and not MY sheep? Why be say di shepherds dey only care about their houses and whether dem get food, whether dem get clothes and di finest things in life, and yet dem dey see di flocks in their churches and dem dey homeless, hungry, naked and poor? Why be say dis shepherds dey spend di Holy tithes to take redecorate or build millions of dollars worth of mansions and yet MY sheep dey go without shelter over their heads, no shelter for their souls. So many go go to Hell, becos di shepherds of this world dey more concerned in building their kingdoms for their glory and praise and not for di one wey pay di price so that souls could get saved. Be warned you go dey held responsible for wetin you know. Di shepherds are supposed to provide for di sheep, not one of dem should be lacking. Dis na MY lambs wey you dey ignore.

Thus saith YAHUVEH of all Creation, You don take your God, MY Son, YAHUSHUA, and bring shame to AM before all Heaven and Hell. Satan dey mock at MY Shepherds wey I leave to take care of di flocks for ME. Heaven dey grieve as di cloud of witnesses dey watch di fat shepherds dey get fatter and MY flocks dey get leaner. No body should go to a church and leave spiritually hungry, and yet na wetin dey happen. Nobody should physically dey hungry; share wetin you get with those wey no get any. Dis na MY commandment. How you go stand by and say I go pray for you but know say your sister or brother dey go hungry? You get food, you get place to sleep, MY children no supposed to be homeless. Where di shepherds wey 'I AM' called to take care of MY sheep? Make you no call yourself a pastor if you no go feed MY sheep both physically and spiritually. Stop to use di Holy tithes and offerings to make yoursef fat instead of to use am to take fatten MY sheep and baby lambs. You dey held responsible becos you have been told. Abi MY Word no say, "Make you no Lay up for yourselves silver and gold on dis earth where di thief go fit steal, moth and rust go fit spoil, but store up your treasures in Heaven."

How many of you shepherds wey I don allow to be famous, so that your name dey for di tongue of every sheep dey obey di true Gospel of YAHUSHUA ha MASHIACH? How many of una dey set di examples for MY sheep and lambs? Abi did I  really tell you to build that 7 million dollar building? No. Di spirit of pride don lead you astray, look carefully, dear lambs of MINE, MY sheep go know MY voice. Leave all dis shepherds wey dey fleece you. I no dey for their churches. I dey for di church steps warning you with voices like dis Handmaiden wey dey speak now. Run away back into di relationship wey you once had with ME. Run away from di spirit of religion. That church building, dey so beautiful and in debt, e cannot save your souls. That pastor dressed in tailor made suites can't save you. Di churches no dey dressed in MY Robes of Righteousness, but in their own fashion shows of filthy rags. remove yourself from dis spirit of pride wey their goal na only to impress one another.

Sheep wey get ears to hear and listen and eyes to see, remember, dis kind of churches no go fit answer your prayers. I no go honor your tithes when it goes for wetin  I never consecrate to be Holy. I, YAHUSHUA ha MASHIACH your Savior, dey stand for di steps dey say beware everybody wey dey enter into churches where di shepherds don make money their god and golden idols. Beware di buildings where di shepherds no dey speak MY Words but their words. Where di shepherds dey hold meetings and yet dem no go mention one word of repentance, salvation or warning of judgment or damnation. Woe unto di prophets, shepherds wey dey lead MY sheep astray with lies wey only di itching ears dey wan hear and wey dey harm di souls of MY people. You, evil shepherds, wey dey use MY Name as if na your own. You dey use di Name of JESUS (YAHUSHUA) to increase your worldly gains. You dey fear to offend people and so you dey teach unity at di expense of di lambs wey dey get sacrificed on satan's altar.

You evil shepherds and false prophets, you wey dey teach di people to resemble your own image of god and not MY Word wey no go fit lie, di image of YAHUSHUA ha MASHIACH na di Word of YAHUVEH made flesh. You, evil fat prosperous shepherds, wey dey take from di poor and give to di rich, you will be held responsible for wetin you know. No think say you go hear "Well done thou good and faithful servant enter now in and rest". All Your sacrifices will be done in vain. Truly dis worldly wealth and popularity go be your only reward. REPENT! Give back MY Holy tithes and offerings to ministries wey dey preach MY Word without compromise and without fear. Repent before di God wey you dey offend. Repent before di flocks wey you don fleece. Repent before di person wey I dey use to give dis messages becos dem go come under persecution for obeying ME. Repent, you dey held responsible for wetin you know. Listen to MY Holy Prophets  wey dey speak forth MY rage at your stubbornness, hard heads and hard hearts. Accept di rebuke and fall on your knees before YAHUSHUA ha MASHIACH and I go forgive you.

You, evil ones wey dey say we must not warn di sheep where di wolves dey becos if we do then we go offend dem, di Almighty God YAHUVEH say dis, "Di powerful shepherds go become stripped naked from their fame and worldly power. I, YAHUVEH, dey promote one and throway another. Promotion dey come from MY hand alone." Get ready becos dis year you go see those wey don preach error to MY sheep, cut off my sheep wey wool wey cover their body come leave dem naked for their own personal gain and instead dem dey feed MY sheep slop wey even pig no go want. Dis year you go see ME shake di trees of those wey dey stand for their own righteousness wey no be MINE own dem dey stand for their own power and in their own image. Dem go fall like David take kill Goliath; di Goliaths wey dey call themselves shepherds wey dem no be. I don give di authority and mandate to warn you because I no wan make you fall but na your own choice. Repent before di Kingdom of Heaven and dis world. Repent becos many souls don go Hell after dem leave your so-called church services for you have not done anything to protect di lambs.

You, evil ones, wey dey seek to silence MY Prophets make you know dis say; as one dey fall, I go raise up multitudes wey go speak louder than di one wey you lead astray, wey you chain, cover their mouth and make deaf. I go raise up Prophets wey no go gree to be  silenced like MY Daughter wey dey stand no be in her boldness, strength or righteousness and she no dey stand in her power, she know say all dis no dey come  from her but from ME, di Great God "I AM" wey dey send her to warn di wolves, your masks dey commot by force from your faces. You no be one of MY flock you don turn your back on di True Living God come dey serve another god wey no be ME. MY face no dey for your country currency, MY face no dey for your gold coins, MY face dey inside di Word of God. You dey look to know ME, then read di Bible. Get on your faces before ME and seek who di God of Salvation really be. Evil shepherds, false prophets you no go live your life rich half of your days becos di evil wey you don do for MY sight. You have been warned! I dey speak forth dis warning again, stop building for di kingdom of dis world and start to build for di Kingdom of Heaven once again.

Jesse Duplantis, hear MY voice. MY Prophet been no remember your name and yet she continue to see your face. I don put your name on her lips becos I must use her to chastise you. Repent, becos you dey build multi-million dollar buildings wey I no tell you to build. You are being deceived, your name is being used to gather in di flock's wool once again and to leave dem naked as you, Benny and Jan and Paul Crouch dey glorify wetin their hands don build. But I no tell you to steal di fleece from di flock to puff yourselves up with pride. Yes, you don do good along with bad but di evil of di worship of golden idols of dis world dey outweigh di good wey you don do. Kenneth Copeland come back. Why have you strayed so far from MY Truth and MY Will? Come back. Those wey once was called by MY Name and now you dey answer to di call of another evil shepherd and yet still dey say na MY Name. All your sacrifices wey you don do na in vain. Some go lose their souls and go be tortured for ever in di very Hell wey you preach. I go hold you responsible for not feeding MY flocks and for fleecing dem leaving dem naked, hungry, blind and deaf.

You Prophets wey dey clap for one another and wey dey join Prophets club so you can compare prophecies and see who go fit get di quickest TV popularity. I prophesy dis now, you go see a prophecy come to pass as you go know MY wrath, for speaking out words wey I no speak. Becos you never do wetin dis Handmaiden dey do now, you never warn di fat shepherds to cease from their wicked ways. You censured MY true warning of judgments becos you want to remain popular. You go dey  held responsible. If you know where evil dey you should be speaking it out.  Abi I no warn di evil prophets thru Jeremiah, Elijah, John, Jonah and the list goes on. Did I say, "Shh, no mention names, we want to stay in unity or no be ME say di evil wey dem don do for secret will be shouted from di housetops." In dis case for di internet which is di biggest housetop wey I fit find on dis earth. Those wey dey look to silence MY Messengers wey I send forth with dis warning BEWARE di ROD of MY wrath dey come upon you. Di more you dey look to silence dem, intimidate, separate dem and label dem as false prophets. You have been warned this na di year of di God you have feared. Loose di rope wey you take tie MY Prophets and set dem free to speak forth MY Words of Holy Ghost Fire. Take di cloth commmot from their mouths, take the blindfolds commot for their eyes. You dey hold conventions and call unasef alliances wey dey judge di prophecy of one another. BEWARE, anyone wey dey look to get their prophecies to be judged by a man and not by Almighty God YAHUVEH wey be di  author of true prophecies and wey need no judge of man or woman.

You Pam Clark say you get your Prophet's alliance but you no be of MY alliance. You dey charge for prayers and I never tell anyone to tell MY sheep say dem must pay for someone to pray for dem. You say your time dey valuable, how much more was MY time valuable at Calvary? Repent, fall on your knees and confess to ME and di people. Give dem back everything wey you don fleeced from MY flocks. You wey don  give tithes and love offerings to those wey lead MY sheep astray, you must demand your money back. Tell dem say you know say you don do wrong. Tell dem say you no judge them but di Word of God don judge dem. But make you no expect to get your tithes and offerings back but prove to ME say you don realize your wrong. You dey held responsible for where you sow your tithes and offerings. Pam Clark (Paz), you write book and you no dey allow MY RUACH ha KODESH (Holy Spirit) to speak forth di truth and you don chase away any Prophet wey dey truly warn you to repent. You say angel dey come to you wey dey tell you who to chase away and who not to. And Yet I tell you Heaven no send out dis angels. Hell don deceive your itching ears once again. You dey surround yourself with prophets wey go only puff up your pride more. You dey call yoursef teacher and yet you dey teach error.

Repent Pam Clark and Craig Martin, repent Andrew Strom. You go feel di wrath of Almighty GOD's ROD of wrath and I go punish you in ways wey you no know of and all di others wey dey clap for your evil works. una fit deceive di people and look so pomp and Holy and yet you no go fit deceive di one wey know una hearts. Because I love you, eventhough you don hurt ME, I go once again say to you before it is too late, BURN di books. Start over again and dis time, truly speak forth di words of MY Prophets without adding or removing anything. There is yet time for you to save yourself for wetin dey come. MY people know dis; a Prophet no be popularity contest. Beware and shun those wey dey think like that. MY true Prophets na di ones wey dem dey reject for speaking forth di truth, di harsh truth. MY true Prophets dey shake in fear at changing one word even grammar, wey dis world go normaly consider unacceptable. MY true Prophets say, "YAHUSHUA, must I speak dis becos I no want to offend anyone. I want everybody to love me and stay in unity?" and Yet unity no go fit exist between unholiness and Holiness. And Yet I say to dem, “There can be no unity between those filled with the evil spirits of satan and those filled with di RUACH ha KODESH." You have been in the midst of a Prophet as you dey read dis and MY sheep go recognize di voice wey dey come forth out of her as their only Good Shepherd. I, YAHUSHUA ha MASHIACH, don speak dis words, not to accuse but to convict di people name wey I don mention. I don warn dem before, one on one becos I don send many Prophets to speak di same words, and yet dem close their ears.

Now I don anoint and set dis site where di world go hear MY Words and no one go dey able to silence or intimidate MY Apostle and Prophetic Handmaiden Elijah becos she don suffer di persecution by di same people wey I send to her to love, protect and warn. And Yet she continues to obey Almighty God YAHUVEH and YAHUSHUA and dey do am in di anointing of di RUACH ha KODESH (Holy Spirit) and no be for reward or profit for truly she is a Prophet wey dey make no worldly profit from di words wey I tell her to speak. Her profit go be when she know say she don obey di one wey anoint and send her forth to speak to people in di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH as I dey anoint other Prophetic Warriors to go forth and speak di same. Beware, anyone wey offend her, dey offend di one wey send and anoint her. If you bless her and encourage her e be like marrow to her bones and you don bless YAHUSHUA your Savior. If you curse her you don lay upon yourselves di curses becos no be her you curse but di one wey send her.

You have been warned. Una get a mother to di Prophets for una midst, she no even understand why I dey honor her with that kind of title but one day she go know. I don choose a vessel wey no be di choice of a man but na Almighty God YAHUVEH choice for MY own reasons and no be di wisdom or revelation of dis world. I don speak all dis words from dis Prophet and she dey in di midst of you along with multitudes of other Prophets wey I dey send. Wetin you go do with MY Sons and Daughters wey dey only seek to bless you by proclaiming MY blessings or warning of MY curses na your choice. My True Prophets dey stand in di midst of una ,wetin you go do with dem? For those wey dey feel offended after reading dis then go back to your prophets wey go tell your itching ears wetin e wan hear, blind your eyes, deafen your ears and gag your mouth.

Go back and sit under di 3 monkeys and di 3 monkey curses. Many no go repent, their heart hard like stone and yet some evil shepherds go admit to their sin, go repent and realize say I dey come and na di midnight hour I go get di flocks ready without spot or wrinkle. Build for di kingdom of Heaven no be di buildings of dis earth. Even a tent will be better off and more anointed than those wey dey build all dis million dollar buildings becos you no go find MY RUACH ha KODESH. And dem no go welcome MY true Prophets and shepherds there. Sheep and lambs warn di shepherds I don mention names so that dem go repent. Only ME know who go get di  heart to hear MY voice and speak forth dis same words to their pastors who dey so busy redecorating and rebuilding and dem dey think of new ways to fleece di wool from di sheep, to leave dem naked dem even dey twist MY Holy Word to do dis for their personal benefit. Warn dem becos I dey pursue dem with MY ROD of wrath and judgment dis year, thus saith Almighty God YAHUVEH. 

* * * * * * *

Spoken forth out of dis  broken vessel of clay but Mighty Warrior for YAHUSHUA ha MASHIACH entrusted to Prophet Sherrie Elijah, 3/4/1998, 5:35 P.M.

* * * * * * *