Prophecy 130


YAHUSHUA appear to Elisheva Eliyahu as di Rose of Sharon!!!



Dem record di miracle for audio of how YAHUSHUA come to di very bed of Apostle & Prophet Elisheva Eliyahu (Elisabeth Elijah) July 5, 2016



(Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva],make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth.Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out .Na from di Mouth of YAHUSHUA,your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH,your IMMAYAH, na dis take come out.If to say na by your hand e for don fail long time ago.Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.  Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16


* * * * * *


Kathrynyah: We love you!

YAHUSHUA: Beloved daughter Elisheva. I see you. You dey try.

Elisheva: oh my gosh di scent good well well I go cry!

YAHUSHUA: you dey try to do so much at one time and you dey please me so much. I dey here! I don waka inside dis room. I sit down for your bed as you dey talk to Tatiana, and as Kim and Tatiana do wetin you don ask dem to do, and you don call Justin and you don give my words of rebuke to protect my beloved daughter, and undo di evil that was done.

So Elisheva I wan to give you my peace and I wan to tell you say I dey here, and dis na di first time wey you ever smell my scent, and na di Rose of Sharon wey dey here. I sit down for your bed di word today you hear di words wey I dey talk. So many go hate you becos of those words, and dem go raise up but no fear becos Elisheva, I don prove dis day say I dey here.

I dey here, I’m never far away. For di first time in all of dis years you dey smell my scent, and di anointing cover you, and my love and my presence. So many sacrifices wey you don make and yet I tell you dis I go only multiply di blessings on everyone no be just di leadership but all wey dey bless dis ministry.

So I go give you a new sign, wonder and a miracle and it is recorded even now with Tatiana and Kim here. When you least expect am, expect di unexpected. becos you dey waka for my signs wonders and miracles and di YAHUSHUA’s demon stompers dey about ready to go up a new level. As I send Ezra wey go take Elisheva wherever he go.

So get ready, get ready expect di unexpected from heaven, and get ready, and even di scent of di roses dey increase di anointing in you now, and I don come to tell you just calm down. I give you MY shalom I give you peace wey pass all understanding and I give you a new word. I tell you you go have to run to keep up.

I dey put in front of you a banquet table you dey for di middle and you dey smell di scent of my presence in a new way, and there is no perfume on dis earth wey go fit compare with my scent, and Tatiana I don forgive you I allowed dis to let you know say nothing don change, you pray and you wait for a sign that biological mother don change?

No my daughter, she dey look for how to snatch you away she no go fit change your stripes becos she no wan choose to. You know say your mother and your father na di ones wey dey mentor and wey love you. You know who dey lead you to heaven, no be jus my Elisheva no be jus Kathrynyah but now na Ezra also becos you dey always want di love of a father and now Tatiana very shortly he go embrace you and remember you no just get one you dey get di love of a mother and a father when you see am with your eyes, and he hug you and make you no dey ashame to cry.

Dis na added note regarding dis miracle: YAHUSHUA speak to Elisheva after dis miracle happen, come tell her to look at di picture for di front page of our website (at dis time of July 6th 2016, see di picture below also). YAHUSHUA show Elisheva how both her and Ezra dey surrounded by di Roses and both dey carry HIS scent. YAHUSHUA say when I come to you Elisheva, di same time also I dey cover Ezra with MY scent and presence and dey give am even more shalom so when you need am he get more anointing to calm you down.

Without even physically knowing wetin dey happen at di time of dis miracle Apostle Ezra say “I physically feel say something enter for my hand and I look at my arm and at my forearm and I say “goodness that na very strange feeling wey I dey feel right now, and I know say something was lay on me, and for my shoulder I feel something was lay on my soulder. You know when someone put some clothe for your body, you really feel am, and that na how e happen. I really feel wetin YAHUSHUA don lay upon me.”

Elisheva: Wow and I still dey smell di roses YAHUSHUA you come to me! Here I go make more space for YOU. I go have to get my makeup out of di way dis na like wow I dey like lie down inside a rose garden wow I wan di world to hear dis! Dis na awesome! Dis is… Oh no I turn di (my recorder) on? Yeah oh I turn am on.

Kathrynyah: Praise YAHUSHUA Thank YOU we love YOU we love YOU we love YOU!

Elisheva: I jus feel like my, my, everything, dis na na, I no even get di time to put on perfume today. You know I even dey sweat under di anointing I confess! Hey world okay! I’m so hot.

Kathrynyah: HE loves you so much.

Elisheva: I no even know wetin to say I be like I go cry I no even know whether to cry I no know whether to laugh. We dey go in like wetin five different directions today and HE say just calm down. I no know wetin to do.

Tatiana: I dey cry for you!

Kim: Amen!

Kathrynayh: Praise YAHUSHUA!

Elisheva: Praise YAHUSHUA oh yes I forget beloved YAHUSHUA thank you I’m so honored I never smell your scent and oh my gosh I have been yours since I be a young girl and I never ever ever e be like say I lie down for di most scenting rose garden YOUR clothes, e must be your clothes beloved YAHUSHUA thank YOU na YOUR presence na YOUR Anointing.

I no even know wetin to talk I dey so shocked I really no even know wetin to talk I’m jus so honored I jus dey talk to Tatiana about shopping I been dey try to, and I mean we dey do di Prophecies back to back ummmm we get we get mass deliverance coming up and we have to straighten some confusion out.

I talk to di web manager, we dey try to translate things ummm, new prophecies we dey, wetin we dey do we get so many things wey we dey try to do at one time in di middle of all of dis and YOU come and sit down by me and you say jus calm down.

Every body: dey laugh

Kathrynyah: HE say HE say dem go hate you for dis new word but he say no worry I go be with you and he say expect di unexpected!

Elisheva: And expect di unexpected! Well I surely no expect dis okay, but I dey sure honored and when Ezra hear am wow! Every single time, every every single time wey I speak with am and Kathrynyah don witness am as your faith level dey able to receive di miracles wey we dey see with their own eyes there is never never never a time wey a sign wonder and miracle wey YAHUSHUA no dey do.

I never see anything like dis and you guys go see am with una own eyes, but first YAHUSHUA’s Demon Stompers go have to come up to a new level of faith becos in dis end times di people go have to believe dem no go chase at di signs wonders and miracles becos di devil dey coming with a counterfeit and we know say na di one called di antichrist but YAHUSHUA make you chase after YAHUSHUA and di more you chase after AM and di more you embrace AM and di more you obey AM.

Those signs wonders and miracles go all of di sudden be part of your life. And today na jus proof of am I jus dey try to do something normal like go shopping but there is nothing normal for my life! And I have beloved YAHUSHUA that was right here. I think the scent dey leav though YAHUSHUA no leave me! I no want AM to leave, awwww YAHUSHUA HE no go fit stay here forever I understand YOU get other things to do.

Kathrynyah: HE say di YDS go step up.

Elisheva: Huh?

Kathrynyah: Di YDS go step up.

Tatiana: Praise YAHUSHUA!
Elisheva: Awwww I no want AM to leave! I know say YOU still dey here YAHUSHUA but HE come HE come for me in a different way. Awwww, but now di scent dey leav but thank you YAHUSHUA thank YOU! Two of una but I mean una go dey for di audio you know guys. I no know of your voices go show up.

Tatiana: I jus… I dey so honored to even hear am and you know when YAHUSHUA bring up my whole father situation like wow like I cannot believe he loves us that much and he know where e dey pain us and we no even have to talk about am.

Elisheva: Nope no you do not, and no be only that I get a husband and di world to understand am! I jus dey wait for di celebration in heaven but I have a husband wey be di highest prayer covering that you can have, okay?

And I know say why that rose garden I no know wetin him been dey do today but he certainly dey pray in a different way is all I have to say becos I could not believe am Kathrnyah I think say na you been dey spray perfume or something over there and I come say oh no e dey come from my bed!

Kathrynyah: I see light for your head!

Elisheva: See she see di light for my head when I jus see dis, see she get she get gifts to so okay I suppose we better get to practical stuff again. I have joy I never I mean look how long I have been saved and I never smelled HIM scent before like dis, and e last until I start until you know unfortunately HE can just always stay around and do that but thank YOU!

Kim: Amen!

Elisheva: I jus like dey shock, and like shock e dey so beautiful there is nothing stronger there is no rose we can compare with that scent.

Kathrynyah: na a gift for you becos I no smell am.

Tatiana: Wow!

Elisheva: It was in my bed, it was in my bed!

Kathrynyah: That is wonderful!

Elisheva: Di bed wey I keep saying so lonely no dey lonely anymore.

Kathrynyah: Amen!

Tatiana: That na wetin I want. That na di anointing oil wey I want when I get one.

Elisheva: Wetin she talk wetin she talk wetin she talk?

Kim: That na di anointing oil wey she been dey want to get di rose of Sharon and YAH jus give am to.

Elisheva: you all wow that na why I get am thank you Tatiana I no think I have ever even smell that di rose of Sharon have we?

Kathrynyah: I have some yeah.

Kim: Wow it is beautiful.

Elisheva: Well Dad go de excited, na all becos we are shopping for dad and now we have to get back to practical stuff so I go shut dis off.

Kathrynyah: We love you!

 

A sign given to Apostle & Prophet Elisheva Eliyahu,

July 5th, 2016

* * * * * * *