Prophecy 12

Daughters of Destiny, Come Forth!

Given to Rev. Sherrie Elijah

* * * * * * *

Beloved Daughters of Destiny make you no waka for your own peace, but inYAHUSHUA peace wey pass all understanding. Make you no waka for your own strength but in di strength of di God wey you dey serve. Make you no Stay for inside di boat MY Daughter but walk out on di water, with ME. Wetin you think say dey impossible, I go make a way. Wetin dey block and hinder you, I go remove. Even though di waves go look like say e go drown you, and di wind go blow hard, keep your eyes on your Savior and you no go drown. You are ordained to be a water walker no be boat sitter. 

Run towards Goliath like a David. David no run away from Goliath even though Goliath mock and threatened and even though goliath tall pass all men. David run towards Goliath. David no show any fear becos he put his own confidence not in another man or a king, but in di great I AM, and I no fail am, nor will I fail you. Fear na di opposite of Faith. Hear ME. Fear na torment wey I no send. When goliath mock and threatened David, David no reply by saying wetin him go do but instead wetin his God go do. David no expect to slay di enemy with di five smooth stones, becos di stones sef dem no even sharp. David know say his weapon no go fit  kill Goliath, only di wrath of YAHUVEH go fit kill Goliath. I put MY wrath inside those stones. I slew Goliath by a young shepherd boy, people mock am when he fest come against di enemy, dem tell am say, "He go surely die, he go fail. How can dis small pikin kill a giant?" Dis very words dem dey say am to MY Daughters now. 

Di enemy dey speak out in many ways and dem say you go fail. You go die if you go against dis enemy, you dey weak and not supposed to minister in YAHUVEH Name. But MY Daughters of Destiny I don choose you, I don ordain you, I don strengthen you. Men dey right; if you do dis work in your strength and power you go fail. You fit even die, but you go stand and no be in your might or strength and power. You stand in MY anointing on MY Word, in MY Name, wearing MY Holy Armor, washed in MY shed Blood of Calvary. MY Daughters, I call you MY Daughters of Destiny dis day. Abi am I not di beginning and di end? Di Great "I AM" is di God of Prophecy. 

Di Alpha & Omega na di God of Prophecy becos I don prophesy di beginning and I don prophesy di end. Who but "I AM" go fit do dis thing? I go reveal MY secrets to MY Daughters as well as MY Sons. MY Daughters I don choose you to do di same as David take do. Di enemy go mock and taunt, he go use others to take threaten and hurt you. Dem go slander you for MY sake. When all dis enemies come against you, no fear wetin dem go talk or do, e no go be your words wey you go speak but MY Words na him you go speak. My Beloved little ones make you no think ahead of time wetin you go do. Make you no fear when you see di look for their faces. Dem think say you are to be controlled by a man, and instead you are not controlled by a king of this earth, you are ruled by di King of Kings. David throway di  armor of dis world and instead with di armor, MY Armor God Almighty. Na so you also go do. Make you no weep when di enemy fall. I am with you and no one go fit do anything wey I no allow. I love you MY beloved Daughter. 

Be warned all those wey dey rise up against MY Daughters of Prophecy. Becos just as surely as Goliath take fall, na so everyone wey dey make MY Daughters of Prophecy grief go fall. BEWARE! Becos I dey watch, I dey listen I go judge those wey judge MY Daughters for speaking out MY Words. As men take dey protect women and I put that Spirit inside them to do like that, how much more I go protect MY Daughters of Prophecy? And it is prophesied in dis end times I go pour out MY Spirit on MY Handmaidens and dem go Prophesy. 

Whoever touch MY anointed and do dis Prophets harm, I go surely and quickly judge dem. And dem better repent before MY wrath go burn against dem. Now I no dey talk of about false prophets wey dey come in di form of a man or a woman. If dem be false then dey must be exposed so that others no go become contaminated by dem. But make you no dare touch or discourage or put your man made ideas of wetin I go do, and who I go use on MY Daughters of Prophecy.  No say YAHUVEH no go use dis women becos dem no resemble di type; dem no get our permission to speak. Who be you oh men of dis world to silence MY Daughters of Prophecy? I choose di ones wey be di most   likely di one wey nobody go chose. I use those wey go say to me, "Oh no YAHUVEH, YOU no really  want me to speak that, or to do that?" and Yet MY Daughters dey hear MY voice more clearly than MY Sons. I dey grieve for di pain MY Daughters of Prophecy go suffer for MY Name's sake. Remember say I suffer for you. As you be MY Daughter of Prophecy, you go bring so many souls to ME, and you don already. 

No be all of MY Daughters of Prophecy go get di so called license. (dis na license wey you need to be preacher or pastor or prophet), You don do more for ME than many wey  dey call themselves pastors, and dem no be pastors at all. So make you no feel sad when men no gree ordain you. I don ordain you. Dis na all wey matter. I go guard and protect and bless everything wey you go do and say. Make you no unequally yoke in anything wey you dey do. Remember if dem  no be for ME they are against ME. Your eyes go see di thing wey you no go wan see, hear wetin you no go wan hear, but e no go be your eyes, or your ears of di flesh that will feel the pain, e go be your spiritual eyes and ears. You go know blessings wey dey beyond your wildest dreams, and you go know sorrow. I go use you MY Daughters of Destiny to take nurture di young, encourage dem and teach dem. As you already don get dis instinct wey I bless you with. I go use you take rebuke, And again I don already put that Spirit inside you as a mother take dey rebuke na so you go rebuke dis heathen nation and all those wey dey led astray, and those wey dey lead MY sheep astray. 

My Daughters of Destiny you get di boldness like a mother lion take dey defend her little ones. I go use you to bind up di wounded, and which mother wey no get dis compassionate Spirit wey I don already give her? You go use di gifts of a mother, teacher, warrior, and all di gifts wey di RUACH ha KODESH don give you so abundantly. I don save di best for last. Becos men say, "You no fit use a woman." E go be di women wey go get di most powerful ministries in dis end times and di last go be be first. I go be with you. I love you MY Daughter as you read dis you go know say na for you. If you no know say na for you, then you dey right, stop reading, no be for you. For all of di others wey receive dis message I put MY arms around you, whisper in your ears and tell you, listen, dis message na for you. I don give MY Daughters of Destiny di Spirit of David. Now go out and take back wetin di devil don steal in MY Name. Na so YAHUVEH, God of hosts, take talk am.

* * * * * * *
 

Given to Pastor Sherrie Elijah Bride of YAHUSHUA

* * * * * * *


  Contact AmightyWind