Prophecy 11

Rise Up, Speak Up, Tell Di Devil To Shut Up In MY Name!

Given to Rev. Apostle Sherrie Elijah

* * * * * * *

Make you no hinder di gifts wey I don give you, many are called, few are chosen. Gideon's troops was called, but few was chosen.  ME, your Father YAHUVEH Na ME weed dem out. MY Beloved, thus saith YAHUVEH, Make you know say, I no call you to fail, but to succeed in MY Name. I no go start work wey good, wey I no go finish. Dis calling no be of you but of ME. Abi MY Word no say, "I choose di weak so MY power is revealed?" 

All go know say no be you wey dey minister but ME dey minister thru anointed clay vessels. Sherrie (Elisabeth) no go fit and no go take di credit for anything wey she dey do for ME, becos she know  say no be of her but of ME. She know now say I dey use her to speak forth to you. Di doctors wey dey practice mind manipulation go say dis na mental illness, but surrendering yoursef to di one wey  give you di mouth, emotions, and mind no be mental illness. 

But to admit say or even believe say YAHUVEH dey even speak thru person, doctors dey think say na  mental illness. Bible for no exist if to say dem succeed in convincing MY Disciples of dis. Yes, na true say counterfeit dey and all dis people dey mentally sick but MY Prophets  no be one of dem. Satan na him dey cause mental illness and those wey dey  mentally sick need deliverance. Dem for no accuse Peter wey walk on di water suicidal? Delusions of grandeur.  Di three Hebrew children, dem for no say, di Hebrew children wey dem throw inside di fiery furnace, get martyr complex and spirits of suicide? 

But di flesh dey always war with di RUACH ha KODESH (Holy Spirit) wey dey inside you. You must overcome di flesh to minister. You can succeed if you do it in MY Name. But there is always a war. After every prophecy MY Prophets have to war against their flesh as e go rise up and say who you think say you be to dey speak to YAHUVEH's people and say na HIM speak am? If dis thing no dey happen to MY Prophets and dem no admit about dis war, then no be ME dey speak forth out of dem. 

A sure sign wey you go take know say MY Spirit speak or write out of a person na if dem encounter di voice, wey dey cause dem to wonder if dis na really you YAHUVEH? Di person wey dey write you now, your sister dey fight dis battle constantly becos she feel unworthy to be used in dis way. I have to remind her as I  go take remind others by making sure say dis is shared with others, you really think say you go fit speak so beautifully, and full of anointed power? you really think say you get dis much wisdom? Always MY true Prophets go have to say, "You're right, dis cannot be me." you really think say you get dis kind of boldness? 

Then say, "Forgive me, Heavenly Father it has to be you, becos I no go fit do am, or even desire to do this kain thing like to say, thus saith YAHUVEH when I know say no be true." This na di mark of a true Prophet; dem go doubt di flesh, but dem get confidence in di RUACH ha KODESH wey dey use dem. dem know say dem no go fit do anything or even desire to do anything without di RUACH ha KODESH anointing dem to do it. Stop fearing di gifts  wey I don give you. I no go force you to feed MY sheep and you go still go to Heaven, but your rewards no go be as great and I go raise another person up to fill di place wey you supposed to fill. Souls dey, wey dey wait for you to minister to dem. 

Fear na di opposite of faith. Again I speak out di confirmation, but make you no continue to test ME, for wetin don already get confirmation. Time is short. MY coming is shortly, do wetin you go do for ME now, not later. Now na when I need MY Ministers, MY Warriors. Now na when I need those chosen to gather in di harvest of souls. Now na when I need you to be fishers of men and women. Now na when I need MY Prophets to speak forth. Now na when I need di evangelists, Spirits like John di Baptist to come forth. Now na di time of salvation, tomorrow may be too late. Many people that are called dey wait until tomorrow when di conditions are just right for dem. And Yet see tomorrow and di right conditions never still come for dem. WAKE UP, dis na di trick of di enemy. 

Another trick na to say, "I no dey worthy to preach di Gospel of YAHUSHUA, I get too many problems. I have a past wey dey bring me shame, you no go fit use me" WAKE UP, I am di one who dey choose who go serve ME, no be you. Did I not choose Paul to serve ME in a mighty way and he was a murderer of thousands of Christians. How much worse of a past could he have had? Yet I take that past and use am for MY Praise, Honor and Glory. Wetin satan meant for evil I turned around for your good. That na wetin I dey do; I no dey call people into di ministry wey never suffer. Dem no go fit identify with MY suffering children. You no go fit understand how much a wound dey pain, unless you yoursef don get wound befor. 

Who better to take care of di wounded sheep except di person wey understand  pain? You no go know how to bring someone out of sin and to di foot of Calvary's cross, if you yoursef no get something to take identify with them. A sinner saved by grace. How can you minister to di backsliders if you yoursef no at one time or another feel like say you lost your faith in ME. Your greatest weakness, I go use am to become your greatest strengths, becos I go use that weakness and help you to overcome am, and prove di reality of YAHUSHUA. When I confirm say you have been chosen make you no stand there dey question ME, "Why me?" Only know I am di great "I AM" and I no dey make mistakes. Na still your choice sha whether you want to obey. But you will be miserable and always you go know say you disobeyed MY calling on your life if you refuse. 

That na why I say, "Many are called and few are chosen." Which one you choose to be? I don already know wetin you don choose. Abi MY Word no say, "Those wey put their hand to di plow and look back,  no dey worthy?" Put your hand to di plow; leave your past at di foot of di cross of Calvary. I allowed di things wey happened to make you stronger for ME, not weaker. Becos  you have a testimony that is made of gold not brass. Use am to bring souls to ME, use am to bring ME Praise, Honor and Glory. 

I your Master YAHUSHUA ha MASHIACH dey return sooner than you think. As di evil dey get more and more in dis world, and evil people dey parade sin in MY face dem dey say, "Wetin you go do YAHUSHUA? I go show dem wetin I go. As I show MY children when I spank dem, I go punish those wey dey throw MY commandments, homosexuality, immorality, and Bible in MY face and daring to mock ME. E dey come, MY wrath dey come to dis earth raw. 

As dem dey teach di babes to sin and that MY Word no dey useful nowadays, dem go pay in a mighty way. I was only di Lamb for sacrifice once; I dey come back as a Mighty Warrior next time. But first I go gather MY children home. MY wrath dey turned to MY enemies no be MY children. MY children those wey dey love and serve ME, wey their sins are washed in di shed Blood of Calvary no get nothing to fear. 

But MY enemies no go fit imagine di kind of fear wey go come upon dem, wetin dem dey fear go come upon dem. And wetin dem no fear befor go consume dem. Since dem dey use MY Name as a curse word on di radio and Television(airwaves) and also dey joke around with everything wey dey Holy for dis airwaves, I go prove say I am Almighty God, di  great YAHUVEH "I AM" and  no be ME dem dey ridicule and insult. Na you wey dey listen to dem and no feel sorrow for hearing it, and have hardened your heart, and allowed dis thing and not speak out against it. MY Children take back di airwaves, in MY Name. You don't hear Buddha being cursed, or satan, or Mohammed but you hear di name of Jesus Christ (YAHUSHUA ha MASHIACH) being cursed. You hear di God you serve being damned. No be God Almighty that is damned; na di people wey dey speak forth all dis curses upon themselves. Only di Blood of YAHUSHUA go wash dem clean from dis sin. 

I tell you make you look to di volcanoes and earthquakes, di terrors in di sky and you go know how soon MY coming be. As I control di one thing man cannot control and can never control, di elements in di sky and di weather. Man no go fit stop di volcanoes, earthquakes, snow or cold or heat, tornadoes, hurricanes, flooding from violent rain as evil dey get more evil and good becomes more Holy. I dey separate MY people now, and MY coming dey near. Do wetin you go do for ME quickly. 

Di elderly are to be treated lovingly and with respect becos dem be elders with storehouses of plenty knowledge. Dem be MY treasures wey dey` dis earth, yet how many of dem are forgotten, locked away, treated like unwanted garbage. Their own children legally kill di sick and handicapped. Dem be financial burden "Let di poor die, do away with welfare, wetin dem good for sef?" Abi I no say, "Di poor would always be with you?" But you suppposed to share wetin you get with dem. Feed di poor; clothe di naked, your brothers and sisters. Those called by MY Name, washed in MY Blood and you pretend like say you no see dem. I see dem, I dey hear their cries, I allow dis thing to see how many really care. But for di grace of God YAHUVEH, there go you. You are your brother's keeper. When one part of di body of YAHUSHUA suffer, all suffer. Stop to ignore di pain. 

As di murders of innocent babies wey still dey for their mama bele dem dey tear dem out to pieces so badly and you dey think becos dis sinful world don legalize abortion, e dey legal with ME. Even your murderers wey dey death row, you dey try, and think of merciful and quick deaths for dem. Di laws dey give at least 10 years more in most cases at expense of taxpayers, your tax money, not to kill dem early. To invent more merciful ways to take kill merciless killers. But Yet babes wey dey so precious to ME, babes wey I don count di days till their birth, wey I put MY Spirit for inside dem, and caused dem to grow strong and healthy for their mother womb, so that dem go fit breath at di time when dey are born, and these innocent  babes wey never do any wrong, una torture dem, as their painful crying wey no other ear dey fit hear, dey sound into MY ears. 

Di people wey don do all dis abortions and never confess and asked for forgiveness and turned away from dis sin, for all eternity you go dey hear di screams of all those babies. Dis na one of your punishments wey dey wait for you in hell and you will never get a break from di cries of di murdered babies, or di screams. You know how e dey pepper bodi to hear omomo wey just dey cry? Make you Imagine millions of that in your ears for all eternity. 

REPENT NOW, nurses, doctors and women wey dey do all dis things for your own sake. REPENT NOW, politicians wey dey pass all dis laws. Supreme Court, You no dey supreme for MY eyes. You no dey above MY laws. Almighty God YAHUVEH alone na HIM be Supreme. Almighty God YAHUVEH alone na HIM be judge, jury and executioner. YAHUSHUA ha MASHIACH come before so that you go fit have life and life more abundantly. REPENT! Turn away from dis sin becos I go hold you accountable. Di blood of di unborn dey for your hands. 

Why, na because I don give mankind choice? A choice to obey wetin dem dey call  instinct given to every woman and man, to protect di young, nurture di young and instead dis young are savagely murdered. Woe unto di ones wey call dis legal. Woe be unto di doctors and nurses wey take part in dis murder. Woe be unto di politicians wey pass di laws of these innocent babies wey dem don slaughter. Woe be unto you wey stay silent for far too long. I dey hear their screams. Di babies' souls dey return to where dem come from Heaven. But dem tear their souls out of dis world without mercy. Wickedness wey words no fit explain. I allow di souls to be alive just to prove how human being take wicked to each other. Even though say I Know di choice wey that mother don already make. As I dey Grieve I also dey give her every chance to repent. Even though I know say she no go repent, I dey  angry because she no go repent. 

Tell dem, tell dem MY Daughter. Once again although even those wey call demsef by MY Name and yet dem dey do nothing but shake their heads and others I am so proud to call MY children becos dem dey lay down their lives, reputations, and finances down to protect di innocent babes in their mothers' wombs. These na di ones wey I go reward. Why be say all di churches no dey support those people wey dey willing to sacrifice their all to protest against these murders of innocent babies? 

Dem lose their jobs, dey imprisoned dem, mocked dem, and why? Because dem hear MY voice, and MY conviction wey say, "Speak up, no stay silent." I don hear their prayers, I don see their tears, and I don feel their pain, how about you? Every church service supposed to dey pray for dem. Every church service supposed to dey pray for MY conviction, MY judgment on those wey dey do dis things, wey dey allow all dis murders, yet how very few dey do dis. I dey GRIEVIOUSLY ANGRY becos you say you be MINE and you dey ignore di cries of di unborn, and di cries of those wey don sacrifice their all to protect and stop di slaughter of di unborn. Rise up! Speak up! In MY Name! Pray, Pray, Pray till you see dis’ horror cease. 

You wan know why I have allowed dis to go on, because I don dey wait for MY children to call upon MY Name to stop dis thing. To prove say dem care. Not just a few people, but millions supposed to already speak out as dem pass all dis laws against MY laws. There should never be a church service without dis prayer going out. Pastors you will be held accountable. You have been warned. Congregations warn your pastors. Dem supposed to dey represent ME. Remind dem in every service to pray for dis horror to cease, and for MY judgment to come upon those wey refuse to repent. Stop giving ME lukewarm prayers. I no go listen. Give ME prayers with passion and with a heart that cares. Stop di ritual prayers wey just be memorizing words, I no go hear. Dis na from your mind and mouth, not your heart. 

Great sinkholes go open up and di earth go swallow all dis abortion clinics. No be anything wey human being do but na MY hand go punch di earth. Di place wey contain di most blood for ground, innocent blood. Not even in war innocent blood dey shed like dis. But upon di altars of satan all dis children dem slaughter for their comfort sake, for vanity, for selfishness, for fear and for greed. I go give dem something to fear, dem go fear di Almighty God YAHUVEH wey create dis souls wey dem so wickedly murder. Dem go fear YAHUVEH wey dem dey use take play and say na legal thing. Dem go fear di ones wey put di Christians in their faces to warn dem say dis na murder. THIS IS SIN! Becos e no go be anything else di Christians go do to make dem to fear, other than just prayer and move di hand of YAHUVEH thru those prayers. 

But di women, doctors, nurses, politicians, those wey dey applaud di murders of MY innocent souls go see MY face and MY Spirit upon MY children sent out as troops to pray. Remember di walls of Jericho. Remember how no be human hands  bring down di walls of Jericho. Na So e go take happen again and dem no go dey able to build di abortion clinics fast enough. Tell dem MY Child and teach dem. 

There is still time to repent, but soon there will be no more. Remember Sodom and Gomorrah no be human hands bring di fire and brimstone, e rain from Heaven where e dey stored up and e go come again. Evil ones, those wey dey  practice dis thing and so much worse, you have been warned. Your laws go fit legalize homosexual marriages but I decreed say na sin. It is a mockery of marriage and wetin I create to be Holy. E no dey legalized for MY eyes. Pastors, some of una don join in all dis love feasts of strange flesh by not saying anything, you don partake in dis. Rise up! Speak up! Tell di heathen to shut up in MY Name! Make you no listen to their lies anymore. They are out after di children, your own children, you have been warned. 

You must repent now or you also go suffer wetin dey come and e dey come very quickly. You have been warned. So you dey worry about your tax exempt status but no dey worry about wetin di God wey you dey claim to serve go do to you, for not praying against dis and for not moving MY hand to end dis. Again there should never be a church service wey go end without prayer going out to end dis spirit that has been sent forth to contaminate all wey dey Holy. Di prayers of a righteous man avail much. Lukewarm prayers I no dey hear and I hate. Either be hot or cold but not come to ME lukewarm I go vomit you commoth for MY mouth. 

Make you no  say you are MINE and no dey stand up for wetin dey Holy or dey remain silent as you see other people dey stand up for Holiness and dey get persecuted for MY sake, and you no help dem  by anyway you can, becos you dey fear to lose your tax exempt status. You go lose more than your tax-exempt status. You go lose more than your lives. You go lose your SOULS! You have been warned. Di time na now! Rise up! Speak up! Tell di heathen to shut up in YAHUSHUA's Name! One with YAHUSHUA on their side na majority. A million without YAHUSHUA on their side na minority. Di time na now. 

* * * * * * *
 

A broken vessel of clay, but Mighty Warrior of YAHUSHUA MESSIAH!

Pastor Sherrie Elijah 

From now on I am commanded to write di time in. I no know di reason. Also as I dey write dis prophecy, I lost connection with Internet, I tried to reconnect only to find say all di phone lines was attacked in some way, e don reach 2 hrs. Now and e still never send.  Di time na 3:37 PM and I no fit even reach di operator. 

For hours now e dey say, "Dis line is busy." Dis kind thing never happen before. I cover dis computer, and e-mail with prophetic message with di shed Blood of YAHUSHUA ha MASHIACH of Calvary. By faith, I believe all those wey di RUACH ha KODESH wants to get dis message go get am. E no gree connect all night so that e go send dis prophecy tonight. I no fit even reach operator, or to dial long distance. Something don happen in the heavenlies as I dey write dis. Only local calls dey go through. 

Dis na di first time I ever was told to start to dey include di time, you go see something happen wey go correspond to dis date or time. I no know wetin. I dey ask say for wherever dis prophecy dey posted, or sent, send di complete page. 

Becos there Is a reason, and again I know say na YAHUVEH  dey command me to say, don't change or take one word out, leave am in di complete state as I dey send am. Devil must be mad. After all dis dey  send across di airwaves and di Bible say satan na di prince he get power over di airwaves with his principalities. But I cover di airwaves where dis message go take travel and di computers with di shed blood of YAHUSHUA, and our telephone services and Internet services. Di blood of YAHUSHUA of Calvary, and Nazareth is against you satan. 

And demons, you cannot cross di  Blood. In di name of YAHUSHUA. Phone lines dey work now at 11:15 PM. Now e go fit send. Those wey get ears of di RUACH ha KODESH go hear di voice of Our Almighty God YAHUVEH, all di others go remain deaf. In di name of YAHUSHUA ha MASHIACH, RUACH ha KODESH send out your messages to all those wey go recognize our Master's and Creator's voice. 

Only for your Praise, Honor, and Glory YAHUSHUA I ask. Amen. 

* * * * * * *


  Contact AmightyWind