Prophecy 1

Judgement starts at the House of YAHUVEH!

Given to Rev. Sherrie Elijah
December 31, 1996.

YAHUVEH say make this the begin every prophecies from now on:E don tey wey I tell you Elisabeth make you no call this ministry by a man or a woman name even before this ministry start. I put am in your spirit because nothing wey dey here come from your hand, nothing come from your personal mouth. Na di mouth of YAHUVEH bring this one. Na di mouth of YAHUSHUA your MASHIACH(MESSIAH\SAVIOUR) wey bring this one. Na di mouth of di RUACH ha KODESH,(HOLY SPIRIT) also bring this one. If to say na by your own power e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH Glory’s wind wey dey blow across this earth, di Holy wind of revival, no be by your own power or self o, e for don fail tey tey.(Isaiah 42:8)).

For July 2010 YAHUVEH also talk say make dem add this scriptures from 2nd chronicles before every prophecy:

2 Chron. 36:16, "But they mocked the Messengers of YAH, despised HIS Words, and scoffed at HIS Prophets, until the wrath of the LORD arose against HIS People, till there was no remedy." )

* * * * * * *


Na fearful and terrible thing to fall into the hands of a living GOD. MY anger can be great as MY love, but nobody go tell you dis. In the year of 1997, I go show MYSELF as no be only GOD of Love, but for di people wey no dey fear ME and deny MY power, or refuse MY love, and dey deceive MY sheep…they go taste di days of Ananias and Sapphira once again. Wisdom na fear of YAHUVEH! Many of MY own sheep no dey take ME serious. Dem dey do things anyhow, dem think say grace go cover dem. Dem dey do things wey dem know say no dey holy and dey continue to offend ME.

But dem think say I dey  blind and deaf. Di year of 1997, I go prove say I am a GOD of fire and di people wey try to prevent MY ministers will be consumed in MY anger. Di people wey dare to prevent di gospel of YAHUSHUA ha MASHIACH (JESUS CHRIST) go suffer di worst. I am coming for a church wey their garment no get stain or squeeze  and again I dey tell you to warn di church. Di church no be di pastor, no be di building. Di church na di people, MY sheep. I don tire and enuf is enuf for all dis men wey dey name ministries by their own name; dey no get di right to do dis abomination.  Dem no pay di ultimate price, dem no dey holy enuf to do dis. I YAHUSHUA ha MASHIACH, na ME pay dis price at Calvary. 

Except dem dey sinless and perfect, dem no get di right to dey name ministries after demselves. Na ME alone be di perfect and sinless ONE no be any man, (Bible say)“ For everybody have sinned and come fall short of di Glory of YAHUVEH!” You dey sinless for MY eyes because of MY Blood wey don wash your sins away. You no dey sinless because you be perfect person. You be sinner saved by MY Grace and mercy. Di Blood of Calvary washes your sins away, true, but a ministry suppose represents ME and your FATHER YAHUVEH and di ministry must be named for holiness, not be by a man’s name.

Again, I prophesy through you and say, “Beware.” Warn dem, because when di imperfect man fall (and he go fall), when dis ministry wey carry his name fall di sheep go scatter into di enemy camp. Tell dem for ME, MY woman-servant, warn dem. Make dem no do dis abomination for MY eyes anymore. Because I say “Be Holy as I am Holy.” Even di top prophets and ministers wey get MY anointing dey for dis foolish pride and dem dey name wetin no be their own…di anointed ministries with their own names. Because of dis thing dey go fall but I go pick dem up after I don punish dem. 

Make you warn dem,  e be like pikin wey you dey flog, after you don warn am many times. I dey punish the children wey I love. I am a Lamb to di people wey accept MY Blood gift wey I give dem at Calvary. I am a Lion from di tribe of Judah to MY enemies. I be warrior I no soft. I turned the other cheek before. (I let dem slap ME) But when I come again I dey come with great anger for MY enemies. Woe (trouble) unto di people wey dey call demselves MY enemies and dare to destroy di good works wey I de do thru MY servants. Lion go first tear to pieces before he eat di meat wey he catch. Also with di eagle, wey represent your Heavenly Father. You go see MY great anger for dis 1997.

But MY Children no get nothing to fear, di ones wey truly love ME, dey worship ME dey put ME first for their life. I go clean house inside temples. I go prove say I be GOD wey people need to fear no be small. I still be GOD wey dey demand holiness from MY Children. I no dey talk about wetinyou look like for di outside; dat one mean nothing to ME na man-made holiness be dat. True holiness dey come from inside. Something dey come and it don already start and na civil war in America.

But there better no be a civil war in MY churches. They better no concern their selves with wetin no matter like how the look on the outside or their race (whether na black or white people). When MY Children dey look each other, make dem better say na only RED dem dey see, MY Blood. Stop to divide your churches because of colors. (black people church or white people church). I no dey see color. I be all color in one. Stop judging yourself  by how una look like on di outside. Because where dis spirit of prejudice (hate and dislike) day, MY RUACH ha KODESH (HOLY SPIRIT) no go stay. Instead, evil spirits will be allowed in there. I don warn una.

Sherrie, (Elisabeth) you no know wetin you go type from one word to di next. Give dis prophecy to everybody wey get ears to hear, make di rest remain deaf. I dey come for di church wey their garment no get stain and squeeze. Wetin dey hold ME back na di very thing wey suppose to dey bring ME back, Na MY church, MY people, MY Pastors, MY ministers. I hate pride. Na one of di deadly sins, and yet MY own pastors wey carry MY anointing think say na dem build di church, dem think say di church na their own so therefore dem they control MY sheep. Na ME alone be di only Good shepherd. And you suppose be di finger to point di way to ME, YAHUSHUA.

Pride, great pride, don creep enter the churches wey I pour MY anointing put. Di thing wey dem dey concern demselves with na Who get di biggest church members, di most money? Dis thing dey make ME sick. Who dey win di most souls? Jealousy and greed dey inside MY own churches. Dis thing the make ME sick. You dey ask say “When YAHUSHUA go come again?” I talk say, “I don dey wait for di church, di temples, to clean up demselves.” Stop di fighting among yourselves. Expose di wolves wey dey eat MY sheep all dis time. Dem dey behind di pulpit(dey claim pastor). Everyone of dem their concern na for their church building, no one care about the sheep. (the church people).

Who fit build di biggest church? Who go become more popular for TV? Who be number one evangelist, prophet, pastor, church? I dey talk to you thru dis prophet, listen to her. Judgment go start for YAHUVEH’S House! (wey be di churches) After dat I go deal with the sinners. All dis thing dey make ME sick. I dey desire to hold all of una in MY arms and instead una dey fight and insult one another becos of gender(woman pastors VS man pastors). I choose to use who I choose to use. Di most humble person I go use in a Mighty way.

I choose to use dis vessel becos of how she put herself as di weakest of di most, and I repeat once again, I will use di humble and meek, (di one wey quite and gentle) di people wey nobody go respect becos MY power dey show best in weak people. Di rest know say no be their power so dem no dey boast. Becos dem know say na only MY anointing dey break every yoke, fetter, chain, shackle and bondage. Nor be by your ability or your power, na by MY Spirit. Thus saith YAHUSHUA, “I choose to become a baby, di weakest of all to prove say make una no dey focus on di outward appearance look inside! Di anointing no get respect for whether  na man or woman, black or white person.”

Di RUACH ha KODESH (HOLY SPIRIT) dey use people wey dey ready, obedient vessels of clay, no be people wey dey shout “Use me becos I fine, I am more holy than di rest of dem.” I no go use di people wey think say dem be gold; I dey use people wey see demselves as broken vessels of clay but mighty warriors of YAHUSHUA ha MASHIACH. In 1997, I go launch out those wey their ministries still remain humble all this time or wey no too popular like di rest. Di ones wey I not only call but di ones wey I choose, I choose dem becos of their faith wey I be di author and finisher of (beginning and ending). I no dey start something and then fail. I be your GOD wey no go fit fail.

Get ready, for 1997 I dey tell you say di riches of di wicked go transfer into di hands of di righteous thru MY Name and MY Blood, YAHUSHUA ha MASHIACH Name. Na MY sheep go get di wealth and di jobs. Di enemy’s children go see dis thing happen and grind their teeth together in anger and jealousy, but I go do dis to prove say MY scriptures no be lies. Deuteronomy28 blessings still dey for MY Children and I know dem by their name and by di hairs wey dey their head.

Get ready becos for MY Children, dis na di greatest outpouring of MY RUACH ha KODESH (HOLY SPIRIT) yet. I go use those wey think say they no popular,  beautiful, no know book well, those wey say dem no fit do anything without MY anointing of di RUACH ha KODESH (HOLY SPIRIT). Di ones wey people don throway, use dem, no dey listen to, tell dem to give up, say dem dey waste their time. 

Di ones wey no get money go look up to Almighty GOD and I go open di windows of heaven and bless dem so much dat even dem self go by force bless other people , so den too go dey blessed more more . This thing go be like chain reaction ( e go happen from one person to another non stop). MY Word say, “Beloved, I wish above all things dat you may prosper and be in good health even as thy soul prospers.” 

I am going to prove say MY Word no go fit return to ME empty. Be careful who una dey look as nobody. Becos na di pastor wey no get plenty people for church, but continue to give di RUACH ha KODESH full control no matter how many church members leave to other churches, churches wey dem dey leave go no get signs, no wonders, no miracles, even di conviction of di RUACH ha KODESH no even dey there.

Be careful when you dey reject di evangelists wey for your eyes nobody know am, and dey use their own money to spread di gospel and dey win souls. Be careful of how you dey laugh ,how you dey insult and ignore di prophet wey come to you with a prophecy and you no want believe di prophecy becos dem be di wrong gender (becos na woman no be man) or becos dem be nobody and no popular. Be careful say you no offend di young ones wey I dey raise up to prophesy and yes, to even warn elders to listen to di voice of Almighty GOD.

Get out of pride. Becos dis people na di very ones wey I dey send. When you offend dem you offend di GOD wey send dem. Dem be only MY messengers so make you no stone di messenger. Na di ones wey people no know I go raise up; di nobodies I go work MY signs, wonders and miracles thru, and a mouth piece for YAHUVEH. ( dem be MY microphone). Dem no be a nobody. Na only in di eyes of di proud people dem be nobody. Dem be somebody to ME for I can and go use dem mightily for MY praise, honor, and glory. And dem no go steal am from ME like others don try to do.

No be you build  dis successful ministries. Na by di power and di anointing of di RUACH ha KODESH e become a success. Stop taking MY Glory. No be you be di healer or deliverer na di Almighty YAHUVEH alone dey deliver. Di message to di church of 1997 na to get humble before YAHUVEH. Dis message na for di prophets, evangelist and pastors. Una no get any power without MY anointing. I am a jealous GOD. Commot man name from MY ministries. You have been warned! Give di praise, recognition to di only one wey get di right to name a ministry after himself, and na your Master and Savior, di one wey you dey claim to serve and worship. I share MY glory with no man.

E get one false teaching wey dey go around in dis end times and even for some of MY churches where MY anointing was poured out. Na spirit of pride and religion dey spread dis lies wey dey make pastors now adays dey say “Na we be di only one with di authority to say who fit pray and who not fit pray. So you are forbidden to pray for one another without our permission.” Not even YAHUVEH Almighty, Creator of Heaven and earth go say dat kain thing.

MY word simply says, “Pray you one for another.” I no be respecter of persons. So wetin go make ME allow dat kain thing. Pursue all dis false shepherds out of MY House. Tell dem say you know di Word of YAHUVEH. Stop to believe and spread all dis lies. Yes, people dey wey go curse you instead of bless you, but di curse go only return to di head of di person wey dey do di cursing wey dem dey call prayer. Di occultic spirit wey dey look for MY sheep to destroy dem go backfire back to di sender.

Di RUACH ha KODESH is very able to protect di people wey dem dey pray for. Stop trying to do wetin you no supposed to ever do. Dis na di RUACH ha KODESH job. Dis na di Good Shepherd job and I alone be di Good Shepherd; I am able to take care of everyone dat is MINE.

Commot di wood wey dey your eyes before you dey judge whether someone dey worthy to pray for another person. Judgment go start for di House of YAHUVEH. I go clean house in a mighty way in 1997, before I judge di sinners. Sin na still sin. Unholiness still dey unholy. I no be GOD wey dey change with your times. I am di same yesterday, today and forever.

Becos pastors refuse to get di boldness to stand up and tell people say make dem repent and YAHUVEH’s Word say dis wey dem dey do na sin. Dem dey fear say dem go loss their tax-exempt status, (church wey government no dey tax) and becos of dat dem allow government to silence dem for di sake of fear. Now dem go get someone to fear, and na ME, YAHUSHUA. Becos you remain silent, and you no want speak out to say people make una repent or else na Hell’s fire go consume una. Di one thing wey una wey be pastor and ministers dey fear na him go catch una all of a sudden. Una no go any longer have di tax-exempt status. I go allow di government to take am away so dat once again una go speak out without fear wetin sin be. And your sign wey you go take know say dis prophecy na from ME you go see am come to pass. Promotion comes from no other place but from di north which is Heaven.

Na ME go promote one person and na ME go still demote another one. Many people go come down for 1997 wey dey use di gifts of di RUACH ha KODESH to make money. It was never your own to sell.

Many wey enter ministry becos dey think say na di quickest way to make money, and some of di top ministries are now very greedy. Either they repent or fall. Una go see dis thing come to pass. Ministers wey dey commit secret sin like years before will be exposed and put to shame for all di world to see. Di spirit wey dey inside a spiritual leader na di same spirit wey dey di members of di church. I must make an open show and rebuke those wey dey preach di Word of YAHUVEH and yet dem no get fear for ME, dem think say dey fit cover MY eyes with their good works. No be by good works you go take enter Heaven, so nobody go fit boast. To whom much is given much will be required.

Pastors, Evangelists, Prophets, Ministers, MY Children…you will be hold responsible for wetin you know. Some know more than others, but then I go hold dem even more responsible becos dem know better than to offend ME. In 1997 make you search yourself and forsake your sinful lifestyles and di spirit of pride and rebellion. Becos I be GOD wey know everything, dey see everything and hear everything. Those wey dey call demselves MY sheep and ministers will be hold responsible for wetin dem know say be holiness and instead dey practice unholiness.

Those Pastors wey just dey pretend to love and care for di sheep, but really dem no care anymore, will be brought down. And if dem become pastors becos of greed na poverty dem go know. Judgment go first start for YAHUVEH House in 1997 and in a mighty way, if you wey dey righteous is almost not saved how much more those wey be sinners need to fear. Test di spirit wey dey speak and you go see say na di voice of di RUACH ha KODESH dey speak thru dis Prophetess to rebuke, to bless, and edify di saints of YAHUVEH. And to sound di trumpet blast of doom for all di enemies of di gospel of YAHUSHUA ha MASHIACH.

Touch not MY anointed, and make you not do MY Prophets any harm. Make you not stone MY messenger for giving MY Message. Becos harm go come to anyone wey speak against MY Messenger. Test ME and see if I not be GOD of consuming fire. Di fire of Hell na MY anger wey dey burn so. Make you let am burn against you.

Copy dis prophecy give everybody wey get ear to listen. Make di rest remain deaf. Just becos say dem no believe no mean say I no go do wetin I speak, e go come to pass. Ezekiel 3:17-21 make you warn dem and if dey no listen, di blood no go dey for your hand. If you no warn dem and pass on dis prophecy, dem go die for their sin but their blood go dey your hands. I go send MY prophets to warn people first before di destruction go come.  I send MY Prophets to tell people say blessing dey come before di blessing go come. 

Given to Rev. Sherrie

www.allmightywind.com
www.almightywind.com

Contact AmightyWind